₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,197 members, 8,420,766 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 10:52 AM

Toggle theme

Tumaraya's Posts

Nairaland ForumTumaraya's ProfileTumaraya's Posts

1 2 3 (of 3 pages)

LiteratureRe: The Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op): 10:47pm On Sep 22, 2014
(Part 5)RAPID EFFECTS!!_________________________________________

The next day, we go see my mumsy. Segun and me kneel down beg her ask for her forgiveness. After small cry cry and Emotional yeye, na him my mama accept us. But on the condition say when I born , I go finish school.

Segun tell her say that one no be problem at all, before segun come give her the Expensive wrapper wey him buy for her, but she tell am say, she go collect am , when him come marry me well.

My mama bless us, tell me say she dey happy for me , say at least my man stand by me, unlike she wey her man abandon her and her pikin. Na him she begin cry again. Mama sef.

Next month fast com maybe na because I dey enjoy. I just dey fresh up dey fine dey go. I come quit to smoke igbo. Anytime e hungry me, I go drive go kentucky go chew fried chicken. No be say e too far from us sha as a matter of fact e dey very much Trekkable, But segun no one hear say I trek,

As segun been don Teach Me How to drive . And I fast learn Because the Car na Automatic.
Once'Once, I dey give my former classmates lift wen I see dem. I know say Dem go don hear wetin dey sup, anytime I give them lift dem no dey fit hide the Envy from their eyes.

Omo life sweet , and I never turn 19 yet. But I look mature sha. But Y things dey go fast like this na?

Yes, I admit. I dark com pretty die, get natural endowment from oluwa for front and for back, I be the type wey if I pass guys must say wow!!!, for the Kind ass wey I gather. And now wey I come even Get belle sef, e dey like say the Beauty and endowment come enhance.
But then I dey see other very pretty and Endowed girls, dark, fair , chocolate etc, wey no get this kind luck, abi na Blessing wey I get.

My only prayer now na make this Segun trip succeed , and make him come back make we live happily ever after.

Playplay, playplay e don dey reach a few days to when my Love go depart.
I don dey get sad feelings Yes , I know say Money no go be my problem. Segun don make me the Sole signatory to the 3 million naira worth account , and I get toyota camry automatic, and we don park from Boys Quarters to the Main flat, since the Oga no dey Again.. Wey him godfather been dey stay before e leave naija. But I go miss my segun touch. I don dey so addicted to my Man touch to the Extent say other men look like dust bin for my eyes. Since I know am, men still dey approach me on a regular basis But I dey give them the perfect snub, and e no tay before my reputation for the Town na arrogant and snobbish young lady, but if you know me , you go no say I no send.

The Day way one Lasu Guy threathen me say e go deal with me for insulting am. As I tell segun, the Next week the Guy see me dey apologise say e no know say I be segun Wife.
Na there I take fear segun, But me I no suspect say him dey deal on drugs, I just think say maybe him dey work somewhere . And e no occur to my childish brain to ask.
Yet when segun use play play take call me smallie, I go vex for am, till him carry me pet me den feed me.
Meanwhile Next month august 20th go make segun 29.
But if you no look my face too much, u go fit easily mistake me for 25year old, because I get matured body. Na only My face dey betray my real status as an original small girl, give people.

Everyday closer to the Day when segun go depart dey make the realities of the Dangers wey dey involved in the trip more glaring. Getting to Two days to segun departure , the fear wey I dey fear since come dey too much, I no fit bear am again. I just wake up around two that night begin dey cry, dey beg segun make e abandon that deal, say I dream say dem catch am. I beg am with all my woman emotion say make e no go, with tears for my eye.
"You could start a legal business or something with the 3million naira , and the business will work out, it will grow"

Although him say him been don make trip once before and him succeed , say him get experience, I still dey fear. Na this kind business wey 20years experience dey backfire na!! Haba!!

Segun no talk, e just hold me, pet me till I calm down.
"Promise me, you'll cancel the trip?"

