Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,165,808 members, 7,862,673 topics. Date: Sunday, 16 June 2024 at 10:48 PM

Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. (718 Views)

Apc To Obiano – Don’t Set Anambra Ablaze, Demolish Those Death Traps Now Or… / All Roads In The South East Are Death Traps – Okorocha / Warri Roads In Pictures (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by Nobody: 10:15pm On Sep 23, 2015
My people i greet una specially... i won yan wetin dey pain me & i believe say i dey yan people mind, this matter na about the road condition for warri & the entire Delta State. shuuu e com be like say we nor get government for the past 8yrs, e just be like say na where our former governor Chief Ibori develop reach nai we still dey till today, notin change. After the former governor Ibori comot for power th guy wen enta na warri brot up, we feel say the guy go tranform Warri but na degrading we dey see because all the road project dem wen dem dey ring billions for our ear notin to show for, even Asaba capital kpakpa no good road. For Warri enh no pleasure in driving at all. PTI rioad for Masoje junction & Effurun market don spoil over the yrs no repairs & now th road don worst. what of Uti road for Effurun, Ebrumede Uturn near Dsc round about for Dsc express way, abi na Udu road, what of PTI junction, NPA express way near NPA & Ugbuwange, abi na old airport road wen dey on its own wen dem com dey destroy recently say na renovation dem dey do. the one wen com ves me pass na Effurun Sapele road wen dem com destroy say na BRT dem won do like Lagos for road wen nor wide, all the billions wen dem ring for our ear dem stil abandon th project comot for office, as i dey write dat road is not motorable at all but we stil dey manage m because we nor get other one. what of fly over wen dem do for the popular round about wen ppl nor dey use. the side of the fly over na so so hole dey & dem carry SHOPRITE put thr. what of Ughelli Asaba express way project & Osubi Eku road project. abeg if i won complete the bad road list enh, this forum nor go contain. the whole Delta state be like village. ppl dey go mechanic workshop everyday like toilet because of bad roads. Delta state politicians nor dey try at all. Even LGAs nor fit do some kind reasonable road maintainers for us but dem go comot for office turn billions over night. My ppl mek i end this gist for here.
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by Sappyman(m): 10:21pm On Sep 23, 2015
My brother, these are the dividend of a bad democratic system in Delta State. The past Governor Emmanuel Uduagha is a big disgrace to humanility.

1 Like

Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by myners007: 10:27pm On Sep 23, 2015
Then whats the way forward
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by docadams: 10:40pm On Sep 23, 2015
myners007:
Then whats the way forward
Do away with PDP.
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by obailala(m): 11:47pm On Sep 23, 2015
Delta state leaders are a disgrace to humanity...
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by gmacnoms(m): 11:55pm On Sep 23, 2015
D road eh? D condition is soooooo bad h
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by Nobody: 7:47am On Sep 24, 2015
docadams:

Do away with PDP.
APC & PDP NA TH SAME...WE ONLY NEED CHANGE OF MIND
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by Nobody: 7:50am On Sep 24, 2015
myners007:
Then whats the way forward
we need change of mind not change of political party.
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by docadams: 8:11am On Sep 24, 2015
TekaNeg:
APC & PDP NA TH SAME...WE ONLY NEED CHANGE OF MIND

OK. Change of mind it will be. APC national has changed it's mind. No place for a PDP corrupted soul. He's all yours.
Re: Warri Roads Na Death Traps & Sucking Monie. by ANBAKO: 1:50pm On Sep 24, 2015
Until you guys understand that Warri don carry last...
then something will happen. Do not be running after militancy, shun boy boy for politicians, run away from laziness, embrace hardworking, education, shun ethnics, believe in the commonwealth and don't be selfish.

Warri has everything to be the best City in the world but poor governance and divide and rule is killing them all.
My 10 months in Warri is a real eye opener. ...

(1) (Reply)

Time To Impeach Saraki / Breaking New: Chief Olu Falae has been released / Saraki's Case: A Political Risk Base Tool.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 59
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.