Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,468 members, 7,816,092 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 04:33 AM

****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** (6435 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... / Nigerian Pidgin Proverbs That Will Surely Make You Laugh: Add Yours Too (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 9:21pm On Feb 15, 2015
Ow far na, I hail u ooOOOoo grin

As 9ja just come enter, takeover my system, na so I wan share some 9ja proverbs - ones wey u for use spice conversation wink u knw say e go sweet person wen na teeth dey come show for mouth cool

OYA NA:

Soup wey sweet na money kill am

Person wey dey cry still dey see road

When person help person, И̣a thank you dem dey tell am

Okro no dey big pass person wey plant am

Them say na from small dem go know dog wey go get tail

Na pikin wey nor know him mama boyfriend dey call am ‘UNCLE’

We no go kneel down beg cow because we wan chop meat

Jazzman wey know e work, no need signboard

Wetin concern bicycle with filling station

Garri no get advert; yet it sell pass Indomie for market

Them no dey borrow leg measure shoe size

Who say shit no get bone make him match shit… he must to limp

POOR man no dey write WILL

If pesin too tay for toilet, e go forget say shit dey smell

Dead person no dey hide for d person wey won baff am

Na condition make crayfish bend

Dem no dey close eyes cross express

When breeze blow, fawuu yansh go open

Na for afternoon them d find black goat!!

No be stone na beans, one day it must done

Wetin yansh get e go show pant

Cow wei no get tail, na God de help am drive fly

They no dey tell tortoise say race don start

Dem no dey tell mad man say this na fire before im go keep away

If you wan talk, na with mouth. Anybody wey talk with yansh, na mess e mess

Cheap article dey run belle

Leg wen swell up no be rain-boot

No be for my mouth you go hear say coke na black

Na person wey wear shoe na im go know where shoe dey pain am

Na only when Soldier handle you na hin you go believe say Po-Po is your friend

Person look for ur trouble no mean say u go fight am cos some people just dey look for who dem go die for him hand

Wetin dey sweet person na em dey kill am

No be today yansh dey for back……

Monkey dey work, baboon dey chop

Pikin wey say e mama no go rest, e self no go sleep

Lizard wey fall from tree, if nobody hail am, e go hail himsef

Dem no dey put hand for pocket climb ladder

Big yansh OR bosom no dey heavy pass the owner

“The world is a small place” no mean say person go fit use leg trek from here go reach Australia

Person wey say snail na lazy animal oya make e carry e house put for head

Na when trees near each other Monkey dey show skill

Na strong tin wen plantain see for fire na him he change him name to bolle

Na lizard wei no get sense de boast 4 crocodile

grin cheesy grin cheesy grin

Wasere, I hope say u like am, if u nor like am... remember - opinion be like nose, as u take get ur own, na so I get my own!!

Ose for reading na - if una wan know more about 9ja's BIGGEST Oyinbo fan, abeg, come follow me for twitter & facebook...

Twitter - @OyinboPrincess
Facebook - Oyinbo Princess
YouTube - Oyinbo Princess

London2Lagos - ONELOVE

8 Likes 2 Shares

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 9:26pm On Feb 15, 2015
See oyinbo dey teach me my own language? undecided

Hian!

Wasere, I hope say u like am, if u nor like am...remember - opinion be like nose, as u take get ur own, na so I get my own!!

This one got me laughing real hard. This woman get 9ja blood for inside her wo undecided

Wait, Oyinbo, na all these things you dey understand as you dey talk am so
Ayamlaykorn

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by basisop(m): 9:31pm On Feb 15, 2015
Na village you dey stay for London? Which kin bush dey your background so? Like say you wan cook, bush meat things. grin

3 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 9:39pm On Feb 15, 2015
@laykorn - LOOOL wink baba na so I understand am na, I nor fit put am if I no go knw am.... na smile I wan make u smile, so I don happy b dat!!

@basisop - Bush kee?? loool, na London b bush abi grin LoOoOoL I wan cook, nor b bust meat na, na melon seeds - make I chop Egusi!!
Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Young03(m): 10:03pm On Feb 15, 2015
Ds lady be like.,,mehn, my pop man na 9ja oo

2 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by joseph1832(m): 10:13pm On Feb 15, 2015
OP nice work. Lemme add mine

Trouble sleep yanga wake am.

