dis post don make me laugh die as e remind me of my project defense wahala! Na real gbege I face dat time o. I don tire to dey think of topic wey I go use defend, my brain don scatter finish. Na my guy con tell me say make I check some
project topics for internet. Chai! Na dat advice save my life o!
I con finally do my project about how social media dey affect students performance (funny thing be say na Facebook I dey use waste time sef when I suppose dey do di project -u know naa , normal normal levels). But di matter wey burst my brain pass na wen one lecturer for defense panel ask me why I choose dis topic. My mouth just open before my brain work, I con tell am say 'Na Instagram make me fail three course!' Di whole room con dey laugh, but no wahala - I still pass well well!