Him just smooch my back , kiss me for forehead.
"Don't worry, we'll talk about it tommorow."
I resume my cry'cry again, him sef him resume him pet'pet again. Na so we dey till I sleep, Before him too sleep.
This segun too dey patient with me!!. Abi wetin you think?

I wake up around 8am, segun no dey house, I just see toast bread , jam, and ommlette, wey e prepare for me for table, with a jar of tea.

Na wa o, every time , this segun go dey treat me like say e toast me new. And this na our 6th month now. Who know where e don go now? na wetin I dey wonder as I dey eat my food.
LiteratureRe: The Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op): 10:39pm On Sep 22, 2014
(Part 4)RENDEZVOUS____________________________________________

Na so me and Segun rendezvous turn to routine. Everyday after school , I go go take banana till I go yo, or if I no take banana , we go just dey together dey play love, or we go go eatery or segun go cook for me. Na so e dey spoil me with Gifts and money, na me go dey bother myself how I go hide the plenty gifts from my mama.

Two weeks later.
Na so segun, come teach me how to smoke igbo.
"Drag it, take in the smoke,sieve out the raw smoke , and puff it out." I follow him instruction , I high, we make love , and for the First time , I allow segun prack my precious bum bum. Since then I come dey practice weed before sex, and I dey enjoy am.

For the next 5 months wey I dey hang out with segun, na so
My performance for school don dey drop down like Nigeria performance for senior team. But I dey care less.

Then two weeks after my canoe suppose leak, e no even leak..
I still dey wait for am.

Abi I don get belle.
I wonder.

my mama halla my name from palour .
"Bisiii"
I answer "ma!"

I wan talk to you about something.
"Wetin that thing fit be?"

"The Guilty are always afraid" I no be exception..

As I call segun , make him com pick me up, say my mama don pursue me for house, e no reach 10minutes, e land, carry all my things. We drive go him house.

As e dey pour juice for me to drink, e dey ask me "what happened"

Na him I explain everything.

How my mama, call me tell me say she notice some changes ,for my body , and general attitude, and Besides She notice say I no see my period last month. Say make I tell her the Truth weda I don get Belle??.

Segun come ask me .
"And What did you tell her?"

"I told her , I don't know if I'm pregnant, and then she attempted to slap me, but I resisted, after which there was a little physical struggle between us. And then she announced that, since I had grown bigger than her, I could as well get outside her roof."

"You shouldn't have fought your mum"

"you shouldn't have introduced me to GEM, ever since I had that thing, I've grown so fearless and out of control."

"I was high when I introduced you to GEM, But you have to stop it now that you're carrying my baby"

Na him I look Segun one kind eye, I com snap.
"Its too late to stop it, and how are you sure am pregnant, even if i am , I'm gonna abort it."

Na so segun just, charge say make I no even try am.
"Don't say that again!! Remove whose child? My Child? Don't even think of it"

I just dey look am.

" What you need is a good nyte rest, no banana for you today.(Him smile for him joke)
Tomorrow we'll go for a pregnancy test."

Na so him carry me put for bed, cover me Blanket.
Him don dey pet me too much already.

I gats remind am.
"We're not sure if I'm pregnant yet!!"

Him just laf. Tell me Goodnyte.
I close my eyes to please am, but I no sleep.

I just dey think about the Quarrel wey I get with my mama, I regret am. All my 18years of life I grow without male influence, I no dey even relate with guys for primary school. For secondary na strictly girls school I go. Na Segun be the Only Guy wey I don really dey close to. And I don love am die.

And because of me segun don pursue all him other girl friends, na only me e dey respect. Segun wey I go slap when him girlfriends call me to threaten me, e no go retaliate, no be say I never see where e beat woman before. E don Train jack and Robin, to even fear me pass am.

And today wey I tell am say I fit likely get belle for am, e dey very happy about the news. But no be so my mama tell me say men be o.

Any way till tommorow sha, when I do the Test.

