Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,868 members, 7,817,564 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 02:29 PM

Make We Chew Tobacco - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Make We Chew Tobacco (893 Views)

Make We Join Head Translate De Real Nigerian Pidgin Bible. / A Warri Make We Still Show Ourself Na. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Make We Chew Tobacco by easystudy101: 5:44pm On Jun 14, 2015
For naija, people dey smoke tobacco or put am for dem nose. Dat na wetin I see and na de only two ways wey I know say you fit put tobacco for ya body. But when I come yankee, I come discover say ee get anoda way wey you fit put tobacco for ya body. You fit put am for ya mouth and come begin suck am like sweet.

When I discover dis one, ee really shock me. And de way wey I take find out really turn my belle. I dey for library one day, and I notice say one guy wey sidon opposite me been dey pour spit inside pure wata bottle. De guy no even try to hide de bottle wey don by dis time almost reach half with him brown spit.

Any time I raise my head and my eye jam de bottle, ee just dey like say I wan vomit. Den I later come ask my study partner wetin dat guy dey spit inside dat bottle. Him come begin explain to me say na tobacco wey de guy dey spit inside de bottle.

You go put de tobacco for de corner of ya mouth or under ya teeth. Den you go come begin suck am small small. Some dey swallow de tobacco or spit am out. If you finish to suck out de juice from de tobacco for ya mouth, you go spit am and den put de next one for de same place or for anoda corner of ya mouth.

Dis kind way to use tobacco dey very popular with onyibo people wey dem call country folks or rednecks. Na mostly de men dem wey dey suck tobacco. You go sabi pessin wey dey suck tobacco from de way wey him go dey spit constantly. And de spit dey always dey green or dark brown. And if you look dem teeth, na so ee dey get multicolor.

If you go any gas station, you go see de tobacco for containers wey dey exactly like de original snuff container. I been no know say na wetin ee be until I see as dat guy for library bring out de container from him pocket.

And I hia say to use tobacco like dat be one of de main cause of mouth cancer and throat cancer. And I sure say de taste go dey very bad. But as dem dey talk am, everybody get im own poison wey im like. And I sure say I don tell una my own poison before. Well if you no know or you don forget, my own na beer.

2 Likes

Re: Make We Chew Tobacco by IndianBwoy(m): 9:49pm On Mar 13, 2016
In India, it is very common to chew tobacco. I've tried it too. most people , especially bus/auto-rickshaw drivers and laborers chew it to keep them awake and focussed.

This is the main cause of spitting on the streets and polluting the environment.
Re: Make We Chew Tobacco by 9inches(m): 7:31am On Mar 14, 2016
IndianBwoy:
In India, it is very common to chew tobacco. I've tried it too. most people , especially bus/auto-rickshaw drivers and laborers chew it to keep them awake and focussed.

This is the main cause of spitting on the streets and polluting the environment.

So true.

(1) (Reply)

Photos : Alaafin Of Oyo And His Oloris Storm Maiduguri / PHOTOS: Alaafin Of Oyo Pay Visits To His Friend Oba Of Lagos At His Palace / Igbos And Great River Niger; Blessing Or Curse?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.