Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,156,462 members, 7,830,297 topics. Date: Thursday, 16 May 2024 at 07:21 PM

Akpors Letter To Harmattan - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Akpors Letter To Harmattan (458 Views)

12 Simple Ways To Survive The Harmattan / How Harsh Is The Harmattan Weather In Your State? / How Is The Harmattan In Your Area This Morning? (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Akpors Letter To Harmattan by Olusharp(m): 3:22pm On Dec 23, 2013
AKPORS LETTER TO HARMATTAN Bros H how far na? My country
people dey hail you oooo! I know
say wherever you dey now belle
don dey sweet you because
time to show your talent don
reach, but Bros as I dey write you this letter I dey on my
knees, I take god of ASUU take
beg you, let by gone be by
gone, abeg I know say we don
offend u but please forgive and
forget! Last week I see oga rain as im
dey pack im load sake of say im
wan go on holiday, naim I ask am
say hw bros H na, d way d guy
reply me I knw say wahala dey! Our lips are in trouble, naso e
go just dey tear anyhow, if we
do mistake baff cold water naso
we go dey shake like nokia 3310
on vibration, we no go fit knw
which one be public bus or private car again becuz dust
don finish their body! Girls no nid to use brown
powder again na to just stand
for outside make dust cover
them! No matter d cream we rub even
if we rub 6 gallon of palm oil our
skin go stil dry like envelope
wey dem take send letter bomb
to dele giwa. Bros na beg we dey beg,
postpone your visit till next
year! Bros na we we ooo thanks! Your faithfully AKPORS
Victim of harmatatiaisis

1 Like

(1) (Reply)

Country With The Most Languages. / Never Knew I Was Addicted! / I Have Spent Over 3months Here. Now It Has Reduced To 3days. This Is Ludicrous.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.