Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,194,464 members, 7,954,817 topics. Date: Saturday, 21 September 2024 at 10:03 AM

Myners007's Posts

Nairaland Forum / Myners007's Profile / Myners007's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (of 63 pages)

Crime / How My Mother Forced Me To Do Money Rituals.(confession Of A Warri Boy) by myners007: 4:26pm On Mar 12, 2022
Tejiri na small boy for area wey all of us grow up together for Igbudu No 1. The boy quiet nor be small. I know how many times fegor our neighbors last born dey oppress am collect him koto even though Tejiri senior am. Even when we dey go Olodi primary school, the boy nor get anybody time. Tejiri lanky that year and he dey always enjoy keeping anytime we dey play football.
When I enter essi college, na College of commerce (UCC) he attend. I surprise later say them make am president for scripture union (S.U) as soon as him enter S.S.1. Every Evening, na so Tejiri go gada us dey preach for us. The boy just dey live at peace with everybody. Mainwhile Tejiri na senior pikin and the papa run leave them since when Dem dey small because na steady fight him papa and him mama dey get almost every day.
When Tejiri finish school and return back from university, the boy find work tire and he nor see. Base of say na person wey study computer engineering, na so he start to dey hustle for Airtel office. He dey help customer register sim and also dey do one or two for there dey meet up. Just because say the money never too many, he still dey follow him mama dey stay.
Everything be dey ok, until Aforke that year come from Ghana enter with doings. Aforke with him gang enter street dey throw money. infact area scatter. Both people mama and papa dey rush money. Drink na sawalele. Enjoyment na Alaka dat day. Area nor fit sleep because Dj Black won kill people with music.
You know say na from that day Tejiri problem start? Mama Tejiri wey pick 10k that night nor allow Tejiri sleep that night.
"nor be your younger brother mate dey scatter area so? you just go school come back say na 2 naira sim card you won dey register for people. Na this work you won take rent your house and even marry? When I dey feel say by now you go dey support me, na now you come dey press me again. na you eat pass for the house and one naira, you nor dey see bring come. clothes you nor get and you dey carry pastor work for head. See I nor won tell you two times, just as from today, go near Aforke, make you join am do wetin he dey do. If not this house nor go contain me and you.
Tejiri cry that nite nor be small. The boy just wish make the ground swallow am. How he won take dey go follow him junior up and down just because he won make money wey he nor know the origin. Nobody need to tell am say na Yahoo money the boy bring come area so.
Tejiri mama nor let the boy drink water drop cup. Some times he go lock am for outside say make he nor enter house until him get sense. And the mama dey carry fight go meet anybody wey give Tejiri food or allow am sleep for their house. The boy beg him mama tire, but she nor gree.
Tejiri look up and down and no choice. Na so he go meet Aforke and beg am to carry am along. Aforke laugh Tejiri but tell am say make he nor worry say he go carry am go Ghana month end.
Na so Tejiri carry him bag month end without telling him mama and follow Aforke travel
Na 9 months later, Tejiri drive enter area one nite with him GLK. If you see am, you go know say the boy skin full. Tejiri don puff up and the chain wey dey him neck na better tiko. Money nor change him quietness but the earing and him small tattoo for him hand just give am a different look.
Tejiri mama won dance die. Nor be small happiness say Tejiri don come house as man. The next day Nie Tejiri move him mama and family go one 3 bedroom apartment for okuokoko because he don make arrangement for ground before he enter the warri.
Mainwhile he nor reach one month, the boy don start him house project for Jeddo that side. Everything just dey go smooth.
Tejiri House opening na death row. The area people know say person dey the area with them. All the G boys for town full the community. Drinks, food and any enjoyment you know dey cry that day. Na so Tejiri mama dey smile all through. That day if Dem nor spray her money, he reach 500k. At last suffer don end for the family.
Na so everything dey go fine for them. Tejiri dey come area once once just to dey come relax base on old time. The boy nor forget area one day.
