₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,327,332 members, 8,430,443 topics. Date: Saturday, 20 June 2026 at 01:24 PM

Toggle theme

The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! - Family - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralFamilyThe Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! (2894 Views)

1 2 Reply (Go Down)

The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op):
All Warfarians in the Family section, come in here let's discuss. This is derailers' haven!!! cheesy Use slangs freely like say tomorrow nor dey grin

Forgive my bad manners grin I didn't introduce myself...heheheh grin

Na me be the Kpakpandu 1 of Warri, Warfi first son...the only man wey use beans and plantain and soaking garri take celebrate baiday! Abeg, make we leave story for Crown Fmgrin

Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Fabdedon(m): 9:00am On Mar 09, 2015
so nah which matter you carry come put for table make we begin de pieces am
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 11:18am On Mar 09, 2015
Fabdedon:
so nah which matter you carry come put for table make we begin de pieces am
This na Warfi corner. Na beer parlor we dey so...beer and nkwobi must be present. Bar man!!!
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by veave(f): 1:25pm On Mar 09, 2015
Wish level ona dey nah. Na me be d area mama for dis we thread. Anibodi wey do anyhow go collet am...
Area!!! Eh!
grin grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by sirvic01(m): 1:56pm On Mar 09, 2015
All of ona Fadda ....ona no wan regard me abi? anybody wey misyan for this bar i go dull am oooo
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by zaimeg: 1:57pm On Mar 09, 2015
veave:
Wish level ona dey nah. Na me be d area mama for dis we thread. Anibodi wey do anyhow go collet am...
Area!!! Eh!
grin grin
Area! I hail!
You be waffi shenkes?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by veave(f): 2:04pm On Mar 09, 2015
zaimeg:
Area! I hail!
You be waffi shenkes?
Me nor be waffi oh. Na pass me jos dey pass grin grin

Hafa na, wish levels na.
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by zaimeg: 3:11pm On Mar 09, 2015
veave:
Me nor be waffi oh. Na pass me jos dey pass grin grin

Hafa na, wish levels na.
Correct!
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 3:03am On Mar 10, 2015
veave:
Wish level ona dey nah. Na me be d area mama for dis we thread. Anibodi wey do anyhow go collet am...
Area!!! Eh!
grin grin
I dey feel u mama!**orders 2 bottles of Orijin for her** grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 3:04am On Mar 10, 2015
veave:
Me nor be waffi oh. Na pass me jos dey pass grin grin

Hafa na, wish levels na.
U wan make deh ring bottle for ur head? grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by veave(f): 3:12am On Mar 10, 2015
Rapmoney:
I dey feel u mama!**orders 2 bottles of Orijin for her** grin
Broooos bros. grin grin grin
Shop noku shop noku.
The oly tin be sey, i nor dey drink that type.
Errm, i fee chop peppersoup sha grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by veave(f): 3:14am On Mar 10, 2015
Rapmoney:
U wan make deh ring bottle for ur head? grin
Come fes, dey nor dey sleep for una haas?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 6:43am On Mar 10, 2015
veave:
Come fes, dey nor dey sleep for una haas?
grin grin You dey lie abi? Me dey see an say u be real Warri pikin cheesy
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 6:47am On Mar 10, 2015
veave:
Broooos bros. grin grin grin
Shop noku shop noku.
The oly tin be sey, i nor dey drink that type.
Errm, i fee chop peppersoup sha grin
Oya make deh give u two plates of pepper soup with all kinds of assorted...liver, abodi, roundabout, floater, shaki! grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by DaGC(m): 7:47am On Mar 10, 2015
I hail the house

Na stout be my brand. So make una press me 1 cold medium 1st make I take see front.
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by floragregs(f): 8:42am On Mar 10, 2015
I hail o. Ah nor wan drink make ma eye nor go dirty! Ah say make ah come hear gist. Weti dey happen na?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 4:19pm On Mar 10, 2015
DaGC:
I hail the house

Na stout be my brand. So make una press me 1 cold medium 1st make I take see front.
**Bar man!!! Where is that fuc.king bar man? Bring one cold stout for this our area man!**
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 4:19pm On Mar 10, 2015
DaGC:
I hail the house

