₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,328,468 members, 8,435,777 topics. Date: Monday, 29 June 2026 at 10:31 AM

Toggle theme

10 Silly Questions People Ask - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentJokes Etc10 Silly Questions People Ask (869 Views)

1 Reply (Go Down)

10 Silly Questions People Ask by cagunwa(op):
10 STUPID QUESTIONS PEOPLE ASK
1. You see identical twins, you
still dey ask '"na twins be this?"
No bros, na picmix...Lol!
.
2. Nepa brings light and
everyone in the neighborhood
shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, "O boy na light be that?"
No oh, Na Holy Ghost fire! Lol!
.
3. You see person dey vomit, you
still dey ask am "you no well'?
Em well, e juz dey practice how
to vomit.
.
4. You just wake up from sleep
person come ask you say "you don
wake?"
No oh, I come buy bread wey I go
chop for dream.
.
5. You see woman wey born new
pikin you ask her "madam you don
born?" No ohhhh, she buy am
for OLX...
.
6. You greet person "good
morning ma" ! She ask, my pikin
you don wakehuh?
no ohhhh, I dey sleep walk...
.
7. My guy ask me "O boy where you
dey?" I tell am say i dey bank, and
him come ask me say "What is happening there?"
Nah new yam festival.. *LMAO*
.
8. My neighbour sees me
opening the gates to drive out
and asks me, "You dey comot?"
Not at all... I be the new
gateman...
.
9. I dey watch film… my guy enter come ask me "Guy na film you dey
watch?"
No naa... I dey discuss with
Osuofia...
.
10. You see me dey chop indomie
come dey ask me, "O boy, na
indomie you dey chop so?"
No ohhhh... Na fried rubber band
mixed with thread.
.
As it stands now, abeg i need to
ask you one question, no vex abeg.
Shey na nairaland be this?
Re: 10 Silly Questions People Ask by Lattop(m): 8:08am On Aug 08, 2015
Nooo nah Poundslandgrin
Re: 10 Silly Questions People Ask by Nuezha(m): 8:21am On Aug 08, 2015
Most times, the questions were mere sarcasm.
Re: 10 Silly Questions People Ask by cagunwa(op): 11:35am On Aug 08, 2015
Nuezha:
Most times, the questions were mere sarcasm.
Sarcasm means the use of words that mean the opposite of what you really want to say especially in order to insult someone, to show irritation, or to be funny.
So we are just catching fun.
1 Reply

�lol. Yanbaba Meme's : 10 Silly Things Girls Should Stop In 201711 Foolish Questions People Ask In Nigeria, Pick The Funniest Number!10 Stupid Questions People Ask And There Stupid Answers234

A Letter To My Mates In Primary And Secondary School!!!Ladies What Happenes If He Comes Looking For You Like This?Must Read! New Found Chemical Element!