Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,246 members, 7,811,691 topics. Date: Sunday, 28 April 2024 at 05:20 PM

I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah (1331 Views)

(pic)true Or Nah - How Nigerians Prepare For Newyear / 25 April Fools Day Pranks You Can Play On Friends / Trust Nigerians Nah! (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by hungryboy(m): 7:28pm On Jul 13, 2014
Introduction, am hungryboy a chief in the day and a thief at night
Abeg i just dey waka come nairaland jokes section for the first time, all ye mumus and mugus in this section abeg make una welcome me nah
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by delishpot: 7:51pm On Jul 13, 2014
Mumu chairman, all the mumus don go thief like you. Na normal people dey here now. You go wait small for afternoon tomorrow when dem wake up as dem no sleep for night, dem go greet you.
Plele how business? grin

1 Like

Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by K3bee(m): 8:50pm On Jul 13, 2014
shocked na shocked only shocked u shocked waka come grin
na shocked only shocked u shocked go shocked waka shocked go shocked hell B) cool grin
grin grin grin grin

1 Like

Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by hungryboy(m): 9:44pm On Jul 13, 2014
delishpot: Mumu chairman, all the mumus don go thief like you. Na normal people dey here now. You go wait small for afternoon tomorrow when dem wake up as dem no sleep for night, dem go greet you.
Plele how business? grin
which business be that?, ok nah my thief business u dey ask of abi?,
I dey brazil's maracana stadium, i' dey plan to steal world cup trophy, if u hear say world cup don loss, know say na me steal am

2 Likes

Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by hungryboy(m): 9:46pm On Jul 13, 2014
K3bee: shocked na shocked only shocked u shocked waka come grin
na shocked only shocked u shocked go shocked waka shocked go shocked hell B) cool grin
grin grin grin grin
no, i waka with koboko come to flog u,
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by delishpot: 9:53pm On Jul 13, 2014
hungryboy: which business be that?, ok nah my thief business u dey ask of abi?,
I dey brazil's maracana stadium, i' dey plan to steal world cup trophy, if u hear say world cup don loss, know say na me steal am

Lol, for ya mind. Dem go use teeth destroy you there.
Bros if na real gold eh, make we share profit na. I dey ya back if you succed but if dem catch ya, OYO.

1 Like

Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by hungryboy(m): 10:09pm On Jul 13, 2014
delishpot:

Lol, for ya mind. Dem go use teeth destroy you there.
Bros if na real gold eh, make we share profit na. I dey ya back if you succed but if dem catch ya, OYO.
who fit catch me?, i want turn to ant go podium go steal the trophy, then transform to eagle, fly away with the cup come reach naija, incase u see eagle ontop una roof 2morrow, abeg no shoot am oh, na me be dat
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by SOUNDKING: 10:10pm On Jul 13, 2014
2 a mad man evrybody is mad.
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by delishpot: 10:13pm On Jul 13, 2014
hungryboy: who fit catch me?, i want turn to ant go podium go steal the trophy, then transform to eagle, fly away with the cup come reach naija, incase u see eagle ontop una roof 2morrow, abeg no shoot am oh, na me be dat

Omo see winch in action. Biko leave wol cup make we use that powe well my brother. Make you go bank vault go do this abrakadabra. E go pay us well. Or all those big men wey de use ghana must go bag do purse for house and car boot. Make you go there. I go wait for you for haus.
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by hungryboy(m): 10:28pm On Jul 13, 2014
delishpot:

Omo see winch in action. Biko leave wol cup make we use that powe well my brother. Make you go bank vault go do this abrakadabra. E go pay us well. Or all those big men wey de use ghana must go bag do purse for house and car boot. Make you go there. I go wait for you for haus.
Na imported juju dey protect bank vaults oh, if i turn to ant make any attempt to enter dia, i don kpai be dat, na only oyinbo people my juju dey work on
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by delishpot: 10:32pm On Jul 13, 2014
hungryboy: Na imported juju dey protect bank vaults oh, if i turn to ant make any attempt to enter dia, i don kpai be dat, na only oyinbo people my juju dey work on

Lol. You go turn ant enter, pack money, time to fly like eagle no way cos all angle seal, you go drop money turn ant come out empty handed. Lol chei na bad position to be oooo.
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by Glock9(m): 5:49pm On Jul 15, 2014
Welcome, fellow fool.
Re: I'm New Here, You Fools Should Welcome Me Nah by khiaa(f): 9:45am On Aug 31, 2014
hungryboy: Introduction, am hungryboy a chief in the day and a thief at night
Abeg i just dey waka come nairaland jokes section for the first time, all ye mumus and mugus in this section abeg make una welcome me nah

Please SHUT UP.

(1) (Reply)

What Color Is This Gorilla? / What Will You Do When Facebook Recommend This Person As A Friend / When You Don't Login Facebook For A Week, Male/female (must See)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.