Na stout be my brand. So make una press me 1 cold medium 1st make I take see front.
**Bar man!!! Where is that fuc.king bar man? Bring one cold stout for this our area man!** The house welcome u wella cheesy
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 4:23pm On Mar 10, 2015
floragregs:
I hail o. Ah nor wan drink make ma eye nor go dirty! Ah say make ah come hear gist. Weti dey happen na?
Sister, welcome to the ogbonge Warfi corner. E dey happen for Victory View for Udu every Sunday o! Enuff flexing. Area still dey move forwardcheesy
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 4:40pm On Mar 10, 2015
sirvic01:
All of ona Fadda ....ona no wan regard me abi? anybody wey misyan for this bar i go dull am oooo
No fighting...no violence! We dor recognize u. No worry, Orijin dey comegrin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by DaGC(m): 10:02pm On Mar 10, 2015
Rapmoney:
**Bar man!!! Where is that fuc.king bar man? Bring one cold stout for this our area man!** The house welcome u wella cheesy
Thank you. The guyman dey f**k up.
Oshare mavo?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 10:50pm On Mar 10, 2015
DaGC:
Thank you. The guyman dey f**k up.
Oshare mavo?
Oni ovo, how far na? cheesy
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by DaGC(m): 6:07am On Mar 11, 2015
Rapmoney:
Oni ovo, how far na? cheesy
Brother I gallant o
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by sirvic01(m): 2:18pm On Mar 13, 2015
Rapmoney:
No fighting...no violence! We dor recognize u. No worry, Orijin dey comegrin
shwooo....I dey here since dey wait for Orijin, e never still cole?? abeg gimmi hot one i go guzzle am like that grin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 2:23pm On Mar 13, 2015
sirvic01:
shwooo....I dey here since dey wait for Orijin, e never still cole?? abeg gimmi hot one i go guzzle am like that grin
Oya, bar man abi na bar boy!!! Come here quick before I ring this Star bottle for ya head! Give am 1 cold Orijingrin
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by sexymoma(f): 3:30pm On Mar 13, 2015
abeg i wan enter... who dey hia.
na hia i be wan mekue grin
Ah go sitdon dey observe
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by lordmario(m): 9:04pm On Mar 13, 2015
I hail everybody for d bar o... To all my chairman dem I greet una minguo ... To all my men dem, una weldone o. How d level for dis area? #sitsdown barman abeg gimmie 2cups of holy water make I use am wash throat.
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 8:52am On Mar 14, 2015
lordmario:
I hail everybody for d bar o... To all my chairman dem I greet una minguo ... To all my men dem, una weldone o. How d level for dis area? #sitsdown barman abeg gimmie 2cups of holy water make I use am wash throat.
You are very welcome! This na warfi corner for family section. The bar is always open to entertain u cheesy Area!!!
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 8:55am On Mar 14, 2015
Abeg my pipo...wetin una think about this fuel scarcity? Yesterday, I bought fuel for 120 naira per litre!!! The queue wey dey fuel stations sef na die! Una nor surte say Jona nor get total control over this government?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by lordmario(m): 1:28pm On Mar 14, 2015
Rapmoney:
You are very welcome! This na warfi corner for family section. The bar is always open to entertain u cheesy Area!!!
Yes o..... Wetin dey happen for dis area? Where all d shekes na? Make I nor just dull quench for dis area
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by lordmario(m): 1:30pm On Mar 14, 2015
sexymoma:
abeg i wan enter... who dey hia.
na hia i be wan mekue grin
Ah go sitdon dey observe
Nor just siddon dey observe dis level ... U nor go serve us isi ewu n palmy?
Re: The Warri Beer Parlor**(who You Help?)**Come In Anytime!!! by Rapmoney(op): 1:44pm On Mar 14, 2015
lordmario:
Yes o..... Wetin dey happen for dis area? Where all d shekes na? Make I nor just dull quench for dis area
Oya, we go change am to hook-up zone for Family sectioncheesy
1 2 Reply

"My Husband Smells My Panties Anytime I Come Back From A Journey" — WifeMy Wife Nags Anytime Am Broke, Please AdviseAnytime I Sleep With Her, I Receive Strange Knock On My Head —husband234

It Is The Same Blood That Runs In A Woman's VeinI'm Not Going To Get Married, What's The Implication For Me?Why Do Gays Want Kids???