Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,259 members, 7,829,515 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 08:21 AM

Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) (1492 Views)

The Saviour I : The Adventures of Athanasius. / Free E Novel: The Adventures Of Sherlock Holmes By Sir Arthur Conan Doyle / Jonny Kennedy:the Story Of The Boy Whose Skin Fell Off. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) by wordwrapper: 2:23pm On Aug 08, 2012
My people, i wan tell una one tori
about one girl dem dey call moni
One day i dey go for journey
I enta bus, i no get money

conduct ask me, 'wey yua money?'
i say e dey for warri
na so one girl for back talk say make i no worri
I smile thank God say she go pay for me

I look d girl for eye
Ahh..she fine die
na so i shine my eye
she sef shine her eye

wen we reach satellite town
na hin everybody come down
she commot bus begin dey shout
Conductor I born six pikin oo
Oya Titi, Tayo, Dele, Kemi, Gbenga, Ayo
make una come down

na im I begin dey wonda
the girl fine and I want am
I look my fone battery na just one bar
Anyhow sha I still ask for im number

but d ting be say she don born plenty
and I know say she go dey around twenty
or maybe twenty-something
anyway, no long tin

ol boy now kno wetin to do
one man shout, "nothing do you!"
conductor and d rest just dey skata laff
me sef tell dem "make una go baff!...hiss"

later 4 nite, she call my phone
I tell am say, ol girl u hot
she talk say "but u too short"
I tell am say na long story, I short but I no short

I ax moni say dose pikin na yua own?
she tell me say wetin be my own?
say make I just bone

But I remember as she fine reach
And she pay my bus money no mean say she rich
but she dey nice and she no behave like bitch

I come beg am say make she no vex
say na her house I dey come visit next
I ask am say wetin be her address
say I dey come see her, make she wear nice dress

...LoL...t o b e c o n t i n u e d
Re: Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) by lammygaga(f): 4:15pm On Aug 08, 2012
Nice piece I found myself laughing till the very end...
Re: Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) by lammygaga(f): 4:15pm On Aug 08, 2012
Nice piece I found myself smiling till the very end...
Re: Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) by wordwrapper: 3:41pm On Aug 15, 2012
Moni ask me say wen make she dey expect
I tell Moni say when we jam, she go respect
Say when I dey school, I be woman-prefect
I tell am say I go show am say na me be the original Mr Perfect
I ask am say hope she no get any defect?

As I reach Moni house
she talk say make I feel comfortable
I siddon on top table
I laugh for my mind, she think say I bin disable

Na so Moni PaPa shout, "Who dey dia?"
Sharp-Sharp, I siddon 4 chair
I just dey shake, omo na fear fear

I talk say Sir, my name na Johny
I come do extra lesson with Moni
Na me dey teach am biology

Moni PaPa ask, wetin b yua full name?
I say, PaPa, I no fit say am, I dey shame
PaPa say, U dey crase? I say wetin be yua full name?
I come tell am say the name na JOHNNY-WOWO-PIKIN

Na him papa begin dey scatta laff
Him teeth be like say e get accident with DAF
Some no dey, some na half
Na so me sef begin dey follow laff

Na so Moni papa enter him room
Him commot begin dey shout today na ur day of doom
Oya take this broom wey get juju
Oya begin dey sweep like mumu

Me as a sharp boy with plenty odieshi
I collect broom begin dey sing
I sweep reach their gate
I come dey think, ol boy I no want make dis matter complicate

I run sote the back of my leg dey touch my neck
Even danfo no fit catch me
Next time una see fine girl, na sofi-sofri o
Re: Adventures Of Jonny (free-write-rhyme) by wordwrapper: 3:42pm On Aug 15, 2012
lammygaga: Nice piece I found myself smiling till the very end...

Thanks Lammygaga!!

(1) (Reply)

The 28th House (fiction, Horror And Thriller) / Tears Dropped In My Eyes When I Saw This / Hillary Clinton Twitter Bio Saga: Chimamanda Adichie Finally Reacts To Criticism

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.