(Part 4:2)CENTER OF A MAN'S WORLD______________________________

See as Segun , dey happy dey pop champagne, Because doctor Tell am say I dey pregnant. E just dey jump up and Down. Dey kiss me.
While me I dey find way to tell am say, I wan comot the Pikin, say I wan Go school, and I wan enjoy my Young age.

When him calm down na im I tell am my mind.
"Segun , I'm not quite ready for a Child now, I think we should get rid of it."

Segun balance him eye , look me well.
" Baby, neither was I ready for a child, but now that he's here, he's our blood, we can't commit such atrocity."

See this guy o, him don assume say na Boy I go born already.
Infact I don decide to comot am on my own. Me I wan finish my Education.

Like say segun know wetin I dey think . Him just tell me say.
"My dear school doesn't matter if you got the Money, afterall you can speak fluent english better than most graduates. Myself I was rusticated from school at three hundred level. But today I live better than most of my counterparts, and don't you even think of doing any thing stupid. If not I'll hate you so much, and I swear you don't want to have me as a Hater."

I look my segun eye, omo e don red. This Segun guy dangerous sha o.

To change the Topic, I come ask am say segun "I've never really asked you, what do you do for a living?"

Segun laugh.
"I like that! now you're talking like a responsible mother, then the Next thing I want you to do for me , is to avoid smoking, at least while you're carrying my baby."

"That doesn't answer my question."

Segun come wear serious look.
Wetin segun come tell me afterwards shock me to my Bone Marrow!!! Guess wetin segun dey work??

"What I'm about to tell you now is a top secret, I'm trusting you because you're now part of me. We have a Future together, and most importantly because I love you."

Na so I set my ear to hear story , like where dem dey set football to play penalty.

Segun come continue.
"I'm a local dealer of Hard Drugs. Cocaine and Heroine precisely, I supply hard drugs to rich and Famous people here in Lagos, And right now. I've been in the Business close to three years now, and I'm having about 3million naira in my account. But in Lagos 3 million naira does not make a Man, not now that I'm about to be a father... The man who stays in that main flat is my GodFather and you rarely see him because he's a Wanted Man, so he's strictly in hiding."

My mouth open for surprise !!! Oboi!!
No wonder , many things dey mysterious about that other flat, so tay since I dey come here i never see the so called occupants of the Other flat. Segun supposed boss and the owner of the Car segun dey drive.

"I've managed to secure my boss' get away from this country, which was a huge risk. and to reward me, he's linked me up to this perfect deal, that will involve me going on a cocaine trip to germany next month, and return in three weeks time.

Baby ,when I make that deal , By Gods Grace , we'll be super rich , and I'll invest in the oil sector.
I'll get you fast cars , and Diamond jewelries , you'll have nothing to do, than enjoy your pretty self and take care of my baby boy.
Tomorrow, we'd go and See your mum, so she'll know me. Then I'll hand over the Account here in Nigeria to you, and the Car my boss left for me ,before I travel. All you have to do for me my baby , is just sit and Enjoy yourself , and be comfortable till I come back in three weeks time."

Water comot for yemi alade body, but me na my eyes e come out from.

"Segun don't go, you could get caught"

Segun hug me draw me closer to am,
"No baby , this deal is too perfect , I've never seen anything more perfect before. I can never go wrong on this one. All security systems are in perfect sync with this syndicate. But that doesn't mean I don't have my Plan B, as always, I do. But I assure you that I'll not have to use a plan B, because nothing will go wrong."

I no get choice than to believe my man.
LiteratureRe: The Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op): 10:27pm On Sep 22, 2014
(Part 3) LOVESICK_____________________________________

The Next day as I wake up, I feel pains for my head, and my Groin and thigh area, coupled with my mouth wey dey smell, as I no brush for night before I sleep.

"Omo mi, you dey well so? My Mama ask me.

"Mum, I'm not sure."

"You say?"
I no dey like to talk loud and Clear , when I know say my mouth dey smell, that na how I dey, I no dey play with my oral health.

"I said I'm not sure" I sound am more louder this time, without letting air out of my mouth.

"Yesterday when I come back from market, I see you dey sleep, and you never sleep so early before, na so I touch your body, e too hot" I come go buy this drugs for you."
My mama offer me satchet of mixed drugs.