Na overskill nahim kill Ajegunle monkey.

One day, one day, monkey go go market e no go come back.

Dem no dey tell blind man say rain dey fall.

Na water and garri nahim make eba.

3 Likes 1 Share

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 10:28pm On Feb 15, 2015
@Young03 - LOOOOOL nor b 9ja oooOOOooo papa ati mumsy na confrim Britico jare smiley

@joseph1832 - Nice1 baba, u don try well well - schweet smiley wasere *Chop Knuckle*
Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 10:39pm On Feb 15, 2015
This oyinbo..... U sure say no b ajegunle dey born you? Abi na warri? You try sha. Make I add my own? wink

2 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by alex406(m): 10:50pm On Feb 15, 2015
Come oyinboprincess, I go like make u even tell us how u take learn this language cus u don even sabi am pass plenty people for 9ja.

3 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 10:59pm On Feb 15, 2015
@AgapeCharis - AJ kee?? LoOoOoOoOoL na London dey born me sha, confirm whitey self grin feel free add ur own jare wink

@alex406 - Baba as e just sweet me well well (Pidgin & 9ja) na so I come apply mind learn am cheesy

My full story dey here sha - http://thenet.ng/2015/02/meet-nets-biggest-fan-oyinbo-princess/

OYA - make una add me sharp sharp ontop Twitter and Facebook grin kiss

Some things wey go help u run come follow smiley


https://www.youtube.com/watch?v=lTVnPxcmrtU


https://www.youtube.com/watch?v=Pd7BpYpz7t4


https://www.youtube.com/watch?v=n_9duq4FYac


https://www.youtube.com/watch?v=BBgqv_DEDJ0
Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 11:12pm On Feb 15, 2015
Head no dey strong reach make dey break palm kernel on top am

When teeth finish for mouth, nose go draw come down

They no dey thief for market carry hand go back

Na small small water dey turn to soup

God know how yansh take dey smell. Na im make am hide am for corner

Rabbit no dey come out for afternoon for nothing

I get them thick thick ones plenty o grin

Cc: oyinboprincess

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 11:17pm On Feb 15, 2015
@AgapeCharis - I don die.... looooool grin e b lyk say my rib don crack self LoOoOoOoOoL *Chop Knuckle*

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 11:25pm On Feb 15, 2015
OyinboPrincess:
@AgapeCharis - I don die.... looooool grin e b lyk say my rib don crack self LoOoOoOoOoL *Chop Knuckle*
Abeg never let am crack o. Our people say no be only mouth dem dey take laugh. Ribs join am. U need am.

But no go laugh sotey u go troway mess o grin tongue

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by nwaanambra1(m): 11:27pm On Feb 15, 2015
bia! oyibo princess u don come naija before?

if no, i go invite you come naija all expenses paid! and i go assign driver to take you go places like AJ, waffi, benin, onitsha, enugu and porthart! na promise i do u so! lol! cool cool

2 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 11:37pm On Feb 15, 2015
@AgapeCharis - BABA I don laugh skata already sha, nor b small smiley lucky say I b lady so I nor fit mess anyhow grin

@nwaanambra1 - CHAII baba, I don come enta 9ja 10000's of times sha.... na second home b dat na smiley AJ kee Abegieeeee, take me beta places like VI or Banana Island cool expenses paid?? U knw say magpie fit swallow watch?!? I hail u though smiley

COME FOLLOW TWITTER @OYINBOPRINCESS & FACEBOOK OYINBO PRINCESS

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by joseph1832(m): 11:47pm On Feb 15, 2015
OyinboPrincess:


@joseph1832 - Nice1 baba, u don try well well - schweet smiley wasere *Chop Knuckle*

Nothing does you. You yourself no say Khaki no be leather!!!. grin

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by loomer: 7:19am On Feb 16, 2015
I raise hand for you

2 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Young03(m): 8:10am On Feb 16, 2015
Oyinbo,,snx u don learn pidgin i go help teach u d main one. IGBO
anyday u enta 9ja ,try reach 042, na im b d startin point 4 every in 9ja b4 movin to lag

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Young03(m): 8:14am On Feb 16, 2015
Mak i add snx wey i de post
a patience dog- Na hungry go kill am.
He who fights and run away-Na fear dey catch am.

