₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,405 members, 8,421,764 topics. Date: Sunday, 07 June 2026 at 12:31 AM

Toggle theme

This Life Don Finally Tire Me Oo - Nairaland General - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralThis Life Don Finally Tire Me Oo (284 Views)

1 Reply (Go Down)

This Life Don Finally Tire Me Oo by 95Jay(op): 4:41pm On Jan 11, 2025
Only me with all these addictions, and no be say I dey make big money oo, the one wey dey enter my hand, if Betting no collect am, Alcohol go collect am, if Alcohol no collect am, Loud go collect am, if Loud no collect am, Olosho go collect am, if Olosho no collect am, Vape Juice go collect am, If Vape Juice no collect am, Na clubbin I go submit to last last... sad When did I get to this level?

To go work sef don tire me because at the end of the month shishi no go gum my body, and loan app go still dey my back..

If I get liver, I for don commit since...

I no seek motivation or prayer oagain ooo

Just suggest a risky biz that can either make my addiction affordable or take my L on the process!!

Thanks...
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 4:42pm On Jan 11, 2025
95Jay:
Only me with all these addictions, no be say I dey make big money oo, the one wey dey enter my hand,
if Betting no collect am, Alcohol go collect am, if Alcohol no collect am, Loud go collect am, if Loud no collect am, Olosho go collect am, if Olosho no collect am, Vape Juice go collect am... sad When did I get to this level?

To go work sef don tire me because at the end of the month shishi no go gum my body, and loan app go still dey my back..

If I get liver, I for don commit since...

I no seek motivation, prayer or advice again ooo

Just suggest a risky biz that can either make my addiction affordable or take my L on the process!!

Thanks...
Where and how much is the vape juul
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by 95Jay(op): 4:48pm On Jan 11, 2025
tobby20:
Where and how much is the vape juul
12k it's rechargeable, 3 in 1..
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 4:56pm On Jan 11, 2025
95Jay:
12k it's rechargeable, 3 in 1..
Mango flavour is what I need
Ajehh
Just that I've stopped smoking
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by 95Jay(op): 4:57pm On Jan 11, 2025
tobby20:
Mango flavour is what I need
Ajehh
how long have you been vaping ?
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 4:59pm On Jan 11, 2025
95Jay:
how long have you been vaping ?
Never vaped
Just regular loud and cig.(bohem)
.like 5 years but it's all in d past
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by 95Jay(op): 5:05pm On Jan 11, 2025
tobby20:
Never vaped
Just regular loud and cig.(bohem)
.like 5 years but it's all in d past
Normally, e dey cheaper than Cig and Loud,
because when I start new, 1 juice dey last a month, but now, 3 no dey pass 2 weeks, even if I try to be stingy...
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 5:16pm On Jan 11, 2025
95Jay:
Normally, e dey cheaper than Cig and Loud,
because when I start new, 1 juice dey last a month, but now, 3 no dey pass 2 weeks, even if I try to be stingy...
Na so everything b o
Even loud I no fit finish one stick b4
Now na like 3 stick I need to sleep in peace if no thinking go finish my life
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 5:17pm On Jan 11, 2025
95Jay:
Normally, e dey cheaper than Cig and Loud,
because when I start new, 1 juice dey last a month, but now, 3 no dey pass 2 weeks, even if I try to be stingy...
But that vape juul no look like e dey high
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by 95Jay(op): 5:20pm On Jan 11, 2025
tobby20:
But that vape juul no look like e dey high
e no dey high, na just to relax mind... except na weed vape, but that one dey cost pass!
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by tobby20: 5:43pm On Jan 11, 2025
95Jay:
e no dey high, na just to relax mind... except na weed vape, but that one dey cost pass!
omor I no fot waste 12k for wetin no dey high o
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by Mushkan: 6:03am On Jan 14, 2025
Use Nicotine Pouches these are good alternative of vape and helping quitting smoking.
Re: This Life Don Finally Tire Me Oo by Thomthom(m): 3:54pm On Jan 18, 2025
Nawaoo Vape juice Nawaoo una too spoil
1 Reply

What Is The Essence Of This Life?This Life No Balance!See, This Life No Balance O.234

Alaafin Stool: Oyo Mesi Members Were Present When I Consulted Ifa —prof Wande AbIs Bybit Legal In India? My Bybit Referral Code: 56612Experience Koinonia Live With Apostle Joshua Selman