I look am with drunken master eye before I collect am Drop am ontop the locker.

I look time , na 8 o'clock, I don late for school self.
I stand up go bathroom. As I dey baf, I hear mama tell me Say, she don dey go market say if I no feel fine make I no bother to come " na then I come realise say na saturday. I come dey relieved.


That means tomorrow, na sunday, 6th of april, my 18th Birthday, na wa o, e no go easy.


"Water no get enemy o", as I baf finish see as I come feel refreshed, headache go, fever go. Only thing wey water power no reach wipe , na memories of yesterday wey still dey me like dream for eye.

As I go parlour, I see 500 naira for table wey mama drop for me.

No light , so I just sit down, just dey bored. If to say the phone dey here I for probably dey press am. But i leave the phone for segun house yesterday. I see am , but I purposely leave am, and I guess him don forget. Abi him no purposely wan give me again??

The Next tin be say I come dey feel so uneasy. So so uneasy. I come dey miss segun like so bad, memories of yesterday banging come dey replay for my Brain.

I miss replay sotay , I come wet.

As I don miss segun too much already, I say make I go see nkechi my class mate for the Next street, before the missing get out of hand. as I reach main road, na segun, I just dey see, as e dey come out from the toyota camry wen him drive come drop me last night.

For my mind I be like "see my prince charming". But I just dey speechless.

As him just come meet me, " I mean no harm, I came to bring your phone."

I still dey look am as e stretch him hand dey offer me the phone. We dey like that for almost a minute before him come break the silence.

"Ok, I'll be going. I can understand if you don't want anything to do with me." Him come turn to go back.

I no know wetin enter me, I no even send say na my area I dey, although , I be snobbish girl wey no dey send right from time."

I just scream " no! segun, don't go!"

Na so I run go hug am, start to dey cry. Him self him com hold me "I'm sorry , if I hurt you my angel"

Me I just reply.
"Don't ever leave me Segun."

Na so we drive go the promise, him buy salad and chicken, we drive go house , him feed me like small pikin, after I eat finish , him give me that him Banana again. You know the Kind banana na? Abi make I explain?

As we dey bed, I just whisper give am.
"Tomorrow is my birthday"
Him happy ,com ask me say.
"Wow! Really??, how old would you be"

"18"

"So how's it gonna Be , a party , or something"

"No we don't do that, my mum is Jehovah witness."

"I see, But I segun, your husband, is not jehovah witness, so I and you will celebrate it" na so him kiss me, as we begin laf. " Him come tell me say him go surprise me.

Sunday reach, after church me and my mama dey relax with a nigerian movie, b4 I com tell her say I wan go see nkechi , next street, na so I take taxi go meet segun. As I see am for him room, e just dey like say them fix one missing nut for my head. I just go hug am, sit down for him laps. Him just tip my nose we come laf.

"See how pretty you look wen you laf, you're such a treasure to behold, my dark beauty."

I just blush. To change topic na, I come say "I keep forgetting my phone. yesterday I forgot it again."

Segun just smile that him mischievious smile.

"Its no longer your phone."

I come dey puzzled , come reply,

"I don't get"

Na so segun give me one parcel come order me with him rough voice.
"Open it."

As I open the Thing impatiently. I first see glittering Gold Female Wristwatch , then Necklace, then as I still dey admire that one , I still dey feel something thick and Rectangular, as I probe further . Wetin I see na Blackberry Bold 6.
OMG!!!!


Now as a girl wey dey read this stuff, if na You , you no go like segunhuh<3<3

That day, I give am for every where. Mouth, b**bs, p**sy, na Only yansh , I no gree give my random segun invade.

