Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,416 members, 7,815,937 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 09:32 PM

Dark Skin VS Light Skin - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Dark Skin VS Light Skin (495 Views)

Justice John Inyang Okoro, The Dark Hand That Killed Justice In Abia - Abiafact / Light Skin People And Multi Racial People Are Not Blacks / Anxiety Mounts As Buhari Keeps Tinubu, Atiku In The Dark Over New Cabinet (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Dark Skin VS Light Skin by steadyguy: 5:15pm On Aug 29, 2015
Among akata people for hia, dem get dis tin wey dem dey always argue about. Dat tin na de color of dem skin. Yes oo! Dos wey get light skin dey tink say dem beta pass dos wey get dark skin. And dos wey get dark skin no like light skin people.


Dis tin wey I dey tell you be VERY serious mata for hia. Ee dey even cause serious quarel for among family members. Light skin family members dey feel say dem beta pass dos wey get dark skin. Even sef some parents dey show more love to de pikin dem wey get light skin. Dis na sometin wey I don witness with my own korokoro eyes.



And as skin color dey separate one akata pessin from anoda one, na so de way dem hair dey too dey separate dem. De more ya hair take style dey resemble onyibo pessin hair, de more suprerior wey you go feel. No be small tin oo!


Even for office, you go hia tory as light skin akata and dark skin akata dey jam head for. De light skin pessin dey feel say im dey closer to onyibo people pass dos dark skin akata. Light skin dey feel say dem get more onyibo blood pass Africa man blood for dem body.


For hia, de more you separate ya sef from Africa, de beta wey tins go be for you. Lol. Africa don suffer for dis yankee people hand oo! I no blame dem sha..., na we wey dey allow dem to do us anyhow.


Now how dis light skin vs dark skin wahala really start? Well..., history say de tin been start during de slavery time. Dat time de oga dem (slave masters) been dey sleep with de slave women. And when dem born pikin, de oga no go wan make dat pikin to mix with de oda slaves.


So na dis pikin wey get light skin like de oga wey dem dey keep for house. Dis light skin pikin go do de house work instead of to dey work outside for sun and rain. And dem dey eat beta food and wear dress wey beta pass dos wey de regular slaves dey wear.


And den as time come dey pass, dis light skin pikin go come begin feel superior to de oda slaves wey no dey live for main house. Den de light skin people come begin call dem sef CREOLE. Dem begin separate dem sef from de oda akata people.


And as time dey pass, dem begin see dem sef like onyibo too. Aftarall dem papa na de oga of de house. But trust de onyibo wife of de oga! She no go eva give dem chance to claim anytin. Most times, de onyibo people dey reject dis half caste pikin dem. And even till today, onyibo no dey too accept pikin wey any of dia memeber born with black pessin (dat one na sometin I go write about oneday).


So since onyibo no accept dem as one of dia own, and dem no wan mix with dark skin people, most of dis light skin people dey always look down on dark skin akata people.


Now dis one come dey make me to wonda. As far as I know, skin color no too get importance as I been dey grow up for naija. Although some people dey bleach dem skin to dey light in complexion, we still no accept de culture say light skin pessin beta pass. In fact, wetin I know be say, people dey marry opposite dem skin color so dat dem fit mix de color for dem pikin body.


No be until I come dis country wey I come see how skin color among dos wey get African ancestor dey ova important. Na wa oo!


check my profile for more details about my BLOG address
Re: Dark Skin VS Light Skin by shiffynaani(m): 5:18pm On Aug 29, 2015
A
Re: Dark Skin VS Light Skin by robinicule(m): 5:19pm On Aug 29, 2015

(1) (Reply)

Why Would Osinbajo Term This As Buhari's Government Instead Of 'our Government'? / Joseph Mbu: The Roaring Lion Now The Silent Pussycat / Osun To Begin Payment Of Salaries

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.