Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,113 members, 7,818,319 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 12:32 PM

Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? - Celebrities - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Celebrities / Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? (1061 Views)

Davido: Why Wizkid And I Settled Our ‘Beef’ Of Many Years / Davido: Why I Love Chef Chi; Chioma Is The Only Woman That'll Treat My Kids Well / Dammy Krane Reacts To News Of His Arrest in Miami, USA: "I go talk everything" (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:18am On Oct 28, 2015
Cynthia Morgan don tell Davido make he go siddon for one place,
few days afta she tell tori pipo say, na Davido be one bobo wey be say,
if dem giam chance,she go leak him ear.
Kasala don buss out bitwin dem two,
four days afta she yarn say,among all di celibritis,na Davido she dey trip for pass.
Di hole wahala start wen Davido hand skratcham go write for twita say,
na Lil Kesh go win di best new miuzishan for di Headies Awards wey go appun veri soon.
Akordin to Davido,he say na Lil Kesh be di MVP dis year make evri oda pesin chill for di boy wey sabi.
Quikquik mazamaza,naim Cynthia Morgan reply say,
make Davido go siddon for wia containam bicos evribodi wey dia name appia for dat list na MVP.
Apart from di German Juice singa and Lil Kesh,oda artist wey di oganisers choose for dis award na,
Reekado Banks,Kiss Daniel and Korede Bello.
Like follow come battery for phone,di next rated award go follow come wit brand new motor.
So anybodi wey win di award,go win di motor join.
Issorait,make I go prepia for di next tori.
Gudluck to all of dem.

Read more for hia....http://ogakpatakpata..com.ng/2015/10/sharrap-davido-why-u-go-talk-say-na-lil.html

Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:20am On Oct 28, 2015
Op plz can u translate in English
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:21am On Oct 28, 2015
Op plz can u translate in English...I no dey understand pigin by dis time of d day
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:24am On Oct 28, 2015
Di battle!

Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by OKorowanta: 8:27am On Oct 28, 2015
sissylucy:
Op plz can u translate in English

Lol.
na di language wey my malleh undastand for warri be dis.
ask yor palleh,he go gist u more about dis first language of ova 100 million naija pipo.
nor go carry last o.
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by sissylucy(f): 8:41am On Oct 28, 2015
OKorowanta:


Lol.
na di language wey my malleh undastand for warri be dis.
ask yor palleh,he go gist u more about dis first language of ova 100 million naija pipo.
nor go carry last o.

no b say I no dey understand pidgin but no be by this time
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by PoosPoos: 8:58am On Oct 28, 2015
Lolling grin
Re: Sharrap Davido!!! Why U Go Talk Say Na Lil Kesh Be Di Best New Artiste For 2015? by Eliza5050(f): 9:02am On Oct 28, 2015
sissylucy:


no b say I no dey understand pidgin but no be by this time

I don't want to laff dis morning jor. grin
U're already replying with pidgin dis morning na!

(1) (Reply)

Yoruba Actress Laide Bakare Buys Her Artistes Brand New 2015 Prado SUV(photos) / Wendy Williams Shows Some Serious Cleavage After 50-pound Weight Loss! / a

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.