Na so him happen one day like that. Tejiri mama commot from house one day before her children come back from market because since she turn mother of a big man, na the children dey help am dey her store.
He reach the next day, Dem nor see am and na there the children raise alarm call Tejiri because her phone nor dey go and he never happen like that before. Na so Tejiri call him friends say him mama dey lost. Within few minutes, the social media don cast. Every body don dey pray make God protect am. How full woman go commot without telling anybody. Tejiri Face just dey full with tears anytime visitors come check on am on the lastest update. For one full week, no better news. People just conclude say she fit don die or get accident somewhere wey people nor know.
Na so we break ourselves into groups dey go from hospital to hospital, even Mortuary round warri, Effurun, agbarho and even Ughelli but no result. Tejiri dey always provide money for the movement.
He get one afternoon like that when we dey the compound, when we see about two police Hilux drive enter the compound. We even feel say na Tejiri nie decide to involve the police to handle the case.
This one wey we dey talk so, Dem don surround the compound. As Dem enter, them ask who be Tejiri and he stand up. The officer say Dem come search the house base on information wey Dem get. We just feel say na normal police matter wey Dem dey come raid boys collect money as usual.
Everything wey Tejiri do to bribe them with money, Dem nor gree. Dem say Dem won still search the house. Na so Dem select two persons to join them while the rest go stay outside the compound and nobody go leave.
Na so all of us go out with only Aforke, jude and Kevwe join them Dem. He nor reach 30 minutes wey we hear heavy shout from inside the house. Wetin happen na.
Before we Look Tejiri carry One calabash come outside and the next thing we see inside na him mama head and money inside her mouth.
I remember say the sight of that thing alone make Mine wey stand near me faint once. So Tejiri don use him mama for ritual.
My heart cold once. Whick kind wickedness be this? Na so police carry am commot to go show Dem them her body.
As news enter town, nor be small shi shi shi. That S.U president kill him mama. We nor go fit forget. Mainwhile police decide to parade am as suspect to confess wetin really happen and why him do am. That day he nor get the tv station wey nor go. Police station full jam.
As Dem bring am come out from ceil, na God nie save am say enough police dey ground, if not Dem for barbeque am there. Na the DPO nie first talk. he say Dem act on a tip off by one of Dem Tejiri neighbors wey dey stay the other compound. she say she see Tejiri mama enter the compound for afternoon but nor know when she commot. But she notice say for like 1 hour after Tejiri mama enter the compound, He start to Dey play loud music and na wetin the boy never do one since he pack come.
When he reach Tejiri turn to talk, na so so cry he dey cry. He tell everybody how he dey manage to keep himself decent until him mama start to dey give am trouble. How him mama go pour am water for nite as he dey sleep unless he go join Aforke hustle. He say na with shame and humiliation he take enter street. He beg him mama to give am time to do legit work but him mama greed for money force am to choose this way of wife.
He say when the native doctor ask am who him like use for ritual to sustain him money, he nor think twice to choose the woman wey force am Into this evil way. As the Police carry am to enter ceil back, Tejiri Cry out, Area nor be like me. Nor let anybody force you do wetin you nor won do. Remember say na your life and never jealous another man wealth because you nor know weda na you or your pikin he go use take sustain that money tomorrow. Many of my friends dey the town and Gh and na wetin Dem dey do. Some dey sleep with old women to sacrifice 5 years commot from their their time on earth in exchange of wealth. Some nor dey sleep for nite if not Dem nor go wake up, some nor dey eat onions or Dem go run am.
so you wey get one naira with rest of mind, you nor know wetin God dey do for you. Tejiri last word na, Make Una Forgive me because NA MY MAMA FORCE ME DO RITUAL.
THE END.
WRITTEN BY TIVE OKPAKO (MC OLOKPA)
kindly reshare to every parent out there. Let's be patient with our children because their actions can either make or break us. Thanks for Reading
COPIED!!!!

