Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,143,238 members, 7,780,467 topics. Date: Thursday, 28 March 2024 at 02:59 PM

The agony of a Nigerian - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / The agony of a Nigerian (1382 Views)

Senate Moves To End Agony Of Nigerian Teachers / This Is My Story- The Agony Of A Senior House Help (a True Life Story) / The Agony Of A Unn-student Pharmacist (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 2:36pm On Apr 23, 2017
Make I greet una and salute.

Abeg, make una no expect any Queen english for this 2nd book of lamentation wey I wan write o, na the typical Nigerian language wey we both understand na im I go take type am. angry

As you see so, I dey vex gan and I wan rant wella, make I pour out the pain wey don dey inside me for so long. angry

Make una follow me ride go.
Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 2:57pm On Apr 23, 2017
Make I start like this.......

Wetin propel me wey wan make me write this thing be say I tire for so many things for this my country.

Few days ago, me dey wan side dey plan how I go get 5odds wey me go put money wey go atleast gimme some cash wey go carry me do omoboy the coming week, na so I hear say EFCC recover one money like dat wey my entire family never gather, seriously the thing just weak me, U cum dey wonder say no be this same people wey we carry our own korokoro finger vote for they carry our common wealth bury so?
Them go talk say make we go school to become leaders of tomorrow, person go reach Senior Secondary school, na from there wahala go start, you go start battling with WAEC, you pass WAEC lasan, Na to begin do thanksgiving about, after that one, na to come face another beast in form of exam, you pass that one too, the main koko come be say make you take am enter higher institution of your choice and the course wey you want, them go tell you say if you no sabi anybody for the institution wey you choose, no admission for you.
Ok, you come struggle gain admission, Na to dey feel on top of the world, you enter school again, Lecturers no go make things easy for you, na to dey set exams like say na the exam go carry you enter heaven, you struggle and managed to graduate with 3rd class, dem go begin criticise you, call you unserious person.

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 3:24pm On Apr 23, 2017
The 1st class certificate wey you go get wey no guarantee you job, 1st class graduate go dey sell okirika for Alaba, 1st class holder go dey use moruwa carry people from Oshodi to Express, the wan wey no fit do dat one go come get laptop dey use am 'shashe', you go come arrest am go put am for back of canter, no be say I dey support yahoo yahoo but how people no go do am when he don dey frustrated, you dey talk say make youth create jobs, where the capital to start the business, make we come serve our fatherland during NYSC, you go give us esha money wey some people dey take buy one bottle of wine in a club just one night, make we dey take am survive for a month, we don ready to start business, where the power supply wey go boost production, you call us Leaders of tomorrow, since I begin crawl na Im I don dey hear those words, yet those that rule about 50years ago are the leaders of tomorrow, which way Nigeria?

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 3:33pm On Apr 23, 2017
I hear say for Naija before, Naira is more valuable than Dollar.

I hear say for Naija before, Foreigners love to come and stay here.

I hear say for Naija before, it is an offence for federal office holders to have more than 3 personal car.

I hear say for Naija before, to travel out of the country doesn't require much stress like it is today.

I hear say for Naija before, Education is free and for all.

I hear say for Naija before, official car and apartment don dey wait for you if you finish school

I hear say for Naija before, na Politicians we get, no be Polithiefcians.

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 3:54pm On Apr 23, 2017
Who go carry our voices go meet our so called leaders?
Youths go stage peaceful protest jeje to voice out their pains, police go come, scatter am, begin throw teargas into the crowd, begin shoot sporadically into innocent's people, many go die, many go wound because them wan stand and fight for their right.
I no kuku blame 2baba wey back off his supposed led protest, we kuku get some cabal wey dey rule this country, and the guy being a 'father of many nations and babymamas' no ready to lose any of them.

Them talk say our mumu don do, for me, na our mumu just started, abi no be mumuness dey give people money now?
Big Brothers Nigeria, no be mumu?, Whistle blowing, no be mumu?

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 8:24am On Apr 24, 2017
I know say Mods no go dey eager to carry this one go FP and it's unfair, if to say na 8 topics person post on top Big Brother Naija, those Mods go carry all the topics go FP, dem go happily move Apostle Suleman palaver reach promise land, dem go rejoice carry Vaseline crew food reach there but the agony of suffering citizens no go near FP, if na snake matter, Lalasticlala go don show since, abi na because I never Cc Lalasticlala .
See, if you like make you close this thread, ban me, abi make you no take am reach FP, my last bus stop no be here, I still dey go twitter and facebook go voice, where my ranting may be valued.

