Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,162,150 members, 7,849,582 topics. Date: Tuesday, 04 June 2024 at 03:46 AM

Uche No Gree For Keshi - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Uche No Gree For Keshi (420 Views)

Brazil 2014: No Guarantee For Keshi Yet - NFF / Suggest A Squad For Keshi Against Ethiopia / National Honours, Land & Cash For Keshi & Eagles (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Uche No Gree For Keshi by iamkay(m): 5:27pm On Sep 04, 2014
Supa Eagus coachi, Stephen Keshi don yarn we
amebo dat hin call Villarreal
strika, Ikechukwu Uche make hin kon tap ball
for Naija dis weekend against Congo, but de
guyman no gree ansa am.
Even as plenty pipu bin dey shout dat time say make Oga Keshi
carry de bobo go Brazil for dis year World Cup wey shelle for
Brazil, de coachi no gree carry am.
E kon be like say na becos Keshi no hail am for de World Cup na
hin still dey vex Uche, becos Oga Keshi talk say hin call am for
de two games wey Naija get wit Congo and South Africa dis
month, but Uche no ansa am.
“Bros, hin name dey de list of playas wey suppose dey here for
Calabar, but de guy no gree ansa me as hin talk say na muss
make we beg am bifor hin go fit play for Naija.
“I kon tell am say tufiaka I no go fit beg am, and na hin make
me kommot hin name sharp sharp put anoda persin name for de
list,” naso Oga Keshi yarn we for supersport.com
Naija and Congo go sabee wetin dey floor for Calabar on
Saturday as de two of dem go jam diasef for de ticket wey go
carry dem enta Morocco ness year for de Nations cup.



source: supersport.com

(1) (Reply)

Nigeria: Keshi - My Eagles Will Deliver On Promise / Pls Help..goal.com Is Nt Opening In Full On My Android. / Do You Need A Rich And Well Connected Sugar Mummy/daddy Who Will Provide All You

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 7
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.