₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,326,350 members, 8,426,181 topics. Date: Saturday, 13 June 2026 at 07:25 PM

Toggle theme

Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? - Family - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralFamilyPidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? (1538 Views)

1 2 Reply (Go Down)

Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 8:43am On May 13, 2020
Wetin be d tin wey dey worry u for mind? Wetin dey make you no jolificate or happy ya sef? Wetin dey disturb u for mind? Wetin dey trouble ya mind?

I know say all of us dey find money, but abeg, I no wan make anybody come yarn money mata for here. We fit yarn job mata, wife mata, husband mata, bf/gf mata, career mata, house mata, coro mata, hand work mata, and echetram echetram!
Just yarn ur mind! Person fit helep ur mata for here.

I dey knee down beg doze wey go fit hep, make dem hep! Make una hep una brothers and sisters. We no fit chop oursef. Na hep we go dey hep oursef, since our government no wan hep us! Country hard gan and the best way to make am make small sense na if we dey hep oursef!

Make u NO drop too much story. Just make am chinkini and simple, so that person go fit read am shapally.

For doze wey go say: "Op, first drop ya own mata". Ok o...my mata na say; I dey find government work and wife. (Make una no laugh me o)
I dey sing wella and I dey act, but money no dey gree comot for the show, and na my passion. Na jeun jeun level d mata dey now. Since yogor neva dey come out for d mata and age don dey climb Cambridge, I need marry and job gaz dey before I marry. I want job wey go gimme time for my passion; that na why I bn dey find government job.

Oya, na una turn remain.
Na only for pidgin English make you yarn o. No grama!
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by JeffreyD1(m): 9:09am On May 13, 2020
The mata wey de worri me be say
I be better driver oh
I de find private job
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 9:14am On May 13, 2020
JeffreyD1:
The mata wey de worri me be say
I be better driver oh
I de find private job
Plenty private driving jobs full Nairaland wella. Make you register for www.driversng.com
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m):
op ........
Gajsjskskskdjsjjdjdjd

...............
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 10:17am On May 13, 2020
ogashman:
op I say make we no talk money matter but na my problem be that o.
I need money to take buy food stuff...I don red like this like this
What if person bring food stuff come ya side? U go collect?
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Victorolab: 10:40am On May 13, 2020
Na job I need badly now,anywhere wey help fit come from, I no mind,I dey abuja,na my contact be did 08077130312
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m): 10:44am On May 13, 2020
OcVoice:
What if person bring food stuff come ya side? U go collect?
very fast o.

I no mind....I dey mararaba, nasarawa state
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 10:59am On May 13, 2020
ogashman:
very fast o.
I no mind....I dey mararaba, nasarawa state
Your location far bros, but send me pm make we word
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 11:03am On May 13, 2020
Victorolab:
Na job I need badly now,anywhere wey help fit come from, I no mind,I dey abuja,na my contact be dis
Which kain job you dey find bros? Shey you Sabi any handwork(skill)?

Comot your number first, make bad people no go touch light you
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 11:06am On May 13, 2020
JeffreyD1:
The mata wey de worri me be say
I be better driver oh
I de find private job
Bros Jeffrey how far? U don fill the form for that link?
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Victorolab: 11:35am On May 13, 2020
OcVoice:
Which kain job you dey find bros? Shey you Sabi any handwork(skill)?

Comot your number first, make bad people no go touch light you
Alright I go comot am, I be good,trained and reliable manager with integrity, the handwork wey I know na to snap photograph.
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by demoBaba: 12:23pm On May 13, 2020
ogashman:
very fast o.

I no mind....I dey mararaba, nasarawa state
Which area you dey for mararaba?
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 12:27pm On May 13, 2020
demoBaba:
Which area you dey for mararaba?
You too much bros. smiley

Oya ogashman, hanlele rush come answer bros o
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 12:32pm On May 13, 2020
Victorolab:
Alright I go comot am, I be good,trained and reliable manager with integrity, the handwork wey I know na to snap photograph.
Ok bros. Dem dey see am!

Anybody wey get photography/picture job for Abuja, abeg contact oga Victor.
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m): 12:40pm On May 13, 2020
demoBaba:
Which area you dey for mararaba?
close to Abacha road boss
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m): 12:40pm On May 13, 2020
OcVoice:
You too much bros. smiley
Oya ogashman, hanlele rush come answer bros o
thanks boss
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Oladayo12(m): 1:40pm On May 13, 2020
Abeg any person wey fit help me with job i swear i go too happy wella, i just commot for school and i never see any work do. Owu don show me pepper like say tomorrow no dey, Abeg our naija brothers & sisters make una help my dear life.
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by moonberry: 3:54pm On May 13, 2020
Hmmm! Op the mata taya me o. I just dey reason my life nah. After I hustle run pdge program for NTI. Since 2018 until now no result. Shey I for use that one done seek Teaching opportunity for government schools. Now see as my life dey now private school owners refuse to helep der staff for this pandemic wahalah , wey tanda for we country so.
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by halogate: 8:55pm On May 13, 2020
undecided undecided..mehn I nor go lie. guyman don tire oh. na every day.
..private sch wey dey take hold skin, no salary since March..how man go survive when monica finish for hand??
..job wey I dey pursue..dem say make I tidy dem or no letter..me wey dey manage 101. I reach out to ma niggaz, men just silent for my matta. i just dey drink locozade boost for my life.
..this coro period na big revelation for where I dey...u get friends only when u wahala never bite u for yansh...
..make I stop for here jare....I don dey vex already.
..make this coro just end make I see front..dis life sef!!
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m): 9:42pm On May 13, 2020
OcVoice:
Your location far bros, but send me pm make we word
Boss i don send u pm since
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by JeffreyD1(m): 6:36am On May 14, 2020
OcVoice:
Bros Jeffrey how far? U don fill the form for that link?
No ooo