Segun too like my bum bum , I no know why. Na because e bighuh =-? .
LiteratureRe: The Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op):
(Part 2)SEGUN THE COMPASS BOY_____________________________________

As I enter the Gate, the Compound neat, I see one Big flat , then a line of Boys Quarters wey dey adacent to the flat, na the First room for the Boys Quarters na im segun enter. I stand outside, him beckon on me to come inside, after some hesitation, I enter.
Mhen , the Room fine , e dey Tiled, and AC dey, Home theatre dey, freezer dey, wine chamber dey, Big samsung flat Screen Hang for the Wall, and na 60inches , The Foam dey dressed up, And the Center table get Wooden artwork.

As I stand dey look like Novice, I just dey wish say we house for surelere fit get swag like segun room,
na im segun say "baby sit down, " like robot wey dem hypnotise I just sit down. Breath in the Fresh scent of the room. This segun na real compass Boy.
Una notice say since when I know am , I don dey change direction pass Okada.

Segun just go Open freezer omo na 'The Promise fast food' bag, him withraw from the Fridge , and Guess what, as him open am the Scent of fried chicken disorganize my entire body system , I swallow. Remember say I never eat since I return from school.

Segun just arrange the full chicken inside one fancy plate wey him collect.

"Please can I have the Charger , I have to start going now"

Segun look me with one kind soft eye.

" I'll never forgive myself if I let you go like this,looking so stressed up ,and I know you must be feeling really hungry at this point. You look it already. So just take your time, eat your food, and I'll drop you off with my boss car, I don't want you to remember me as a bad guy , since its the last time you're going to see me.

You remember our deal?"


My face change as I nod my head small .
I no come dey sure, weda I no one see Segun again. Na wa o.

I no know weather segun know say, I go dey shy if him dey look me as I dey chew. But the next thing be say him just go kak for the Other side of the Room. Lie down dey press him phone. Meanwhile him don collect my phone dey charge for one available socket for the Room.

As I dey chew my Chicken with Girlish integrity.

Segun just go kak dey play game for him screen touch phone.

Na so I chop chicken' chop chicken so tay, I tire .

Come drink orange juice. Come Carry the Rope wey dey there , begin floss, as I floss finish. Na him I turn to tell segun thank you.

As I turn, guess wetin I take my eyes see!!!!!!!!!

segun don naked . Omo see gobe.

As I dey speechless dey look segun body, in shock and embarrassment, segun just casually ask me "are you thru" I wan talk , words no come out, my mouth just make movement.

Segun, just stand up waka come clear the Plates . As e dey clear am, e still naked o and I no know why him unclothedness dey affect my insides.
Brief images from the Blue film wey I watch just filter across my brain. next tin I remember na Segun just grab my pointed breast begin dey squeeze my nipples wey don stiff already. That rain wey been threaten before come begin fall, so all my pants soak. Him Begin dey Kiss me, den him transfer go my Bum bum, dey squeeze am too. I no know how I take join am for him naked world, But the Next thing be sey my legs dey high up and Open as I grab am, while him dey inside me.

I dey feel both pains and pleasure, but na The pleasure plenty Pass.

If to say dem tell me say I after I chop my chicken , I go take banana till I yo.
I for no believe.

One of my favourite songs na, "all I do is win" by D khaled.. But today I don lose my Virginity. So I begin cry. Segun pet me'pet me'pet me. E no work. I slap am three times wen e try to touch me. Him just kak dey look me. As I sit down use the bloodstained sheets take cover myself.

Na so we dey till around 8.00pm.
I know say I don late but I no care.

"I want to have my bath." I just talk like say na whisper I dey whisper.

Like say e dey wait for me to talk since, e just answer sharp sharp.

"I'll lead you to the Bathroom right away."

Na so I baff, him com drive me come reach my house for surulere.
As I enter , fortunately for me, my mama never come back.
On very very rare occasions She dey late like that sha due to lagos hold up.

Na So I just go straight go sleep, she get her own spare key when she come she go enter.

That night I dream , guess who I dream of??

Na Still Segun still waka Come Give me him Banana for my dream.
LiteratureRe: The Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op):
THE RISE AND FALL OF CARO SOFTS.

(Part 1)THE DEVIL'S GIFT. _____________________________________________

My name na Caroline,and without much ado' about a creative start, I wan yarn una the story of my life.

