Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,167,103 members, 7,867,168 topics. Date: Friday, 21 June 2024 at 11:41 AM

Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike (682 Views)

How ASUU Strike turns Female Students Into Prostitutes / Patrick Obahiagbon Blows Grammar On ASUU Strike “paraphlegic Crinkum Crankum” / Lastest Update About ASUU Strike. Uniben To Write Post Ume Bypassing ASUU Strike (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike by Agimor(m): 6:15am On Oct 08, 2013
Oga president,

First of all I hail ooo! I no say you no dey cary last. You be confirm Warri pikin. But your middle name Ebele means mercy and make you pity your children settle their lecturers naa! The matter never tire you? Suppose say your pikin wey you born for belle follow us dey house, Sheeh you for never answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping, militant things and all the bad bad things go enter school, now now na una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us "half-baked", "half-roasted", abi na "half-fried". Na una sabi.

Them talk say person no fit run pass him shadow. We go dey lasgidi dey for you. Na your time be dis use am well, but we go catch you for 2015. You don forget say youths na we dey vote pass. Na we too dey snatch ballot box, dey do rally and some kind kukere things them wey them dey take win election. You go still need our help. That time too we go go strike. Shebi you sabi waka for bare feet, you go carry your leg do your rally. No thugs for you. We no go snatch ballot make you for win. If any maga try am we go fall am.

So Oga Jona, na your opportunity be this ooo. Make you code this stubborn ASUU make dem cary their wahala go back. We no say na rush them go rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam no be who read. Na still who get leg dey get better work. Na Naija we dey. So make you do something because our mate dem for private university don graduate finish. We don tire to dey beef them. If you no shake body fast make you no forget say university of militancy still dey admit. They never release 2nd batch ooo!

May you greet Maale Patience for we, thank baba God say she and grand Papa Soyinka don settle that their quarrel, two agbayas, plus all those bad belle advisers wey you get. God pass them! Bros Amaechi still dey Niger-delta here, the guy don tire for your matter. We dey greet you for am too.
We go stop for here.
E go be na!
Naija student for life!

Na your Warri boys them.

2 Likes

Re: Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike by Omexonomy: 6:32am On Oct 08, 2013
You have violated certain rules and regulation of nairaland.
Rule 2.
Rule 15.
And
Rule 21.
Re: Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike by Eebrahym(m): 6:51am On Oct 08, 2013
Omexonomy: You have violated certain rules and regulation of nairaland.
Rule 2.
Rule 15.
And
Rule 21.


2. Don't abuse, bully, deliberately insult/provoke,
fight, or wish harm to any Nairaland member.
Bros, Oga Jona na nairalander?


15. Don't attempt to post censored words by
misspelling them.
I concur with this.

21. Please spell words correctly when you post, and
try to use perfect grammar and punctuation.
He's writing with pidgin, u don't expect him to use perfect grammar and punctuation here sir
Re: Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike by stylesco: 7:46am On Oct 08, 2013
Thanks for making me laugh this morning.
Nice letter.
Re: Warri Boy's Letter To President Jonathan On ASUU Strike by Omexonomy: 9:31am On Oct 08, 2013
Though rules are ment to be broken if so then you are right.
Eebrahym:


Bros, Oga Jona na nairalander?


I concur with this.


He's writing with pidgin, u don't expect him to use perfect grammar and punctuation here sir

(1) (Reply)

Funny/dirty Headlines Used In Nigerian Newspapers / 'prof. Iyayi Was Assassinated' / Why Do You Prefer Nairaland To Other Forums.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.