10 Likes 1 Share

Autos / Re: Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 2:14pm On Mar 12, 2022
good buy
Autos / Re: Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 6:50pm On Mar 11, 2022
2.7m last price.
Autos / Re: Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 6:18am On Mar 11, 2022
Still available for sale.v
Autos / Re: Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 10:29am On Mar 10, 2022
Call me 08064447361 still available
Autos / Re: Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 7:26pm On Mar 09, 2022
Still Available with the price slightly negotiable
Autos / Clean 2012 Ford Edge For Sale @ 2.85m by myners007: 6:52pm On Mar 09, 2022
For Sale: Black Ford Edge
Category: Grade A
Condition: Clean, Engine working well, perfect transmission system with good sony sound system
Year: 2012
Price: #2.85M
Location: Warri, Delta State

Call: 08064447361

Phones / Re: Itel Releases A58 Series Into Nigerian Market by myners007: 12:35pm On Feb 02, 2022
OK, wHATS THE LEAST PRIC E BECAUSE I HAVE SAVED 30K

4 Likes 1 Share

Celebrities / Re: Richard Mofe-Damijo Celebrates Wife, Jumobi On 21st Anniversary by myners007: 2:07pm On Dec 29, 2021
Can Somebody explain how did Mee his first wife died mysteriously?

3 Likes 1 Share

Celebrities / Re: Babatunde Omidina Baba Suwe's Burial Photos And Video by myners007: 2:05pm On Nov 25, 2021
I can't find Pa Aluwe or Jagua at the funeral. Are they not colleagues in the same industry

1 Like

Celebrities / Re: Peter Okoye And His Brother, Jude Follow Each Other On Instagram by myners007: 7:20pm On Nov 15, 2021
I am happy for the family reunion as well as for the good music we anticipate will follow soon unlike noisy sound we listen these days (Chelsea Rants)

