Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,463 members, 7,816,085 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 03:33 AM

Oga Bigi Boy - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Oga Bigi Boy (461 Views)

Oga Police (season 1) / The Brouhaha Of Oga Martins / Happy Birthday Oga Kingphilip (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Oga Bigi Boy by pcaliphate(m): 8:22am On May 01, 2015
OGA BIGI BOY

You no dey drink pure water; your style na bottle things
You too like woman; you no care if she fat or thin
Clubbing na your hobby; in fact you don marry am
Na browsing sure pass; looking for whom to scam
Even when you dey sleep; you still dey form swag
Humility no dey show for your face; your body too dey brag
Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy!

Oga bigi boy! You just dey spend the money as e dey come
You no sabi save, even you your stomach sef na drum
You no dey hear advice; your parents sef don try
You dey live your life so wild; na every time your mother dey cry
As you dey waka; you just dey step on toes
You character just dey magnet different foes
Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy!

Chai! I hear say Oga bigi boy don sick
Lapi don spoil and brokenness don thick
You need to see his face; his swag was so cold
The ever gallant Oga bigi boy was far from bold
Damm! Things fall apart; the ocean has gone dry
Surviving or dieing became a very solid tie
Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy! Oga Bigi Boy!

(Olowo Tosin John)

(1) (Reply)

Poem: How It Feels And Get (never Give Up) By Shinaayo / Oh Why Her!!! / Olikoye :A Short Story By Chimamanda Adichie.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.