Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,993 members, 7,821,469 topics. Date: Wednesday, 08 May 2024 at 01:24 PM

Give Her Bele, You Get 18 Years - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Give Her Bele, You Get 18 Years (1470 Views)

MKO Abiola’s Grave 18 Years After (Photos) / MKO Abiola's Grave 18 Years After / Nigeria’s Sexual Offences Bill Stipulates 18 Years Not 11yrs (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Give Her Bele, You Get 18 Years by easystudy101: 8:15am On Jun 01, 2015
De oda day I meet one of my guys. Na so him squeeze him face like person wey dem kick for him prick. I ask am wetin dey do am, na im him come tell me say one girl tell am say him give her bele!! I wan laff but I just hold mysef, make ee no be like say I dey happy for wetin do my guy.

I ask am why him go make dat kind mistake. Him tell say him use condom. Well why you dey worry?

'You use condom?' I ask am.

'Yes use condom', him tell me.

Some of dis babes for yankee fit put anytin for ya head if you no shine ya eye well well.
Anyway we get to wait for her to born de pikin. I ask my guy to rush go do DNA test. Him do am. But…,
de result hit me with de big one- NA HIM PIKIN!! Hmmm…, dis one na big wahala oo!!

If you give any woman bele for yankee and una no marry, make you just ready to pay her money for de next 18 years. Dem call am CHILD SUPPORT. Dis one no dey for say ‘I no get money, you fit manage dis one?’. De only management wey dey na for you to go relax for jail until you ready to pay her.

Plenty plenty guys life don pafuka like dis. When she carry you go court, de judge go decide how much wey you go pay her every month. Even if you no get work, dat one no concern de judge. And if you get beta work, na im be say you go cough out plenty money.

And all de babes for here know dat one. Most of dem eye tia reach dem back. Marriage no mean anytin for plenty of dem. Wetin dem want na to born for you, den come sidon for house dey wait for ya check every month. When babe begin ask you where you dey work and how much you dey make, dat one na sign for you to tia race. I don jam babe wey tell me say she go donate pikin give me, she go get bele for me.., lol. No be person tell me to run.

I say eh, many guys don try plenty tins to fight dis one. Some go just stop to work kpata-kpata. Dem go tell you say de judge go arrest dem tire. Some go run go hide for far far state so dat police no go fit catch dem.

And if you say wan fight make de court give you de pikin so dat you go raise am, dat one na time wey you just dey waste. Unless de babe dey kolo or she be totally useless woman, you no go ever get de pikin.

Some women go wan deceive you say dem no like to jingolo with condom. Dem go tell you say de tin dey worry dem for bele. My guy, make you run oo!! Even when you use condom, make sure say you flush am for toilet or if you no trust de toilet.., put am for ya pocket carry go house oo..., lol.

I know say dis one go sound like extreme measure, but my guys dem law hia no dey play with you when ee reach for dat tin wey dem call CHILD SUPPORT!!!

1 Like

Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by indiraserv: 8:24am On Jun 01, 2015
Lol.......
I wish such laws were enforced in Nigeria
Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by R0ckefeller: 8:30am On Jun 01, 2015
Op na so those yankee babes do they go talk say they wan feel all you. And u if agree to give her all you just ready to pay your child support
Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by kingofpool: 8:30am On Jun 01, 2015
chai, sorry for him
Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by R0ckefeller: 8:31am On Jun 01, 2015
indiraserv:
Lol....... I wish such laws were enforced in Nigeria
am sure you are a lady
Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by indiraserv: 8:45am On Jun 01, 2015
Lmao!
Well! I still refuse to state if I am a lady or a guy ,too many naija men like dip and fall back!
And the woman spends the better part of her years fending for the child alone
R0ckefeller:
am sure you are a lady
Re: Give Her Bele, You Get 18 Years by Nobody: 8:56am On Jun 01, 2015
Even when you use condom, make sure say you flush am for toilet or if you no trust de toilet.., put am for ya pocket carry go house oo..., lol.
grin grin grin

(1) (Reply)

7 Things History Won't Forget About Sanni Abacha Exactly 17 Years Ago Today, Gen / 10 Nigerian Women Reveal How They Lost Their Virginity / Mrs.buhari’s Brothers,cousins Collect Millions Of Naira To Grant Access

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.