And that story no go legit if I no talk about segun.

Ah segun! the Bad guy. I meet segun when I dey SS1. Him start to chyke/toast me From S.S1 till I enter SS2, unlike other men, e no give up at all.

At first I no gree for segun, Because My mama don tell me say make I avoid all men, and ever since my papa leave my mama and Me, my mama hate men.

After a long time of coming to our School gate to come chyke/toast me , even to the Extent wey our security man warn am to stop coming to Corrupt the students. Segun still come meet me.

As I come Out from gate with my friends as usual. Na so Him come approach me, all my friends desert me, because dem dey fear am.

"Sweet girl, how are you?"

Me I reply.
"How many times have I told you to stop stalking me?"
I hala am, look am Bad eye, Him come smile.

For my mind , I take note say segun get charming smile, and E sabi dress.
"I'll stop stalking you on one condition"

"I'm not interested in your conditions."

Him smile that him ashawo smile again.

E come reply me.
"Please hear me Out first"

Out of busy body, and Impatience. I snap.
"Say whatever!"


The next thing I see , segun put hand for him pocket , and wetin come out na mobile phone. Not just a mobile phone, na correct mobile phone. Na Nokia C3.


"Take this and Forget about me"B-)

I look segun again, weda e mean am.
The guy mean am o.

After small initial gra gra, I collect the phone carry put for my Bag, after all him say na d condition for him not to dey disturb me. And I get notin to lose.cheesy
Me I no even know small say, nothing goes for Nothing.

As I reach our room and parlour house for surulere . Mama no dey as usual, she don go work. I settle down to check specs and features of my new handset;wink (as my mama dey call am.) After small press press, To my surprise sim card dey inside. Na him I say make I enter the multimedia section. See fine fine music. From there I enter video.

Ahhhhhhhhhhhhhhhhhhhhhh!!!!!!!!!!!!!!!

Guess wetin I take this my eyes seeeeeeee!!!


Plenty Plenty Blue Film.

One mind say, watch!! one mind say delete , one mind say watch and Delete , another mind say if you watch you won't delete.

Na oputa Panel of inquiry dey shelè for my mind.

In my rihanna voice make I tell you say "I've got my own share of curiosity" and na wetin lead my thumbs to Go press play.

As my thumbs click play, na So my eye superglue for my screen dey watch.

See as men with big, medium and small size bànànà dey hammer women for mouth, for p*ssy , even for yansh wey dem dey take shit.

After each video. Na next I dey click kia kia!! From 2'o clock wey I come back from school I dey watch till 4'o'clock.

My Broda and sister. transgender and normal, I wan ask you ,
why Bad tins dey bellefulhuh?
Why bad tins too dey sweet diehuh

Because na for my uniform I dey, I no change, I no remember food. Na just to dey watch!! And I feel comfortable.

Until the phone do low battery beep, and the screen show me "video can no longer be played to conserve energy"

Na there my sense return back to normal.

Oya Guess wetin I discover!!!!!!!!!!!!

I no know , where the Rain from come!!:/ But all my pants don soak!!!

Even rihanna umbrella for nor fit prevent this soak.

Kpa kpa kpa! I rush enter bathroom, to change make I go chop, for bathroom one tin led to another , I begin finger myself.
I begin feel sweet sensations, from in between my legs.

As I finish baf, the phone ring.
For my mind I be like "this one wey this phone low so, I go fit receive call , and besides who dey call me for this Line wey nobody don know yet."

As I pick the Call.
I no fit mistake that voice.
.
.
Na Segun!!!
"Caro its me segun, I forgot to Give You The charger , just take a Taxi drop to No 1 dokpesi Street , festac and Just Call Me. There is Credit in The phone , I'll come out and Give you your charger And Pay your Taxi Bill, both To and Fro. Please be fast , I'm going out in the Next twenty Minutes."

Segun hang up.

The Call take me unaware and E no even reach 15 seconds ,so e no give me Time to accept or reject.

