Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,214 members, 7,836,037 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 07:35 PM

Mak Una Unbanned D Ban - Autos - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Autos / Mak Una Unbanned D Ban (738 Views)

How Will The Ban On Importation Of Tokunbo Vehicles Affect Car Dealers? / How Reliable Is A Peugeot 406 Or 307-Siena, Viperman Wey una? / Jenju ,siena,inspired Abeg Una Oooo (2) (3) (4)

(1) (Go Down)

Mak Una Unbanned D Ban by adeyemik: 4:36pm On Feb 12, 2009
I read am I no understand, I digest am e no gree go, Abeg my fipol na tru tru say dey ban Igwe abi na lie?

Bros, if na tru tru, I cry for dis our obodo naija. De Igwe wey mi I dey read hin ajasa for Nairaland, na apostle of TRUTH and do tins well well. E go dey talk say mak fipol no de do magomago for de moto wey dey wan sell and giv us d VINN numba. If na because hin tanda gadagba for de side of truth, una take sack commot. My broder naija get long waka to waka before ole, gibiti, afo wo ra and keni ma ni, fit comot for our land.

Dis igwe tin bi lik, de stori of one family, wey they boy dey tifi tifi, de mama dey beat am say mak hin stop, but instead mak de papa join de woman change de boy, de papa go dey halla giv de woman again. Fipol go waka com, com halla say de boy don tifi somtin, de papa go tell dem say mak dey non vex but d papa fail to correct d boy. D mama halla so tay, d papa no gree correct hin pickin.

One ogbonge monday, d pickin go tifi again, fipol com follow am com house, na hin mama dey meet for house, she beg dem say mak dey no vex, after de fipol waka, d mama beat the pickin well well, e no giv am chop eat. Wen de pickin fada com back see bulala mark for hin pickin bodi, e ask say who beat am, e talk say na hin mama, wetin e do, e no ask. E grab hin wife beat so tay, blood comot for her bodi, on top dat e talk say mak she pack comot for hin house.

Bros, two months waka, dat saturday com come, NEPA dey, 12 0' Clock nak gbam, for AIT on top crime fighter, de boy face show gadagba gadagba. Shame wear hin fada lik wrapa, no bodi wan associate wit am, people for street giv am plenti name, na shame drive am comot for d place.

My people say, good NAME beta pass GOLD AND SILVER. If peson do bad tin abeg mak we 2+2 together tell de peson say d tin wey do BAD. END OF STORY GBAMMMMMMMMM.
[size=20pt]
E je ka se dada koba le yewa kale.
[/size]
Re: Mak Una Unbanned D Ban by promise72(m): 9:10pm On Feb 12, 2009
^^^^ Good one.
Re: Mak Una Unbanned D Ban by showbobo(m): 1:05am On Feb 13, 2009
Hehehehe Mr Nothing-Spoil cheesy grin
Re: Mak Una Unbanned D Ban by kuntash: 8:44am On Feb 13, 2009
sometimes e dey do me as if this nairaland na exact replica of how naija be in terms of politics etc. May God help up.

(1)

Special Price 2001 Toyota Camry / Inspired, Jenju, Sienna Pls Help With This Vin Ja4lz41g33u044992 / Carfax Report Needed On This Car:vin=1hgcm56644a171829

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.