6 Likes

Crime / How My Mother Forced Me To Do Money Rituals.(Confession Of A Warri Boy) by myners007: 4:30pm On Nov 15, 2021
Tejiri na small boy for area wey all of us grow up together for Igbudu No 1. The boy quiet nor be small. I know how many times fegor our neighbors last born dey oppress am collect him koto even though Tejiri senior am. Even when we dey go Olodi primary school, the boy nor get anybody time. Tejiri lanky that year and he dey always enjoy keeping anytime we dey play football.
When I enter essi college, na College of commerce (UCC) he attend. I surprise later say them make am president for scripture union (S.U) as soon as him enter S.S.1. Every Evening, na so Tejiri go gada us dey preach for us. The boy just dey live at peace with everybody. Mainwhile Tejiri na senior pikin and the papa run leave them since when Dem dey small because na steady fight him papa and him mama dey get almost every day.
When Tejiri finish school and return back from university, the boy find work tire and he nor see. Base of say na person wey study computer engineering, na so he start to dey hustle for Airtel office. He dey help customer register sim and also dey do one or two for there dey meet up. Just because say the money never too many, he still dey follow him mama dey stay.
Everything be dey ok, until Aforke that year come from Ghana enter with doings. Aforke with him gang enter street dey throw money. infact area scatter. Both people mama and papa dey rush money. Drink na sawalele. Enjoyment na Alaka dat day. Area nor fit sleep because Dj Black won kill people with music.
You know say na from that day Tejiri problem start? Mama Tejiri wey pick 10k that night nor allow Tejiri sleep that night.
"nor be your younger brother mate dey scatter area so? you just go school come back say na 2 naira sim card you won dey register for people. Na this work you won take rent your house and even marry? When I dey feel say by now you go dey support me, na now you come dey press me again. na you eat pass for the house and one naira, you nor dey see bring come. clothes you nor get and you dey carry pastor work for head. See I nor won tell you two times, just as from today, go near Aforke, make you join am do wetin he dey do. If not this house nor go contain me and you.
Tejiri cry that nite nor be small. The boy just wish make the ground swallow am. How he won take dey go follow him junior up and down just because he won make money wey he nor know the origin. Nobody need to tell am say na Yahoo money the boy bring come area so.
Tejiri mama nor let the boy drink water drop cup. Some times he go lock am for outside say make he nor enter house until him get sense. And the mama dey carry fight go meet anybody wey give Tejiri food or allow am sleep for their house. The boy beg him mama tire, but she nor gree.
Tejiri look up and down and no choice. Na so he go meet Aforke and beg am to carry am along. Aforke laugh Tejiri but tell am say make he nor worry say he go carry am go Ghana month end.
Na so Tejiri carry him bag month end without telling him mama and follow Aforke travel
Na 9 months later, Tejiri drive enter area one nite with him GLK. If you see am, you go know say the boy skin full. Tejiri don puff up and the chain wey dey him neck na better tiko. Money nor change him quietness but the earing and him small tattoo for him hand just give am a different look.
Tejiri mama won dance die. Nor be small happiness say Tejiri don come house as man. The next day Nie Tejiri move him mama and family go one 3 bedroom apartment for okuokoko because he don make arrangement for ground before he enter the warri.
Mainwhile he nor reach one month, the boy don start him house project for Jeddo that side. Everything just dey go smooth.
Tejiri House opening na death row. The area people know say person dey the area with them. All the G boys for town full the community. Drinks, food and any enjoyment you know dey cry that day. Na so Tejiri mama dey smile all through. That day if Dem nor spray her money, he reach 500k. At last suffer don end for the family.
Na so everything dey go fine for them. Tejiri dey come area once once just to dey come relax base on old time. The boy nor forget area one day.
Na so him happen one day like that. Tejiri mama commot from house one day before her children come back from market because since she turn mother of a big man, na the children dey help am dey her store.
He reach the next day, Dem nor see am and na there the children raise alarm call Tejiri because her phone nor dey go and he never happen like that before. Na so Tejiri call him friends say him mama dey lost. Within few minutes, the social media don cast. Every body don dey pray make God protect am. How full woman go commot without telling anybody. Tejiri Face just dey full with tears anytime visitors come check on am on the lastest update. For one full week, no better news. People just conclude say she fit don die or get accident somewhere wey people nor know.
Na so we break ourselves into groups dey go from hospital to hospital, even Mortuary round warri, Effurun, agbarho and even Ughelli but no result. Tejiri dey always provide money for the movement.
He get one afternoon like that when we dey the compound, when we see about two police Hilux drive enter the compound. We even feel say na Tejiri nie decide to involve the police to handle the case.
This one wey we dey talk so, Dem don surround the compound. As Dem enter, them ask who be Tejiri and he stand up. The officer say Dem come search the house base on information wey Dem get. We just feel say na normal police matter wey Dem dey come raid boys collect money as usual.
Everything wey Tejiri do to bribe them with money, Dem nor gree. Dem say Dem won still search the house. Na so Dem select two persons to join them while the rest go stay outside the compound and nobody go leave.
Na so all of us go out with only Aforke, jude and Kevwe join them Dem. He nor reach 30 minutes wey we hear heavy shout from inside the house. Wetin happen na.
Before we Look Tejiri carry One calabash come outside and the next thing we see inside na him mama head and money inside her mouth.
I remember say the sight of that thing alone make Mine wey stand near me faint once. So Tejiri don use him mama for ritual.
My heart cold once. Whick kind wickedness be this? Na so police carry am commot to go show Dem them her body.
As news enter town, nor be small shi shi shi. That S.U president kill him mama. We nor go fit forget. Mainwhile police decide to parade am as suspect to confess wetin really happen and why him do am. That day he nor get the tv station wey nor go. Police station full jam.
As Dem bring am come out from ceil, na God nie save am say enough police dey ground, if not Dem for barbeque am there. Na the DPO nie first talk. he say Dem act on a tip off by one of Dem Tejiri neighbors wey dey stay the other compound. she say she see Tejiri mama enter the compound for afternoon but nor know when she commot. But she notice say for like 1 hour after Tejiri mama enter the compound, He start to Dey play loud music and na wetin the boy never do one since he pack come.
When he reach Tejiri turn to talk, na so so cry he dey cry. He tell everybody how he dey manage to keep himself decent until him mama start to dey give am trouble. How him mama go pour am water for nite as he dey sleep unless he go join Aforke hustle. He say na with shame and humiliation he take enter street. He beg him mama to give am time to do legit work but him mama greed for money force am to choose this way of wife.
He say when the native doctor ask am who him like use for ritual to sustain him money, he nor think twice to choose the woman wey force am Into this evil way. As the Police carry am to enter ceil back, Tejiri Cry out, Area nor be like me. Nor let anybody force you do wetin you nor won do. Remember say na your life and never jealous another man wealth because you nor know weda na you or your pikin he go use take sustain that money tomorrow. Many of my friends dey the town and Gh and na wetin Dem dey do. Some dey sleep with old women to sacrifice 5 years commot from their their time on earth in exchange of wealth. Some nor dey sleep for nite if not Dem nor go wake up, some nor dey eat onions or Dem go run am.
so you wey get one naira with rest of mind, you nor know wetin God dey do for you. Tejiri last word na, Make Una Forgive me because NA MY MAMA FORCE ME DO RITUAL.
THE END.
WRITTEN BY TIVE OKPAKO (MC OLOKPA)
kindly reshare to every parent out there. Let's be patient with our children because their actions can either make or break us. Thanks for Reading
COPIED!!!!