One mind say "go", one mind say "no go, remember this is Lagos, and Anything Can Happen", another mind say "Go you will return Safely" another mind say "na only you waka Come"

In my rihanna voice again "I've got my fair share of the Notorious Human Curiosity Trait" So I com decide to Go.

Just then Nepa Bring Light , our radio come to Life , na Tuface song just dey Finish for Cool FM. "Enter the Place, make we see if you no go carry Belle!"

For my mind , I be like "tubaba you don Spoil!! , you too Born!! And You Hand some!!"

surulere to festac , na Few minutes journey so I no bother to chop, since I go come back sharp'sharp, so I take taxi and before I know we don reach.

If nokia na wrestler , e for Be undertaker the Dead man , I talk so because e go dey Show you Red Bar like say E don Die, e go dey Beep'dey beep'dey beep, But (in my dbanj Voice) "don't Get it twisted ."It'll never die"

As soon as I reach the gate, the same Red bar na im I take call segun.
"I'm at your Gate."

Segun no come out ooo, for a long time, the driver face don dey Bone Pass biscuit Bone.

"Oh girl, as you fine like this E be like say you no like am ni?
You want make I wooze you slap , before you know say you dey waste my time ni??
Abi o' ya werey ni??(Abi you dey craze)"

Fear don enter my mind , and I wan Beg, but him halla me.
"You no no know say this is Lagos , and every seconds Count , abi you be learner ni?"

My Taxi Driver temper don boil pass boiling point , no socket , but the Guy don dey fully charged, and him eye don red, he don come out from motto , e don clench fist, E don dey come towards me.

Fear don full my Mind, I wan cry, for my mind , I be like "oh 'Lord, who send Me?? Oh Lord, let this Cup pass over me !"
As him dey near me, na so I just close my eyes dey expect the Beating wey go reach me.
na im I hear series of heavy roars wey dey like thunder.
For my mind I be like. "Na the Slap wey sound like that?? Which time Slap begin dey sound like that, and How come I no feel anything for my Face, abi I don die Go heaven??"

If so make I open my eye see as heaven be na, as I open my eye, na segun and two big hefty German shepherds for him left and Right I see. Omo see dogs!!!

For my mind I be like "oh thank God, at last!!"
Na so segun begin dey halla for the Taxi driver . The driver just dey beg say " Ejo ema Binu sa(abeg no vex sir)"
See fear for the Coward driver Eye.

I no blame the driver sha, those dogs Dey like Hungry lions wey resemble Dog.
At that moment I come dey so proud of this thick muscular Segun Guy. See him fine Muscle as e dey show from him Sleeveless White top.
Tattoo wey dey for him upper arms na tupac shakur with weed for him mouth, for my mind , I be like "this segun rugged sha o."

Na so segun throw the Driver money for am, come halla say "get out of this premises" the Driver Pick him Money enter him motor Zoom off sharp sharp!"

"My angel, I hope he didn't touch you??"

I look segun, look the Dogs.

Na Im segun smile , I see say him get slight open teeth.
"Oh!! You're not comfortable with jack and Robin?" I still no talk.

Na him segun look down at the Two dogs, although them almost be our Heights, Go inside and Stay at the Cage, "the Two lions/dog just Obediently Go inside.
"And stay calm!!"

The dogs just growl, like say dem dey talk "yes sir!!"

Oh boy, my respect for segun Add bar sha.
And my admiration for am don dey top the charts.

But then, I be girl , and I gats Form.
"Na him I come get mouth ,come snap say "you're asking me if he touched me?? If you had come Out as soon as I called you , would it has gotten to this."(With my last born , teary voice, I come say)" you probably wanted me to die here!!"

Wetin happen next na wetin I no even expect.
Segun just hug Me affectionately and unexpectedly come dey rub my Bum bum.

If na Stella damascus dey explain, she for probably say "it was too fast for me to have offered any form of resistance."
Segun just dey whisper say.
"My Angel you know, I would Never let you die, I"m sorry, I didn't mean to Hurt you"

That rain wey been fall inside my pant that time, e threaten again with one drop. Before Segun Come leave me.

