Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,166,858 members, 7,866,311 topics. Date: Thursday, 20 June 2024 at 02:47 PM

Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) (827 Views)

Nigeria Vs Mali. African U23 Championship (3 - 2) On 29th November 2015 / Osaze Odemwingie Completes Move To Cardiff / Yobo Could Be At Cardiff City Next Season (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:04pm On Aug 25, 2013
Na cardiff doormort man city go meet dem so,
d match just dey shelle now now
make una follow me dey go
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:08pm On Aug 25, 2013
dis cardiff boys no wan gree o, dem nearly goal nw o
e bi like sey d malaysia billionaire wey get d team don promise dem big big money o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:16pm On Aug 25, 2013
i no no y way dis cardiff city fans dey booe booe man city o, but cardi boys too dey enter man city post
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by mascot87(m): 4:18pm On Aug 25, 2013
so na u come tanda gidigba for nairaland dey give us the tori of the gbege wey dey shele between Cardiff and mancity. Abeg dey give us the casala wey dey happen cos we dey file up tanda dey watch your tori as them dey take dribble yafunyafun for d field.
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:21pm On Aug 25, 2013
fine fine pass from man city nw nw
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:31pm On Aug 25, 2013
goal never come for any body o
d two team dey play fine fine ball sha
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:35pm On Aug 25, 2013
cardiff city no allow man city to play their style of ball o
e bi like say na borrow po ball man city con dey play
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:44pm On Aug 25, 2013
44 mint no goal yet
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:52pm On Aug 25, 2013
d first laff don pafuka
all dis cardiff boys just dey scarter ball like sey na fufu dem chop come

na God save me self, they shot for nack me for head
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 4:56pm On Aug 25, 2013
mascot87: so na u come tanda gidigba for nairaland dey give us the tori of the gbege wey dey shele between Cardiff and mancity. Abeg dey give us the casala wey dey happen cos we dey file up tanda dey watch your tori as them dey take dribble yafunyafun for d field.
na cardi stadium i dey nw wit my kunu and akara, dey bring una all d echechere tori
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:03pm On Aug 25, 2013
d part 2 don start na
make we see dis part go be
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:11pm On Aug 25, 2013
goaaaaaaaaaaal Dzeco don bulala thick and heavy shot enter cardi net o for 52mint
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:16pm On Aug 25, 2013
jesus don commot, na nasri con enter
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:20pm On Aug 25, 2013
yepaaaaaa, Gunarsson don goal for cardiff o for 60mint , dis one na bad market for man city o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:27pm On Aug 25, 2013
Dzeco don cary blood for nose commot for Negredo to waka come in
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:34pm On Aug 25, 2013
man city wan quench here today o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:37pm On Aug 25, 2013
campbell don goal again for cardiff o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:42pm On Aug 25, 2013
na 5mint remain o, na who go help man city o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:47pm On Aug 25, 2013
campbell don make am 3 for cardiff for 87mint o
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by mascot87(m): 5:47pm On Aug 25, 2013
My guy, u do well. I dey feel u wela for my domot
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:52pm On Aug 25, 2013
Aguiero just nod ball enter nw for city
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by frainc(m): 5:58pm On Aug 25, 2013
i no fit believe my nose say cardiff city bulala man city 3 2

my people na cry i dey cry so
d part 2 don pafuka
Re: Cardiff City Vs Man City 3-2 (half Time) by osymerga(m): 7:52am On Aug 26, 2013
Cfrain c,so u still dey ? Make u kukuma come finish ur tori for Me and Asaba job oooo,b4 wat happen in 1960 will repeat itself oooo.Abi u wan try us ni

(1) (Reply)

Sure Way To Get 8gb On MTN With Proof. / All Brazil 2014 Quarter Finalists Were Group Leaders / Photo Of New Manchester United Home Kit

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.