Moson0821's Posts
Nairaland Forum › Moson0821's Profile › Moson0821's Posts
1 (of 1 pages)
Good day all I dey read una comment and I like it. Thank you all. I just enter uk recently and since my school still dey online. I dey reason Job o. Becos na wetin carry me come. Sold my ppty and car to be here. All the jobs wey my friends dey tell is that na only care Job for international student sure. Pls is there no job that can pay better than care job? And also I intend to buy a car for UK since I see that car is cheap. So that I can be using it to hustle. Please help a brother and discourage me why I need to buy a car at this time becos sometimes I no dey hear word. But importantly please which job dey wey I fit do. And also how una dey use survive with 20hrs per week job. Becos right now my body dey hot if I see job even sleep go be enemy of progress. I no come look uche face. Please all comment is allowed. CC @justwise @TheGuyFromHR And other seniors in the house. |
1 (of 1 pages)