₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,064 members, 8,448,485 topics. Date: Monday, 20 July 2026 at 12:05 PM

Toggle theme

If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here - Business (6217) - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralBusinessIf You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here (7077956 Views)

1 2 3 ... 6214 6215 6216 6217 6218 6219 6220 ... 6307 Reply (Go Down)

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Echika01: 7:50pm On Mar 15
THE TIME IS NOW

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kumuyiii(m): 8:08pm On Mar 15
Eazilyfe:
80% of riders are women, you cant avoid them. Dem too like soft life grin

Jst pray not to meet the ones that will ruin your day. My biggest tips so far are from women, the soft heart ones. The same bad ratings i get na from women too. huh
bro eh, that's the hard part, the make majority of the trips... Men wey dey order them like food, all EVERY SINGLE bad rating wey i don get na them... Imagine 3 days ago.... Coastal road BLOCK, as in complete block... I wasted 3 hrs stand still, everybody begin do uturn... see wetin this f00l write, i con later ask, shey if na bolt you book, you go yarn me this rubbish..? Abi no be you go use ur hand abort mission, so becus na indrive, you no really send, and as ur slave, make i dey stand still becus queen Elizabeth wey you be, you dey go work.... To show you say na rat brain these creatures dey take waka, i actually told her I no care about the money(16k), make she just find her way, still!! These creatures are insufferable... Na why dem selves no dey like work with each other, terrible people... Today again, i don carry one reach street wey she dey go, these people begin feel entitled, like I'm supposed to wait for you to get the accurate house number... I carry dem reach first number 8, the second number 8 was 5 steps away, no wahala, i reverse carry them go there... She do money, i say, 'have a nice day'... She still sit down dey wait make person come carry them, i come tell am oya oh, fuel is 1300 abeg, the female dog tell me, what if i never send money you go hurry me... Na so she come down, the werey rate 1 star... Tag me rude... Omo i off... Na him i decide show her rudeness, according to her reply, dis clown actually know wetin she do, she did it intentionally... But i serve am hot food wey she no go quick forget... She f00lish girls know wetin dem dey do oh. Moving forward, I'm sure she'll think carefully b4 moving werey

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kumuyiii(m): 8:16pm On Mar 15
Echika01:
Good day Comrades!!! The mega drivers shutdown down is starting tomorrow in Lagos and OGun state and it is for 3 days!!!! The low fares is too much so let's fight this fight once and for all!!!!! If you're not yet on our drivers forum telegram or WhatsApp please indicate!!!!!THE FIGHT IS NOW COMRADES
Lol this protest won't work UNFORTUNATELY... If everybody where to go offline, which is not possible, it'll create surge, many will be tempted to go online, and most will, cus in the end, money(surge) will entice many and focus will be lost, back to square one. The nature of the business won't allow for such protest to be effective, the only person that can actually do anything is government.... Unless drivers, every single one goes offline and stays offline for as long as necessary... Now the question is, how many of you csn stay offline for 1 week? 2weeks? 3weeks? Cus this one na who the pressure breaks first, similar to what is happening between usa and iran now, iran is mounting economic pressure, yankee is mounting military pressure, who caves first.? Na who get more to lose will eventually cave, we have many hungry drivers(particularly those driving for people), wey bills still choke their side, you think they'll strike for ordinary 3 days? Sorry to be the bearer of bad news, eno go really work my bros. Find alternative hustle and pray the war ends soon, make this useless governmnt bring fuel down.... We have crude, we have refinery, yet we bear the blunt of war happening million miles away... All oil producing countries subsidises fuel for their citizens, eno go beta for this rulers and their supporters.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kumuyiii(m): 8:20pm On Mar 15
Echika01:
THE TIME IS NOW
Lol all the company needs to do is wait 3 days, una go resume 😂🤝 let's accept the unfortunate situation, our government is a failure, hence why everything else must inevitably fail.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by capetownboyz(m): 8:32pm On Mar 15
Kumuyiii:
bro eh, that's the hard part, the make majority of the trips... Men wey dey order them like food, all EVERY SINGLE bad rating wey i don get na them... Imagine 3 days ago.... Coastal road BLOCK, as in complete block... I wasted 3 hrs stand still, everybody begin do uturn... see wetin this f00l write, i con later ask, shey if na bolt you book, you go yarn me this rubbish..? Abi no be you go use ur hand abort mission, so becus na indrive, you no really send, and as ur slave, make i dey stand still becus queen Elizabeth wey you be, you dey go work.... To show you say na rat brain these creatures dey take waka, i actually told her I no care about the money(16k), make she just find her way, still!! These creatures are insufferable... Na why dem selves no dey like work with each other, terrible people... Today again, i don carry one reach street wey she dey go, these people begin feel entitled, like I'm supposed to wait for you to get the accurate house number... I carry dem reach first number 8, the second number 8 was 5 steps away, no wahala, i reverse carry them go there... She do money, i say, 'have a nice day'... She still sit down dey wait make person come carry them, i come tell am oya oh, fuel is 1300 abeg, the female dog tell me, what if i never send money you go hurry me... Na so she come down, the werey rate 1 star... Tag me rude... Omo i off... Na him i decide show her rudeness, according to her reply, dis clown actually know wetin she do, she did it intentionally... But i serve am hot food wey she no go quick forget... She f00lish girls know wetin dem dey do oh. Moving forward, I'm sure she'll think carefully b4 moving werey
This conversation lol .. mehn today was hectic got trapped inside Lagos airport ,vehicle decided to go dead(refuse to start after topping fuel ) due to running out of fuel which I was unaware of due to bad a fuel gauge reader that I have been managing..coughed 15k ,mech plus car park trying to solve this issue..well today wasn’t it at all ..never been this stressed lol ..This job don test me in so may ways I never imagined ..Soft bobo like me 😑 need to tap out of this current reality until then,I’m humble and looking forward to a better life .
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 8:40pm On Mar 15
U
Glithronix:
I'm not against the strike, but I hope it won't later result in government intervention.
And when government comes in, y'all know what next.
Nigeria government fit even get hand in all these things wey those apps they dey do in order for them to wade in.

