Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,316 members, 7,815,582 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 02:48 PM

Ameobi Don Score Im Fess Gol -hou Una See Am - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Ameobi Don Score Im Fess Gol -hou Una See Am (757 Views)

Since Mikel Don Score,ciroma Chukwuma Adekunle Go Pass Waec Now Abi?? / Emenike, Nsofor, Ameobi Return For Super-Eagles / Ameobi, Mikel, Martins, Apam Listed For Venezuela (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Ameobi Don Score Im Fess Gol -hou Una See Am by Livermeka: 11:08pm On Dec 22, 2012
Ameobi don score im fess gol



Andrew Randa


Shola Ameobi don celebrate d call wey Keshi call am inside d list wey im rilis for d players wey go nack head win shirt for Supa Eagle for d 2013 Afrika Cup of Nation, as im score d gol wey make Newcastle win dier game 1-0 agains Queens Park Rangers for d Barclay Premier Lig for Satuday.

D strika, wey b d numba 3 for line for players wey dey attack for im klub Newcastle afta Demba Ba and Papiss Demba Cisse, bin enta field for 61 minut wen dem comot Cisse, come score d winning gol 10 minut before match finish.

D big strika show korrect tapping, as im score ogbonge goal wit im left leg wey QPR kipa Robert Green bin no get ansa to, from d cross wey Italo defenda Davide Santon gif am.

Na onli 11 time Ameobi don play dis seasin so and d gol wey im score na d fess wey im score dis seasin so.

Ameobi show sef go make National Tim coachee Stephen Keshi jolly as per im put d player name for d list wey im rilis for the Nation Cup wey dem go go play next year for South Afrika.

Na onli one match Shola Ameobi don play for Naija, and na for d friendly match wey Supa Eagle waya Venezuela for Novermber 15.

http://ng.supersport.mobi/football/nigeria-naija/news/121222/Ameobi_don_score_im_fess_gol



© supersport.com

(1) (Reply)

I Was Surprised To See This World Club Ranking Released Today / Liverpoolfc Fans In Nigeria / Is Alex Ferguson Right To Say Gerrard Is Not A Top Player?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 8
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.