Some Funny Slangs Used In Warri - Travel (3) - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Travel › Some Funny Slangs Used In Warri (104050 Views)
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Agimor(m): 1:42pm On Oct 29, 2015 |
Area i troway salute o twale!!! |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Etizz: 1:43pm On Oct 29, 2015 |
Bob I won cover one side, I go clear u matter when I show....... #INTERPRETE# |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by OrlandoOwoh(m): 1:50pm On Oct 29, 2015 |
BRACKET is used to mean meet. E.g. I go bracket you for Enerhen Junction means I'll meet you in Enerhen Junction. Warri sweet die. |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by mayorkyzo: 1:52pm On Oct 29, 2015 |
Wetin dey trip me pass for this warri eh,i fit just form slang just now eh,normal warri boy go understand am once.... AREA!!! Na lean on me I tell u,no press me die ![]() |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by hebenezher(m): 1:59pm On Oct 29, 2015 |
Goodboiyy:bros abeg commot yah leg for life wire... It's rather too glaring that lagos is more respected and rugged than warri... Cease comparing the.. Warri guys can be so mouthed ''yes'' i ain't countering that, but aside mouthed. Brother swerve |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 2:01pm On Oct 29, 2015 |
fratermathy:Ermmm brotherly Lem wen I know na to chop o In other news Cry your cry aka cyc; waffi slang 4 carry your cross Chenkes, girlfriend Maintain, stay calm Arrange chewing, cook or buy food |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by tmxme(m): 2:02pm On Oct 29, 2015 |
Sucking pipe means straw |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by eterisan(m): 2:03pm On Oct 29, 2015 |
Oboi u nr yan bobo.. Ur teeth correct @ op |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by eterisan(m): 2:05pm On Oct 29, 2015 |
Etizz:i de comot if i return i go clear u as i waka pass |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by darichlife(m): 2:05pm On Oct 29, 2015 |
abeg which award all their slangs don win? like say them de even buy and sale am to make money Going to warri to arrest people who speak all this gutter called slangs ![]() |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Pepunis(f): 2:09pm On Oct 29, 2015 |
Warri funny die, staying in warri make me to knw these: i beg no carry ur winsh join my own u hear, a girl finish answering a call wit a frown face her friend asked her remu wetin appen, remu with every vest say, no mind onos he want use his regga spoil my blues. At ogunu one evening a certain group of strong face guy came to draw debt from mr tobore, is like d man gave them another promise, one of them raise his voice and said 'bros take ur time ooo u dey delay my destiny ooo, u hear a question ur dey delete, |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Onosboi(m): 2:10pm On Oct 29, 2015 |
Henrypraise:Girls plenty 4d ground |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by pgodson7(m): 2:13pm On Oct 29, 2015 |
Erema sawarele 'gals many for d area' Henrypraise: |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 2:15pm On Oct 29, 2015 |
Palansh, fvck Fashi, forget Ofor, phone Antara, disturb Kasala, wahala Remove, leave Ochuko, expo Chook, stab Control, phone number You carry your. Eye go market o, when your babe fine die .... |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by oforij(m): 2:15pm On Oct 29, 2015 |
You don baff- when you make a mistake and you think you are correct *kpakam- very correct *tale- respect *legit-genuine i rep waffcity |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Onosboi(m): 2:17pm On Oct 29, 2015 |
Pepunis:I nor spoil anybody blues nau ![]() |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by papermil(m): 2:18pm On Oct 29, 2015 |
Who warri help? |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 2:21pm On Oct 29, 2015 |
hebenezher:Make ur town juju nor push you go enerhen junction, igbudu or NPA go talk this kin word o... dem go just share groundnut ( bullet) for you and all men go remove bfre kpor kpor go show... I have stayed in the roughest parts oof lag and even. There na the waff bois dey represent... waff still carry first second and third for slang lingo and ruggedity o, nor reason am sef oniovo |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by daxlasaint(m): 2:33pm On Oct 29, 2015 |
chrisbaba1:Every wen u yarn now na waff lingo sef... only you sef dey chest hawe mata... Akpomedaye ![]() |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by wtfCode: 2:39pm On Oct 29, 2015 |
slimmyjimmy:meeehn, diz ur signature na die. |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Snoopywallace(m): 2:41pm On Oct 29, 2015 |
your boy dey oo(even for someone u re obviously older than)...