I stopped where them de ask for my neighbor number
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Onego(f): 8:08am On May 14, 2020
halogate:
undecided undecided..mehn I nor go lie. guyman don tire oh. na every day.
..private sch wey dey take hold skin, no salary since March..how man go survive when monica finish for hand??
..job wey I dey pursue..dem say make I tidy dem or no letter..me wey dey manage 101. I reach out to ma niggaz, men just silent for my matta. i just dey drink locozade boost for my life.
..this coro period na big revelation for where I dey...u get friends only when u wahala never bite u for yansh...
..make I stop for here jare....I don dey vex already.
..make this coro just end make I see front..dis life sef!!
na true you talk, most of all this private schools owners no dey save for rainy day o
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Onego(f): 8:15am On May 14, 2020
See me see gobe o, I get somebody wen I dey teach her children for private lesson before na so she ask me make I stop, when coro start o, so some days back she call me ask how I dey I tell her fine o, she ask say how I dey cope, na so I tell her say na God dey keep me, so she say okay say make I come her house say at least she get something for me and say the kids go like see me, so when I get close to their house na so she call me say she no want visitors o, but I go fit see them through the window oo, just imagine o
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by bjprodint(f): 10:37am On May 14, 2020
my own wahala be say i need like 10k,i wan use am buy somethings for my popcorn business as e be sey school no wan resume ,i dey teach for one private sch.as e be so,my oga for wirk never even pay me february money.and my pikins gat to chop.i seriously need helep abeg.
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 11:14am On May 14, 2020
ogashman:
Boss i don send u pm since
I no see your pm o. I suppose see the pm alert from my page. Try send am again abeg
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 11:30am On May 14, 2020
bjprodint:
my own wahala be say i need like 10k,i wan use am buy somethings for my popcorn business as e be sey school no wan resume ,i dey teach for one private sch.as e be so,my oga for wirk never even pay me february money.and my pikins gat to chop.i seriously need helep abeg.
Nothing do you madam. Every go set wella for you in Jesus name. Abeg, try dey pray wella and fast. Mini-awhyla, send me pm make we word. Oga nko?
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody:
Onego:
See me see gobe o, I get somebody wen I dey teach her children for private lesson before na so she ask me make I stop, when coro start o, so some days back she call me ask how I dey I tell her fine o, she ask say how I dey cope, na so I tell her say na God dey keep me, so she say okay say make I come her house say at least she get something for me and say the kids go like see me, so when I get close to their house na so she call me say she no want visitors o, but I go fit see them through the window oo, just imagine o
Which kain woman be that? I sabi say she dey fear coro, but na she say make u come na. She for still allow u enter but she for just maintain the distance
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 11:40am On May 14, 2020
JeffreyD1:
No ooo

I stopped where them de ask for my neighbor number
Ur neighbour number ke? smiley
U for kukuma give dem sha. Dem set for their doings. Dem don hep plenty drivers get job for Lagos. Make u try complete the form
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by bjprodint(f): 11:55am On May 14, 2020
OcVoice:
Nothing do you madam. Every go set wella for you in Jesus name. Abeg, try dey pray wella and fast. Mini-awhyla, send me pm make we word. Oga nko?
09032756718 abeg whatapp me
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by ogashman(m): 12:08pm On May 14, 2020
OcVoice:
I no see your pm o. I suppose see the pm alert from my page. Try send am again abeg
I jus resend am again boss

my mail: chrisakajiofor@gmail.com
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 12:11pm On May 14, 2020
ogashman:
I jus resend am again boss

my mail: chrisakajiofor@gmail.com
I don reply you. Check ya mail
Re: Pidgin English Zone: Come Yarn Ya Mind! Wetin Be Ya Problem? by Nobody: 12:12pm On May 14, 2020
bjprodint:
09032756718 abeg whatapp me
I no dey do WhatsApp o. No vex abeg. Just try send me pm from here
1 2 Reply

Why Do Nigerian Parents See Pidgin English As "Bad English"?Una Wey Una Mama No Born Plenty Pikin No Know Wetin God Do For Una.White Lady Spotted In Wrapper Using Nigerian Grinding Stone And Speaking Pidgin234

It's Our AnniversaryMy Ugly Experience With A House Agent At Ijebu-Ode.Pros And Cons Of Marrying A Single Mother?