Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,031 members, 7,818,044 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 05:51 AM

Wetin Concern Me And Dessert - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Wetin Concern Me And Dessert (417 Views)

US Senators Block Sale Of Fighter Jets To Nigeria Over Human Rights Concern / The Ringing Of Coup Bells And A Cause For Deep Concern - FFK / Observers From US & UK Express Concern Over Election Result Validity In Rivers (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Wetin Concern Me And Dessert by easystudy101: 8:53pm On Jun 09, 2015
I know say some of una go call me bush man afta una finish to read dis post. Eh....., may be I be bush man or may be I just no like to ova do tins. Or may be I just like to be Africa man anywhere wey I find my sef.

Dis tin wey dem dey call dessert, abeg I wan make somebody explain to me wetin be need for dat one. Afta you don full belle with all de food wey dey ya front and you don drink all de drink wey ya eye see, den you go come hia announcement like 'any more room for dessert?'

I surprise say nobody tell me say my belle na four bedroom flat. No get me wrong oo.., me I don eat dessert sometimes for dinner or party wey I attend. Shey I get to try sometin at least once? Make ee no be like say na my own come different pass.

But I go tell you dis one..., anytime when I don try dessert I no dey enjoy am like dat. May be na sake of say dessert dey usually get sugar inside. Weda na cake or na pie, ee dey always spoil de taste of de food wey I don already chop. Or may be na sake of say I no too like sweet tins.

Anoda time when I no dey too like dis dessert tin na when I dey chop for restaurant. As I dey eat and dey calculate for my head how much de food go cost (just like every normal stingy naija guy), de server go just sneak come my back to ask me if I get more space for dessert, lol. My answer dey always be "no thanks". But wetin really dey my mind na "abi you wan pay for dat one?".

For naija wey I grow up, we no know anytin like dessert. Afta you do knack dat full plate of rice and stew or dat mountain of eba and afang soup, de only space wey you go dey find, na where to go lie down so dat ya ova size belle no go burst open.

Anyway sha if you like dis dessert tin, make you carry go. Me I don try am and de tin neva still master me!

1 Like

Re: Wetin Concern Me And Dessert by AAinEqGuinea: 9:17pm On Jun 09, 2015
I'm not much of a dessert person myself, but if I have no option than I'll save the dessert for when the chop has settled.

(1) (Reply)

Group Slams APC; Says It's Not Different From PDP / With The New N’assembly Leadership, Buhari Might Revise His Cabinet Lists / PDP Ready For Saraki, Dogara Defection–party Chieftains

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.