Bros Abeg deliver your boys na... |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:42pm On Oct 29, 2015 |
Datazone:Lolz.. @Bolded thanks for educating me on that. Area Heyyyyyyyyuyyyy.. Let's tell the world We are United ... |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:43pm On Oct 29, 2015 |
I like Warri boys but they always think they're smart. |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:46pm On Oct 29, 2015 |
daxlasaint:lmao, "chest", wetin be akpomedaye |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:46pm On Oct 29, 2015 |
mordtonia: oshe11:My Apologies.. I never meant to Sideline my Greet Isoko people, Not to worry Am creating a unique thread about Urhobo/Isoko , So don't get angry yet.. My Apologies.. Areaaa |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Teryfik(m): 2:48pm On Oct 29, 2015 |
fratermathy:my name na TERYFIK me jst dey cane my lane 1 luv mehn |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:50pm On Oct 29, 2015 |
chrisbaba1:Akpomedaye means "my life is frustrating Them" or "My life is paining them".. any way one you choose. fratermathy, odey Twion yeh' ? if am wrong correct me |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:54pm On Oct 29, 2015 |
fejikudz:Fejiro mavor ?.. I nor forget kpompki oo.. So many waffi slangs full the head, I just drop the main 1.. but una represent well. Jah bless... Warri slangs nor get ending oo |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Nobody: 2:55pm On Oct 29, 2015 |
fratermathy:Wen we see Area we they know. Areaa |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by Okies27(m): 2:59pm On Oct 29, 2015 |
Goodboiyy:. The good thing about Warri pidgin is that they know how to mix vocabularies with it... o boy ,I done meander to one side. |
| Re: Some Funny Slangs Used In Warri by warriboy21(m): 3:12pm On Oct 29, 2015 |
lagos get any slang . dos dry slangs of urss ....warri is d home of slangs abegi.....dos laos fake slangs were only made popular because lagos has d media power to shove it down our throat over ere in warri n d rest of d country..if warri has dsame media power as lagos, oboy d full country go de laff everday because slangs comes outa warri daily..i mean it..has it ever occured to u dat d popular evergreen slang "HOW FAR" was from warri? once u c a warri boy ..u kn because of d accent.....u cnt jus fake a waffi accent at al..it has 2 b inbuilt.. make i add my own make e no blik say i de vex ![]() PRESS-- means chill...e.g..tejiri i 1 go dat store go press for 30min BIG FOOL WEN NO DE BAF- means who doesnt kn his left from right..e.g. obob leave dat babe..na big fool wen no de baf.. I DE C MY PERIOD-- means im broke--oboby like dis enn..i de c my period badly...e de rush die (warri no go kill me)CAST---means get out....eg...rukevwe cast comot ere now now... FRY STEW-means female period...e,g..obob yesteday d babe no let me enter jerusalem because say she de fry stew.. i rep warri die ![]() |
14 Funny Lagos Traffic And Auto Slangs With Their Meanings • Slangs Used In Portharcourt • Top 10 Lagos Slangs You Must Know As A Resident • 2 • 3 • 4
Meet The Air Peace Crew That Flew In The Medical Supplies From Turkey(photos) • My Experience Living In China For 4 Months - A Nairalander • Ghana Opens The Highest And Longest Flyover In West Africa (Photos)


abeg which award all their slangs don win?
like say them de even buy and sale am to make money
Going to warri to arrest people who speak all this gutter called slangs
means soldier. Oboy discharge Congo de area o. (telling ur guy to escape, soldiers ar in d environment)
