How Do You Save Money? I Really Want To Know - Business - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Business › How Do You Save Money? I Really Want To Know (326 Views)
| How Do You Save Money? I Really Want To Know by Templee333(op): 8:06pm On Aug 10, 2022 |
Do people still have saving account in this country? How? See bros,when person hustle finish him family & relatives dem dey carry all their problem come put 4 him head. Even beggars dey come find dat ur hustle money.419 people wan scam u collect d same money.E-neva finish 4 dia-o,nepa bill & land lord dey wait u 4 house.Even 4 ur hustle self,people wey get bad mind go owe u credit dem no wan pay,every pesin dey find how dem go take make ur market fall.Again,after u don hustle finish some girl wey no get work go come tell u make u buy mtn card 4 them.small time malaria don knock ur door, go pay hospital bill naw.Last last,tithe & offering plus other church levi dey wait u 4 weekend. No 4get say dorlar dey rise everyday-o,u dey even see money wey u go carry chop 2 times 4 one day? But on top all dis, them still talk say make u get saving account! Abeg NLders,tell me how una dey take see money to save. |
| Re: How Do You Save Money? I Really Want To Know by Flora2Sweet: 8:58pm On Aug 10, 2022 |
Its been difficult man |
| Re: How Do You Save Money? I Really Want To Know by Templee333(op): 6:12am On Aug 11, 2022 |
Flora2Sweet:i thought it was only here |
| Re: How Do You Save Money? I Really Want To Know by Templee333(op): 8:53pm On Aug 28, 2022 |
. |
| Re: How Do You Save Money? I Really Want To Know by Ezlynn: 9:55pm On Aug 28, 2022 |
It's not been easy especially with the naira devaluation, aside my main hustle I make extra income on the side trading crypto on yellowcard at the best rates with zero fee. |
| Re: How Do You Save Money? I Really Want To Know by Templee333(op): 10:23pm On Aug 28, 2022 |
Ezlynn:What exactly is this crypto,hw does it work? |
Man Has Refused To Return Money I Mistakenly Sent To Him -Bashir Ahmad Cries Out • How Do I Retrieve Money I Borrowed My Crush? • The Money I Saved In My Saving Box • 2 • 3 • 4
Top Reasons Why You Should Get Window Tinting For Your Automotive • Top 10 Business Ideas In Nigeria You Can Start With 100,000 Naira • PHCN On Strike ?