6 Likes 1 Share

Nairaland / General / My Mother Forced Me To Do Ritual.( True Confession) by myners007: 2:50pm On Nov 14, 2021

2 Likes

Music/Radio / Re: Wizkid's Essence Now No. 11 On The Billboard Hot 100 Chart by myners007: 3:27pm On Oct 05, 2021
slawormiir:
Damnnn niggar
Wizkid my niggar.....that is why he is always in my playlist along with burna boy and tuface....
What about Davido?
Crime / Fraud Alert: Access Capital Investment Platform by myners007: 5:14pm On Jun 19, 2021
please I am using the this medium to expose the scam being carried out by a group of fraudsters under the aegis of access capital investment platform headed by one Mr Patrick. Here's the details of the account used to defraud people. Sado Ayuba Christopher . Access bank number 1399378893, They promised payment of 100percent return on any amount invested. This is the number of Mr Patrick 07043907535. The public should beware and relevant authorities should go after them. Mod please move to fp.
Sports / Re: Diego Maradona Dead by myners007: 5:31pm On Nov 25, 2020
Rip the world Greatest

3 Likes

European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Re: Tottenhan Hotspur Vs Manchester United (1 - 1) On 19th June 2020 by myners007: 3:27pm On Jun 19, 2020
A sure win for Man utd.

9 Likes

Car Talk / Re: Maintenance Tips On Cars. by myners007: 3:36pm On Apr 17, 2020
KINGreignn:

There are many grades of Mobil oils, a lot aren't even suitable for your cars so I wouldn't know the grade used. That said, Toyota recommends a 5000miles/7,500 km or 6months oil change interval.
That said, I'd advice you continue to use the exact grade of oil used previously in servicing them.
Thanks
Car Talk / Re: Maintenance Tips On Cars. by myners007: 2:59pm On Apr 17, 2020
KINGreignn:

What type of oil was used in servicing them?
Were the vehicles parked or still actively being used till now?
Mobil oil and they are still been used actively
Car Talk / Re: Maintenance Tips On Cars. by myners007: 2:24pm On Apr 17, 2020
[quote author=KINGreignn post=88541955]

Your location matters,
Service history of the vehicles matters,
The current state of the vehicles matters also.

[Thanks.
Location Warri and both vehicles were service last in June 2019.
Car Talk / Re: Maintenance Tips On Cars. by myners007: 1:45pm On Apr 17, 2020
Good Day Please,
I need help on a service routine program for of my company cars, corrolla 06 and Hiace Bus respectively. Both vehicles were bought in 2015.... I need service period either in time or usaege(mileage) and which oil is also recomended.

Thanks
European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Re: Manchester United Vs Club Brugge :Europa League (5 - 0) On 27th Feb 2020 by myners007: 5:42pm On Feb 27, 2020
Ighalo to score 2 scores in today's match

1 Like

European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Re: Burnley Vs Manchester United (0 - 2) On 28th December 2019 by myners007: 10:49pm On Dec 28, 2019
0-2 op change the scoreline pls

4 Likes

Autos / Re: Awoof 2007 Red Toyota Camry Sports For 1m- 07034485442 by myners007: 9:54am On Dec 22, 2019
900k
serious buyer
Autos / Re: Very Sharp First Body 2007 Toyota Camry LE Naija Used @N1.250m(SOLD) by myners007: 2:31am On Dec 22, 2019
1m
Autos / Re: Distress Sale!! Clean Registered 2007 Model Toyota Rav4, Limited Edition, Abuja by myners007: 6:20pm On Dec 21, 2019
Gentleguyz:
Hmmmm
1.1
Car Talk / Re: The Official Car Comparison/Recommendation Thread by myners007: 9:04pm On Dec 20, 2019
good evening guys, please between Lexus 300 and Camry 07/08 spider Nigerian used, which car should I go for
Romance / Re: Konji!! Bbnaija Star, Venita Akpofure, Flaunts Her Banging Breast & Backside by myners007: 2:10pm On Dec 12, 2019
Cardi B
Autos / Re: Ad Renewed by myners007: 9:44pm On Dec 10, 2019
95o serious buyer
Autos / Re: 2002 Lexus RX300 by myners007: 1:16pm On Dec 10, 2019
[quote author=FiiahnAuto post=84787765]

For this particular car 1.1

Another one available for 1m
Even a friend has one for 900[/quoYour no so that i can chat u up later in the evening
Autos / Re: 2002 Lexus RX300 by myners007: 9:23am On Dec 10, 2019
FiiahnAuto:

Thanks sir but u need come up well if u want this car
i THINK MY OFFER IS FAIR AND THATS THE BUDGET

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (of 63 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 76
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.