Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,238 members, 7,818,811 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 05:06 AM

Is Nigeria A Joke? - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Is Nigeria A Joke? (1303 Views)

Can You Take This As A Joke From Your Woman? Photo. / Was This Supposed To Be A Joke?(photo) / When A Joke Turns Serious (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Is Nigeria A Joke? by MeAndYou(m): 8:31am On Jun 25, 2015
ILOVE NAIJA I NO GO LIE!!! God Bless Nigeria!!! Na
only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading
N200 MTN Recharge Card.
Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a
big ship.

Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and
win Benin Republic.
Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win
Nigeria because their colour na Green.
Na only for Nigeria you go see fish
inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count money after we
withdraw am from ATM because we no even trust
ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your light
bill (wat a pity)
Na only for Naija people dey horn for traffic light
make e quick change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke,
Recharge Card, Chin chin,
Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no fit see am
anywhere in d world...
Trust me.
Na only 4 naija you go find a graduate of
Mechanical
Engineering dey do him NYSC 4 Police station.
na only 4 naija you go see one person dey use
Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be
Bill Gates? Abi na you invent internet?
Na only 4 naija you go see a graduate of law dey
work as generator repairer.
Na only for Naija u go buy coke, dem go say make
u no forget to return d bottle.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,
people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, you go see advert from native
doctor on how to make quick money.
Na only for Naija u go wish somebody 'happy
birthday', he go answer 'same to u'.
Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA
HAS RELOCATED"


.. im proud of dis my country we dey unique.
Re: Is Nigeria A Joke? by chivision: 10:12pm On Jun 28, 2015
Are you asking me?
Re: Is Nigeria A Joke? by MeAndYou(m): 7:14am On Jul 04, 2015
chivision:
Are you asking me?
No!?
I was only asking you people

(1) (Reply)

When You Pay Less But Want The Same Quality (photo) / 80's Rich Kids / African Mom Negotiation With Kidnappers

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.