Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,159,236 members, 7,839,255 topics. Date: Friday, 24 May 2024 at 03:44 PM

Manchesta City Beta Pass United-mancini - European Football (EPL, UEFA, La Liga) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / European Football (EPL, UEFA, La Liga) / Manchesta City Beta Pass United-mancini (561 Views)

PHOTO - Balotelli And Mancini Involved In Training Ground Bust / Balotelli And Mancini In Training Ground Fight / Inter Milan coach Mancini: I'd love to sign Ronaldo (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Manchesta City Beta Pass United-mancini by Livermeka: 6:16pm On Dec 15, 2012
Manchesta Citi coachee Roberto Mancini don talk say dem beta pass United and dem get plenti time to wash comot d six point wet United take gap dem.

Citi dem bib suffa dem fess loss dis season wen dem nebo bit dem 3-2 for Etihad dis Sunday wey pass.

Mancini say no shaking lai lai, six point no be anytin for im side afta na 8 point United take gap dem last seasin befor dem waka pass dem go carry d Lig.

Im no efen worri sef, as per d way wey dem play wen dem bin lose 3-2 for United hand, come talk say d confido wey im get d way im boys play United to make am bilif say dem beta pass Sir Alex tim.

Mancini come tell im players say make dem cari d same confido wey im get go wound United wen dem go mit.

" Na my mind be dat oh! We don show say we sabi ball pass United" Mancini talk.

D man wey be from Italo, bilif say now wey dem no go play Europe match again, space go dey, players dem go dey fresh, match no go too plenti, no be like United wey get plenti match for dem head.

For we side oh, we go dey train hard hard, and wen Februari reach and Champion Lig start, things fit change.

Citi dem go play Newcastle for Saturday, before dem go face Reading, Sunderland, Norwich and Stoke for Crismas and New Year time.

Mancini players dem get injuri and d man feel say dem gast to elevate if dem go reach anywhere.

" We get like 23 or 24 match before seain finish and d 6 point sef no be anytin, no shaking at al.

Mancini wahala go inkris by d time dem ogbonge midufilda Yaya Toure waka go South Afrika for d Nation Cup, i no go lie, we go miss Yaya, im na chairman for our team, e be like na afta d Watford match im go waka, but d oda players dem go step up be dat.

e go hard for am becos Balotelli dey misbehave and im kaptain Kompany sef get small gbege for im leg. Gareth Barry sef no well, but Mancini talk say efritin go betta even though im no happy wit all d yeye gist wey pipul dey carri say kasala dey dem dressin room.

"Notin like dat dey, we solid oh, we dey kampe, notin do us, our own na to just play betta ball clean d six point comot for blackbod" Mancini tell repoters dem.


© supersport.com

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121215/City_beta_pass_UnitedMancini
Re: Manchesta City Beta Pass United-mancini by Emusan(m): 6:29pm On Dec 15, 2012
Yeye man na dat unbeatng dey pain nam as Man u don stop im team

(1) (Reply)

English Premier League Transfer Talks: All The Clubs Gossips / Will Real Madrid Win The Ever Elusive LA DECIMA (10th Ucl)this Season? / Luiz Henrique To Suceed Tito Vilanova As Barca Coach

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.