Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,579 members, 7,816,428 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 11:07 AM

Obama Senior Broda,malik,say Obama Bad Pass Pharaoh - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Obama Senior Broda,malik,say Obama Bad Pass Pharaoh (1103 Views)

Ubi Franklin Celebrates His 30th Birthday Today; Mourns His Late Broda / Ali Baba Poses Like Pharaoh Of Egypt (photo) / Rihanna Shows Her N!pple Piercing As She Goes Out Without A Br A. With Her Broda (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Obama Senior Broda,malik,say Obama Bad Pass Pharaoh by AKPOSbaba: 10:39am On Apr 30, 2015
Malik Obama say him junior broda,Barrack Obama bihavior and karata dey get worse evriday by day since he bicom US president.
He say Obama no send weda him family pipo dey exist for Kenya.
Malik say,wen dia auntie,Zaituni,die for America,
Barrack Obama no drop shishi to take transport di dead bodi back to Kenya bicos he say di transport too cost.
He say,he take dem one month to gada di money to carry her dead bodi go back to Kenya.
Malik Obama yarn all dis for one intaviu wit Joel Gilbert,di director of di film,"Dreams From My Real Father".

He say Obama mata don tire dem reach neck bicos he wicked pass nebukanezzar.
He say time don reach to find out who Barrack Obama real papa be sef, bicos,
naim him step fada,Frank Marshall Davies character he carry.
He say him dey veri veri diasapointed
wit Obama and he don notice all Obama yeye bihavior
espeshally di way wey he treat him and dia late auntie,Zaituni,from di veri fest time
wen dem won swearram enta as he win election for 2008 to bicom di world most powerful man.
He even yarn say,anytime wen he won visit Obama for White House,na thru back door or nite dem dey allowram enta.
Di last tings wey Malik Obama yarn for di intaviu be say,
him no expect to see him step broda,Barrack Obama as di America Presido dey prepia to visit Kenya for July.
Barrack Obama papa na from Kenya why he mama,Stanley Ann Dunham, na America woman.

READ MORE....http://ogakpatakpata..com/2015/04/obama-senior-brodamaliksay-obama-bad.html

Re: Obama Senior Broda,malik,say Obama Bad Pass Pharaoh by axortedbabe(f): 11:29am On Apr 30, 2015
Do u work at wazobia fm?
Re: Obama Senior Broda,malik,say Obama Bad Pass Pharaoh by enoqueen: 12:18pm On Apr 30, 2015
This na the tori wey de reach una from nl fm.

(1) (Reply)

Olu Maintain Is Broke / Photos: Check Out Kenya Moore Puts Her Hot 44yr Old Bikini Body On Display {pic / Miley Cyrus Caught Passionately Kissing Her Victoria's Secret Girlfriend After D

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.