Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,809 members, 7,956,068 topics. Date: Sunday, 22 September 2024 at 11:44 PM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Troll Of Life..........(a Case Study Of Chaysee Fc) (713 Views)
Ronaldo Trends On Twitter As Fans Troll Messi After UCL Game / Bayelsa Queens Fans Attack Sunshine Queens FC Players,Brutalise Them(pics) / Rivers United FC Players Arrive Madrid In Spain For Final Pre-season Preparation (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Troll Of Life..........(a Case Study Of Chaysee Fc) by 4rmthewest(m): 10:45pm On Oct 26, 2015 |
Chaysee go just dey lose matches like say na wetin
their forefathers write for their 'will' pass on to them.
Useless club with no magnitude nor direction.
.
See, Carroll wey last score against now relegated Hull
City almost 10months ago, na im dey score winner
against Chaysee. Kai! Na im be say if to say Iniesta
catch Chaysee during him football bald head spell,
him for score too. This team is taking uselessness to
another level entirely. A level QPR will be ashamed to
attain sef. When last did that useless team score the
first goal in a match? They've now had a player sent
off 4 times already this season. Haha.. It's one thing
for a small club to have an off and on season, and
eventually relegate, whilst it's a different thing
entirely for a small club to be showing serious
relegation determined form. Chaysee is doing the
latter. They be like "we've watched the likes of QPR
take what's rightfully ours. We won't sit down and
watch that happen any longer"
.
Chaysee fans talk say with Zouma for RB, u fit start ur
generator without fuel.. Dey count clean sheets
against Aston Villa and Kyiv, like say those ones
follow.. Rubbish!
.
Some Chaysee players be like : "I am Begovic and I
like to concede goals, deal with it!"
John Terry when asked about Chaysee's current form
and the prospects of being relegated, had this to say
"Anton Ferdinand plays in the Championship, doesn't
he? So no, I don't think I wanna play there,
because..." John Terry who was yet to finish his
speech, was interrupted by Mikel, who pushed him
away, and had this to say "TA! Sharrap, Terry wetin u
know? U no wan play for Championship, u dey mad!!!
As for me, I want to play in the Championship. It has
always been my dream. Everyday after Chaysee's
match, I will see 14 missed calls from my mum, and
some text messages, which read "Obi, are u still a
footballer? Come home and come and farm now,
every time when we're watching Super sports, we no
dey see u." and Terry says he doesn't want to play in
the Championship? He's mad! They hardly show
Championship matches in Nigeria. So I'm sure I won't
be getting those messages from my mum." Mikel
angrily told sky.
.
As for Lose' Mourinho, that one is proof that grey
hair doesn't necessarily mean old age and wisdom.
For Lose' its a sign that stupidity can meet up with
one at any stage in life. All u have to do is apply
urself. I no know why that referee send am go West
Ham board of directors stands. Person wey dem
suppose send go the middle of where West Ham-
Chaysee like fans dey, make person give am R.K.O all
in the name of jubilation when West Ham score their
second goal. Hahahahahaha.. Who see Muniru face
when Tamer Hassan dey take that impromptu selfie
with am? Muniru con fat for cheeks. All the things
wey him wan talk don hang for him belle. E just be
like that community shield game against Arsenal wey
him open mouth. U know say that him mouth na
DVD, but that day 'no disc'. This weekend no disc too.
Them give Matic red card Mourinho begin sing
hymns for inside him mind. Him know say if him play
wrong clip for that him DVD mouth, na wahala.
Assistant Manager wan begin ginger, Mourinho just
dey look am how Mikel take look Terry that day. For
Mourinho mind him dey talk say "e be like this one
still get money sha, them never fine u'
.
Special one wey like to dey travel everywhere. Abeg
do go Fernabache make them send u go stands with
Galatasary fans.. Nobody go dey talk about pig head
for El Clasico again. Na Mourinho head go be the new
gist.
Rubbish club win one match for August, win one
September, win one November (so far) but that may
increase to two, because their next match na against
another very useless club.
P.S - CHAYSEE'S SCRIPT ENDS HERE..
.
1-1verp0-0l. This is another very useless club. Jurgen
Klopp say him be the 'normal one'. Hahahahahaha..
By the time wey him go leave that club, if him no
craze e go remain small. Club wey make a whole
proper British man like Brendan Rogers forget all the
vocabulary wey him know for this life, that one con
dey shout "character" for every press conference, u
think say na small thing? Look their legends na,
Michael Owen dey think and talk with him armpit.
That club nearly crash him thinking faculty. Shey na
Carragher we wan talk? Club wey a whole Gerrard
wey no too dey collect red card, enter collect yellow
and red within 45seconds. Gerrard see Demba Ba,
slip, u think say na ordinary something? Win match
begin cry.. Even Suarez wey be vampire cry for that
club.. That club no be here o. Na our brother Awoniyi
we go dey pray for now. Nothing kuku concern
Sturridge. Him own na to dance, lick lips, go hospital,
enter pitch with back, lick lips, dance again - Repeat..
U say make him kill himself? Club wey don neutralize
the small talent wey Coutinho been get, now na only
shot that one dey play. Nothing again. Kaka wey be
pastor for Sao Paolo, na im dey collect Coutinho spot
for national team. Same team wey dem Dante don
play for, Coutinho no fit enter. Small time now na him
go dey help Mignolet play goalkicks. Him face don
dey wrinkle sef. The burden of playing for a shit club.
Club wey make 19yr old boy born 3 pikin straight, con
still make the boy begin smoke wetin big pass am. U
think Bricklayers and Farmers are doing a tasking
job? Try playing for Liverpool.
.
The club so bad, that reeling out their stats alone
looks like a troll. Commentator said : Liverpool's last
8games has been 1-1, 1-1, 3-2, 0-0, 1-1, 1-1, 1-1 and
now 1-1. Is this a club? My God!!! I don talk say I no
go dey troll Liverpool again because they're useless
without limitations. But Chaysee's uselessness
dragged me into theirs.
.
Brace urself fams, next week, hopelessness meets
uselessness. 12:45pm local time. Bye bye. 1 Like |
(1) (Reply)
Brazil Vs Nigeria- Fifa Mistaking Nigeria For Germany / Who Do You Think Is Most Responsible For Chelsea's Woes This Season? / Uefa Champions League Fixtures This Week
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22 |