Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,757 members, 7,817,092 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 04:53 AM

Funny Story - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Funny Story (2236 Views)

Funny Story - My First Time Weed (igboh) Experience / Joke Of The Day! Read This Funny Story [just For Laughs] / A Profesor And A Sailor. What A Funny Story (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Funny Story by ehvez(m): 11:45pm On Jun 13, 2013
Una need see wetin happen for our
yard today?! E get wan guy for our
yard, the guy name na Okwy. Okwy na
ashawo boy, that boy no dey rest.
Every minute he dey ontop woman. Me
dey my side konji dey wire me. I don beg am tire make he pity me dash me
one chikala sey konji wan change my
surname. I go see nyash wire for dream
but real life I no see anything. Okwy na
guy man, girls like am too much and
the guy no dey dull. E get this girl Philo wey I don dey eye
since but I no get liver to go cast give
the girl the levels wey my love for am
dey. This girl fine pass mammy water,
she yellow like oyibo and her teeth dey
white like fluorescent. This girl from market one dey dey come back wen
she branch enter our yard. I look, na
Okwy room my dream babe dey go. I
wan die, I follow am make I see if dem
go do anything. I reach she and Okwy
dey talk so I go make I comot food wey I put for fire. As I come back I come see
Okwy head dey inside the girl skirt.
Shuu, the guy wan chop pikin wey dey
her belle? I see sey Philo my love dey
hold bed dey shout like sey person
they put iron wey hot inside her nyash. She come dey scream, "Okwy, lick am,
bite am, Okwy chop am". Where I dey
my body begin strong. I still dey peep
tru window dey hold my tin. She push
Okwy for bed begin dey comot Okwy
cloth. She begin lick my guy tin like sey na sweet. She go carry tongue roll
around the thing come lick the cap. I
dey where I dey dey die. She come lift
her skirt come dey touch herself as she
dey lick the guy tin. She come carry all
the guy tin put inside mouth, Okwy begin dey speak in tongues. I no
understand wetin he dey talk wetin I
dey hear na,"mememiamemiamemia"
hmmm.
Okwy begin shout as I dey look them
like sey he dey die, I look come see Philo body dey shake like person wey
electric dey shock. Okwy dey shout,
"Somebody help oh, I don die, I don
die, my thing oh". I come see sey no be
play again I go look, see blood
everywhere. Philo body come still dey shake and foam dey comot for her
mouth. Blood come dey pour like water
from Okwy tin. Philo get epilepsy and
the tin start when she dey suck Okwy
banana. Haaaaaa naso i borrow leg,
come begin cast with solid crest o, my voice ehn, e loud to wake deadbody
sef, trust our yard people with dem
tatafo ear, sharperly dem don gather,
people come run come o, but i say
make i write this give una. I dey come I
go tell una wetin happen later. Okwy sef don faint and people dey try comot
Philo teeth from the guy prick.
Re: Funny Story by nas4q(m): 11:11am On Jun 14, 2013
craZy stuff u gat there, update plz?
Re: Funny Story by dejoca(f): 11:51pm On Jun 25, 2013
Lwcmt! Na die b dat o. Kudos to u,u did wella
9c joke

1 Like

(1) (Reply)

What Would You Do If The Cameraman Forgot To Record On Your Wedding Day? / Biography Of Akpos / Recession Is Really Biting Hard! See What This Man Is Eating

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.