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 8:48am On Apr 24, 2017
My own matter kuku get as he be.

To read na wahala, dem don recognize my name for Jamb and no be say person no know book but where sponsor, many private universities don offer me admission, where money to go, the Federal wey I won go, no connection.........this korokoro last year, I was offered admission into 2 different institutions, money still mess me up.

Our people sef no help matter, just because you dey cruise around in one mad ass car like that, leaving one AC-bound office into your AC(ed) apartment, cross leggy after the day dey watch TV, you think say na so e be for everybody, I no talk say make you no enjoy your life o, but why not just change that your neighbor's life forever, if e better for him finish, im no go forget that favor.

I remember one Sunday like that wey I dey for twitter jeje, na im Davido (OBO) cum talk say the Sunday cool for his side say him won dash out money, and the weather for my own side hot and dry like mad ni, me sef come say make I join the train o, I drop my account number, na so one god-forsaken guy come begin abuse and swear for me say I be internet beggar, I no kuku blame the guy, sheybi him don chop bellefood and he get some change inside his account, why him no go behave like that?

3 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 9:08am On Apr 24, 2017
Na those people wey don hammer, na dem still dey receive money on top money, rich people go dey dash celebrities money and some people never see money chop.

Wetin person never do just to get money?
I dey sing, I dey act drama(na dis one I sabi pass), I don do comedy skits, I don hawk, I dey play ball sef but things never gather.

I talk say I dey live around Airport area but I never fly inside Aeroplane, the 1st time wey I enter inside plane, na hustle carry me enter, na plane I go sweep, I no even get time to tour the plane sef before them send me Comot.

Seriously, I never enjoy any common wealth of Naija as a citizen and I dey rep am, our government just lock up as if na animals dem dey rule, our opinions no count like say na military era we dey, even if na military dey rule us for this country, I no say things no go corrupt as e reach so.

2 Likes

Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 10:18am On Apr 24, 2017
My mates dey school dey talk about lectures and exams, me I dey house dey sleep, people don talk different kind of talks, some say I no serious, some say I too lazy, some dey mock me, wetin person never hear?

Na them go later hear about your success talk say you do juju or money ritual.

I talk say I won further my education for twitter, make people help me retweet, I no even get 10 retweets sef, because I no be celeb, them no see my own think.

I no dey deceive myself form wetin I no be, I be confirmed ajepako wey need help.

Them talk say whistle blowing don turn money but where money to buy whistle
Person don think and think, but wetin person wan do?
The place wey dey make me forget my worries sometimes na this Nairaland , the phone wey I dey use sef, most times na life support I dey give am(operation no charging, no pressing), and slavery era don enter oblivion for Naija, Why our so called leaders come dey treat us like slaves?
I know say no be my matter worse pass but why you no go fit enjoy your life for here?, unless them see you for BBN, unless you show for celebs photoshoot, unless you be Music artists, unless you blow whistle, unless you join politics, unless you be comedian for AY live show, na then people go recognize you.

When last we celebrate young and potential inventors?, When last we represent Naija for World exhibition?, when last we export our own products?, when last we explore our other natural resources(apart from oyel) converting into national income?, when last we make use of our refineries?, when last our higher institutions enter top 100 for World rating?


Think my people..............THINK!!!

1 Like

Re: The agony of a Nigerian by olahajayi(m): 10:45am On Apr 24, 2017
Viewing this topic: lalasticlala(m), uniquealdehyde (m)
Re: The agony of a Nigerian by omobs(m): 11:28am On Apr 24, 2017
no wahala,e go better
Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 12:12am On Apr 25, 2017
omobs:
no wahala,e go better
My Bros, when When gangan? When person no fit read again?
Re: The agony of a Nigerian by Mykel4God(m): 1:03am On Apr 25, 2017
olahajayi:
Viewing this topic: lalasticlala(m), uniquealdehyde (m)


Lalasticlala, you show, you comot again without taking my plight reach Frontage. embarassed
olahajayi:
Viewing this topic: lalasticlala(m), uniquealdehyde (m)


Lalasticlala, you show, you comot again without taking my plight reach Frontage.

God dey o

(1) (Reply)

Check Out This Photo Of Tboss And Father That She Refused To Show Us / Why Are Landlords So Reluctant To Rent Their Flats To Igbos? / End Time Building!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 46
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.