Some Funny Warri Parables - By Rapmoney - Culture - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Culture › Some Funny Warri Parables - By Rapmoney (3611 Views)
| Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 9:25pm On May 31, 2015 |
Here are some funny Warri parables to spice you up Warri nor dey carry last, if e too mush...abeg, make we leave story for Crown Fm ![]() 1. No matter how nyash make yanga reach, leg go still first am enter house ![]() 2. Pikin wey dey look for cry, deh nor dey push e head (deh go say na u beat am) ![]() 3. Goat know say the waka waka wey dey dis life plenty well well, na e make am wear shoes come life ![]() 4. Tortoise know say house rent cost too much, na e make am carry e own house come life ![]() 5. Snake wey say na tortoise back e wan bite, na toothache go kill am. 6. Difference dey between bathroom and baffroom. If ur soap fall for baffroom, u nor dey pick am again ![]() 7. Deh dey call names of sickness, craw-craw still dey smart dey raise hand up ![]() 8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe. 9. Na legbere (weak man) na e dey run go house go pull shirt if deh find e trouble for outside. 10. When guy man dor fvck-up, e go use shame talk say na e style be dat 11. Small pikin wey say na e papa e wan carry for shoulder (akoko), na big blokos go surffocate am ![]() 12. Oga, na im first slap me, na im first slap me...na because police never enter the matter ![]() I will post more as they come to mind... U can add urs ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Yawgawlfriend(f): 9:32pm On May 31, 2015 |
Observing.. |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 9:33pm On May 31, 2015 |
Yawgawlfriend:Observe very well o! ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Yawgawlfriend(f): 9:38pm On May 31, 2015 |
Rapmoney:alright. |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Vikta10(m): 10:03pm On May 31, 2015 |
8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe. 11. Small pikin wey say na e papa e wan carry for shoulder (akoko), na big blokos go surffocate am LOL! gat me cracking |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 10:18pm On May 31, 2015 |
Vikta10:Yeah, how we roll in warfi ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 10:34pm On May 31, 2015 |
Na wa o! 49 views, 6 comments only? E be like say pipo for culture section nor get joy again o! Abeg, bigfrancis21, Fulaman198, odumchi, make una move am go front page or Jokes section kpa kpa! ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by hpk(m): 9:06am On Jun 01, 2015 |
pikin when rush get bald head, na headache go kill am. na where ground no dey na hin two people dey drag who run pass. |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 10:13am On Jun 01, 2015 |
hpk:Kai! Ur head dey there I swear ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Begonia(m): 12:27pm On Jun 01, 2015 |
![]() They're funny but I don't understand these two. 7. Deh dey call names of sickness, craw-craw still dey smart dey raise hand up. |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by pinkycute(f): 12:40pm On Jun 01, 2015 |
![]() ![]() |
| Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(op): 12:44pm On Jun 01, 2015 |
Some Funny African Proverbs That You Don't Know (must Read) • 2 • 3 • 4
Brief History Of Ijoko In Ogun State • 11 Most Shocking Sexual Traditions From Around The World – Video • Bayajida !?
Warri nor dey carry last, if e too mush...abeg, make we leave story for Crown Fm