BTW, I neva believe say there's going to be any protest/strike action until it happens sha.

Much respect, baba.
Yes u r right but strike is still d only way. Let's every driver on this naira land platform heed d Clarion call.

Make we all join hand ensure this strike works by not switching on app tomorrow.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by JoaoPedro: 9:02pm On Mar 15
Echika01:
THE TIME IS NOW
So Abuja drivers are not joining in on the strike?
Abi they’re comfortable with the fares as it is undecided
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 9:42pm On Mar 15
Kumuyiii:
bro eh, that's the hard part, the make majority of the trips... Men wey dey order them like food, all EVERY SINGLE bad rating wey i don get na them... Imagine 3 days ago.... Coastal road BLOCK, as in complete block... I wasted 3 hrs stand still, everybody begin do uturn... see wetin this f00l write, i con later ask, shey if na bolt you book, you go yarn me this rubbish..? Abi no be you go use ur hand abort mission, so becus na indrive, you no really send, and as ur slave, make i dey stand still becus queen Elizabeth wey you be, you dey go work.... To show you say na rat brain these creatures dey take waka, i actually told her I no care about the money(16k), make she just find her way, still!! These creatures are insufferable... Na why dem selves no dey like work with each other, terrible people... Today again, i don carry one reach street wey she dey go, these people begin feel entitled, like I'm supposed to wait for you to get the accurate house number... I carry dem reach first number 8, the second number 8 was 5 steps away, no wahala, i reverse carry them go there... She do money, i say, 'have a nice day'... She still sit down dey wait make person come carry them, i come tell am oya oh, fuel is 1300 abeg, the female dog tell me, what if i never send money you go hurry me... Na so she come down, the werey rate 1 star... Tag me rude... Omo i off... Na him i decide show her rudeness, according to her reply, dis clown actually know wetin she do, she did it intentionally... But i serve am hot food wey she no go quick forget... She f00lish girls know wetin dem dey do oh. Moving forward, I'm sure she'll think carefully b4 moving werey
Bros you too like fight, see wetin person passenger dey comment grin cheesy

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kumuyiii(m): 10:37pm On Mar 15
capetownboyz:
This conversation lol .. mehn today was hectic got trapped inside Lagos airport ,vehicle decided to go dead(refuse to start after topping fuel ) due to running out of fuel which I was unaware of due to bad a fuel gauge reader that I have been managing..coughed 15k ,mech plus car park trying to solve this issue..well today wasn’t it at all ..never been this stressed lol ..This job don test me in so may ways I never imagined ..Soft bobo like me 😑 need to tap out of this current reality until then,I’m humble and looking forward to a better life .
God will see us through my bro, hang in there.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kumuyiii(m): 10:46pm On Mar 15
Eazilyfe:
Bros you too like fight, see wetin person passenger dey comment grin cheesy
Lol no be for Instagram you see that picture?..... Anyway eget wetin i tell my mama..... God forbid, if you hear say i dey fight, no wait to hear from me, know the other person is at fault.... Edey hard for me to break.. I'm a long suffering man.... like i said earlier, every 4 or 1 star i ever received na woman. And most times, na over something wey be say if na man, talk no go even dey, talk more of low rating.

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by capetownboyz(m): 11:07pm On Mar 15
Kumuyiii:
God will see us through my bro, hang in there.
Amen
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Glithronix: 11:56pm On Mar 15
Jegheter:
U

Yes u r right but strike is still d only way. Let's every driver on this naira land platform heed d Clarion call.