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 9:08am On Feb 16, 2015
@joesph1832 - na so e go pass baba... nor b small ooOOoo grin

@loomer - OoooSsssEeee baba, u don try well well kiss cool

@Young03 - baba, if I wan come 9ja, na straight Lag I go go smiley loooool nice proverbs na, try u don try cheesy
Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by njuwo(m): 10:15am On Feb 16, 2015
Make i add my own join this commodities wey she tender so wey gyrate my body. No be everybody wey dey pick him teeth na im chop better meat. E go better e go better na im dey make Igbo man stay Lagos tey. At all, at all, na winsh market. Anyhow, anyhow, ogoro must jump, devil na area boy God na GodFather. OyinboPrincess carry go, NAFDAC don approve your handiwork for here, no be me traffigate am come, na we NL jokes section members align am, NAFDAC come succumb. Wetin them for do? Bird cry for night, pikin delete for morning. Them no need to yarn us the alignment wey transpose.

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Seequadry(m): 2:39pm On Feb 16, 2015
cool.. it's funny and real

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 5:57pm On Feb 16, 2015
This ogbonge torry dey sweet me for belle no be small. Abeg make we no leave am kpai oo. Person wey sabi cook kpomo na him dey get Fulani friend oo.
Anytime wey u see cripple dey boost for u, watch am well well sake of say him get something wey him hide for side.
Abeg fellow tory people, make I go check my trap, I dey come back.

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by DahtzFestjayz: 10:37pm On Feb 16, 2015
Mogbe! Oyinbo Wasere, u try *clap for yourself* Shey u go Follow back?

3 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by OyinboPrincess(f): 11:02pm On Feb 16, 2015
@DahtzFestjayz - Ose baba.... I go follow, yes na, why not?? grin

@Fit2Rule - LoOoOoOoOoOoL, u don try pass, I don crack rib oooOooo cheesy

@seequadry - OooSssEee ooOoo smiley

@njuwo - CHAIIII dere is God oooooOOOOooooo!! Nor b small wey u come add na.... u don try well well, wasere grin

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Kingstaplus(m): 3:35pm On Feb 17, 2015
Chai.! I done faint runaway.. Babe, u 4much!

2 Likes

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by lordmassac(m): 11:36pm On Feb 17, 2015
Yeeeee... See white dey use pidgin bully Me for my domiciliary! Make I add my own sharp sharp.

Dog wey enter lion domain don ready to baf with blood be that o.

Bush meat wey get big blokos, na happiness for the hunter... meat don plenty be that.

Make we praise teeth wey chew a handful popcorn... if he see stone, he go fit try him best.

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by legallyblonde(f): 12:39pm On Feb 18, 2015
lwkmd,oyinboprincess n ellenbabym nor go kill person for social media o!

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Prodeegee(m): 4:21pm On Feb 18, 2015
Babe get in touch when u seethis. I pinged you but it wasn't gettin delivered.

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by upsyLi(m): 10:36pm On Feb 21, 2015
Cow whay no get tail, na Sabo be dia home.
Which play lion and dog dey play if no be blood bath for the dog.
Na the same mouth way Dog use bark hin owner na hin the dog dey take scrub floor for the owner front.
Abegi dis britico don almost sabi this tin pass me oooooo. Gbayi!
I throway salute for you!
Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by Nobody: 10:46am On Feb 22, 2015
nice one..but make u sef know say na sweet leaf dey kill goat cheesy

1 Like

Re: ****Pidgin Proverbs - London2lagos ONELOVE - With Oyinbo Princess**** by ChynoBEATS: 8:35am On Feb 23, 2015
AgapeCharis:
Abeg never let am crack o. Our people say no be only mouth dem dey take laugh. Ribs join am. U need am.

But no go laugh sotey u go troway mess o grin tongue

Guy...... U cray nobi small lol

(1) (2) (Reply)

30+ Very Hilarious Texts From People's Exes That Would Definitely Make You Laugh / BREAKING NEWS ! EFCC Arrests Obasanjo And Goodluck Jonathan / I Need Ur Help...view Only If U Re Good In English

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 34
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.