For like 2 minutes, I nor fit talk or look up, na ground I dey look, like say I wan supervise the Road wey Julius Berger Do.

Na then I come notice say I even tall pass segun.

The next thing wey I talk na.
"Please get me a taxi, I need to Get Going now, its getting late."

"Won't you collect the Charger again??"

I stretch out my hand to collect am, I still dey look another place.

"Its. Inside, come And Take it ,so that you'll start going, its past 6 already and I'm late , him leave me Dey Enter gate."

I no get choice , na him hold transport , na him hold Charger.

As I take first step to Follow am, na Him My nokia beep.
I look , na message from 4100 "text 419, to Use P'square's 'DANGER/WAHALA DEY' as Your Caller Tunez.

I press The Red button. Put the Phone For My pocket.
I no know say wahala and Danger really dey wait for me!!
LiteratureThe Rise And Fall Of Carosofts(Complete story By Tumaraya) by tumaraya(op):
I retain all copyrights to this story.
I wrote it sometime ago and decided to share it with you guys.

The story is written in pidgin, for no other reason (and I'm proud to say )than , pidgin remains the quickest language I can use in expression.

I needed to ease myself off the inspirations in my head, and pidgin was the only language I could run to, because I had to finish this story up in one day, because anything other than a day, then I'd have grown lackadaisical about the story, and probably wouldn't have finished it in the end. Its a short story. Although comic, but also there's a handful of lessons to learn.

Your comments as well as your criticism are welcome, but won't be a criteria for postponing the quick conclusion of the story , this means that I'd not be keeping you guys in suspense in exchange for comments, and I'll be done with this story in approximately 3 days, even if there isn't a single comment of encouragement. I'd just be satisfied with the Knowledge that someone out there enjoyed the story, because I know someone will.
What's more , the story is a work of fiction although I made use of real life references here and there. And talking about what else I made use of.

I consciously made use of what I describe as 'exaggerated realism'. Which basically means pseudo-realistic/ exaggerated descriptions of certain plots here and there, essentially for comic purposes.

As we all know pidgin english is a Language of exaggeration. "If I slap you , you go see stars!" Is an example. please don't speak pidgin to a klepto, because ,they take things literally. Lol. Just kidding.. Only intellectuals understand the above humor though.
Thanks for this platform.
And the story begins..
.
.
EDITED::

It dawned on me that some slangs and pidgin terms used in this piece might be too extreme for some of you to understand.

Please bare with this ghetto kid, and just try to understand it in Context of the sentence in which it is been used. Thanks.

.

.
Repitition of certain words follow the pidgin english style and tone of stressing and emphasis eg, 'cry cry' Implies someone who cries too much. Same way 'play play' implies someone who takes too many things for granted.

Sorry for any inconveniences if you're not too into pidgin.
LiteratureRe: False Pretenses <1ST POSITION, ROMANCE STORY OF THE YEAR AWARD, 2013> by tumaraya: 6:15pm On Sep 07, 2014
When Will this wonderful be Complete nao. Pls Repogirl do Something.
1 Like
LiteratureRe: Unfulfilled Promises By Audrey Timms by tumaraya: 11:20pm On Aug 31, 2014
Thank you Audrey. God Bless you Immensely. And Replenish your source of inspiration. you will continue to soar higher my dear. What a wonderful Piece!!
CelebritiesRe: Tributes To Pro. Dora Akunyili From Nairalanders. by tumaraya: 7:51pm On Aug 28, 2014
RIP MA. You continue to Live on in your Legacies.
LiteratureRe: Unfulfilled Promises By Audrey Timms by tumaraya: 5:06pm On Aug 18, 2014
I think Dave is Impotent. That Guy, as Described once in this Wonderful. Novel is a "Silent Volcano waiting to Erupt" he's Definitely Hiding Something , that, I'm a 102 percent Sure. I wouldn't For the World Marry Somebody as Suicidal as Dave. Wonderful Story madam Audrey. Thanks.
1 Like

1 2 3 (of 3 pages)