Make we all join hand ensure this strike works by not switching on app tomorrow.
Me wey don already reduce my work days to 4 days already.
Last week self, I no even on my app talk more of working. That made it the 4th week I didn't work in this year, based on the yéyé prices. sad
This week, I only did 18 trips in total and na soft work, no high target. (screenshot below).
Next week, if I see say prices still be the same, I no dey on my app.
This is my own form of protest.

Much respect, baba.

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by easytig(m): 6:14am On Mar 16
Strike Kwa,Na to dey cherry pick trips I dey do for indrive,if any werey rider dey spam my request with constant ordering plus yeye price,I go just swipe am comot,if better trip no show I off app relax small,no be me go dey do fastest finger for yeye prices couple with high fuel prices.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Eazilyfe: 6:31am On Mar 16
Happy striking
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 7:21am On Mar 16
Great drivers on this platform. Morning cool

Please make no one on app biko. Let this strike strike well for d head of these wicked apps.

By His grace we shall conquer
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 7:35am On Mar 16
I don dey set trap.

I go waste many drivers fuel today

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by ebiye55(m): 7:42am On Mar 16
I am joining the strike. Let's all join too biko

Our voices need to be heard
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Latonal1: 7:44am On Mar 16
Driver's are online how can we stop them
Jegheter:
I don dey set trap.

I go waste many drivers fuel today

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jamie90(m): 8:04am On Mar 16
Jegheter:
I don dey set trap.

I go waste many drivers fuel today
Someone already drove for 16 minutes to come and pick me up. Me wey dey play FIFA.

I didn’t even know some drivers drive that long to pick up.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 8:06am On Mar 16
Latonal1:
Driver's are online how can we stop them
They are really online ooo....By wasting their time and fuel today so help me God
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 8:06am On Mar 16
Jamie90:
Someone already drove for 16 minutes to come and pick me up. Me wey dey play FIFA.

I didn’t even know some drivers drive that long to pick up.
Just imagine the slave mentality. Bro u r doing d Lord's work
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jamie90(m): 8:09am On Mar 16
Jegheter:
Just imagine the slave mentality. Bro u r doing d Lord's work
Just seeing this one on Facebook. Even 25 minutes?? This is why I say some people are destined to be poor.

25 minutes is at least 5k ride.

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by ebiye55(m): 8:14am On Mar 16
Let's call out the MODS & Seun to put this on the FP na. I already created a thread, hoping it will not be taken down

https://www.nairaland.com/8636256/ride-hailing-drivers-shut-down
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by SHOOPSYN(m): 8:15am On Mar 16
Is this guy on Naija Info, representing the suppose ehailing association okay at all. Not smart at all. Where are they always getting their representatives
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kaymax2222:
SHOOPSYN:
Is this guy on Naija Info, representing the suppose ehailing association okay at all. Not smart at all. Where are they always getting their representatives
that's the problem those representing us eh they are not that smart at all
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Jegheter: 8:30am On Mar 16
Jamie90:
Just seeing this one on Facebook. Even 25 minutes?? This is why I say some people are destined to be poor.

25 minutes is at least 5k ride.
shocked shocked 25 mins. Haaaaa

Poverty is a state of mind first.
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by TUBLEZ(m): 8:50am On Mar 16
Jegheter:
shocked shocked 25 mins. Haaaaa

Poverty is a state of mind first.
one is coming to pick me now 😆 19 mins to my location è remain 9mins, once e remain 3 minutes i cancel

Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kaymax2222: 9:13am On Mar 16
SHOOPSYN:
Is this guy on Naija Info, representing the suppose ehailing association okay at all. Not smart at all. Where are they always getting their representatives
the guy didn't actually speak badly sha
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by Kaymax2222: 9:14am On Mar 16
TUBLEZ:
one is coming to pick me now 😆 19 mins to my location è remain 9mins, once e remain 3 minutes i cancel
the hustle eh na indrive be the main problem now and na Uber/bolt create that monster. 19mins to go pick how much trip nawa oo
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by TUBLEZ(m): 9:20am On Mar 16
Kaymax2222:
the hustle eh na indrive be the main problem now and na Uber/bolt create that monster. 19mins to go pick how much trip nawa oo
this protest just dey open my eyes to the rubbish wey some drivers dey do, on a free night from ikeja to ojuelegba no pass 20 mins
Re: If You Are Uber Partner In Lagos, Please Share Your Experience Here by easytig(m): 9:22am On Mar 16
Which driver in his right senses picks a ride over 10 minutes to arrival,some drivers sef ehn ,Na wa
1 2 3 ... 6214 6215 6216 6217 6218 6219 6220 ... 6307 Reply

If You Are (uber/Taxify (bolt) e-hailing Partner In Port Harcourt, Come In.If You Are Uber Partner In Abuja, Please Share Your Experience HereSee How To Register As An Uber Partner In Lagos Or Abuja234

Bankers For Baba-Ijebu (Premier-Lotto).

Viewing this topic: finoki and 2 guest(s)