Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,760 members, 7,817,102 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 05:38 AM

THE WORDS THAT CHANGED BUHARI - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / THE WORDS THAT CHANGED BUHARI (614 Views)

Lagos At 50: Check Out What Has Changed (photos) / Prophecy That Changed The Life Of Yemi Osinbajo / Lai Mohammed Cautions Against Words That Can Jeopardize Release Of Chibok Girls (2) (3) (4)

(1) (Reply)

THE WORDS THAT CHANGED BUHARI by omohlexy: 9:33pm On Jun 14, 2016
BEFORE WE DIVIDE!
I hear news of secession every day and it sounds so funny.
Everybody wants to break up and form their own country abi?
With the rate they are going, one street go soon become one country.
Shebi una don read ANIMAL FARM? Ok- me don forget sef say- no be every body enter class that year!
The animals never found true happiness even after they won their long desired freedom.
The PIGS who were the chief advocate of freedom became TYRANTS!
But let me ask o, who dem wan make presido sef? Let’s assume they succeed.
When one kilometer na another language?
How multitude go take raise only one trophy at the same time na?
Who takes home the price reward?
Na for only Liberia Prince Johnson go kill Samuel Doe come allow Charles Tailor be President o. THIS IS NAIJA ….T.I.N. and we all know say survival of the fittest and JUNGLE JUSTICE go be the order of the day last last. lets wise up


Let’s face the fact, I mean, lets be honest, we need each other.
The North needs the South, the South needs the North
We complement each other.
We get OIL i gree. But anyday wey groundnut oil go begin start motor ehn, hmmm!
Na im be say we go begin use our crude oil fry Akara na.

Lets embrace each other in love peace and unity unto say,
e don tay wey guyman enter farm to dig yam heap o.
Last time wey tomato scarce small, no be small thing o.
My guy, come see where men dey convert dry tatashi to tomato na.
All man come fall back to black stew with squeezed faces and fake praises.
Truth is, the food comes from the north. They are proud to be called farmers
But that one no mean say we no get power to farm o
Na just say our leaders for south too dey thief our government given fertilizer sha!
After all, me sef get small garden for backyard.

To the people of the North, make una still try realize say as una cows plenty reach, e never fit construct one road o. road smooth, road smooth na oil money .
After all, who NAMA help? I fit just wake up now, vex, turn vegetarian now now now even as we speak.
All man no get where we dey.
I mean, no begin raise your collar unto one tin-one tin o
We are only just useful for a purpose.
Even me wey dey write sef-my own dey my body.
Monopoly is artificial. Determination always puts it to shame
But just as a man can’t be every where at the same time,
So a man cannot do all things by himself, for himself, all at a time

Let’s remember! it is easier to destroy than to build.
Every body is finding an alternative way of economic survival and sustenance o.
Anyday wey dem banga go ripe for up north, hmmm! we go surprise say na the people when una dey threaten with break up go first give una heartbreak o!
If I dey lie wait make Hausa man farm turn export commodity, na that time u go know say to break up don dey hungry them since 2000 BC.

Let’s unite in love, peace and harmony. Who religion help? Na spirituality win am abeg. As u carry knife slaughter another man because him opinion no tally with your own now, who you impress? Na God abi na Devil? As for me u no try at all!
Next time you want to blow up something, think of the hazard and suffering you expose your people to. You hurt your very self.
Remember! No war is ever completely won so long as violence is involved
You might win the battle but you will never win the war. Ask Libya, Ask Egypt,
Ask Palestine and Ask Israel.
Dialogue is the greatest antidote to conflicts
Love is the greatest healer of all.

Before I sign out I go like advice all these politicians wey dey chop we country people money like glutton wey no get sense. Na small small dem dey rob blind man when e no go know una hear? See as una dey run helter skelter now because of the same problems wey una use una hand cause.
How una wan take use pot belle and agbada run when everywhere don finally red na?
Abi una never hear say Queen don tell Cameron say make e nor open door for Una again any time una run go hide for dem country like rat wey thief fish from Akpos pot of stew?
I don draw my ear warn una o! Food wey dem chop vomit no dey fine for eyes o!
Finally let’s remember that corruption is worse than tsunami, earth quake and volcano all wrapped together. That’s how we got stuck here in the first place.
We no go BREAK UP if we WAKE UP
Till another JUNE 12, by Gods Grace, Remain ever blessed.

Long live Nigeria! Long live Africa!

1 Like 1 Share

Re: THE WORDS THAT CHANGED BUHARI by DRISKLEF(m): 9:50pm On Jun 14, 2016
Lemme dash OP a comment. cheesy
Re: THE WORDS THAT CHANGED BUHARI by oganology33(m): 9:55pm On Jun 14, 2016
Lemme know wen u finish typing dis Boosit!

(1) (Reply)

Alleged Forgery: Saraki, Ekweremadu May Go To Jail / Letter From Sheikh Of Borno To Sultan Mohammed Bello Given Christians Protection / I Have No Governorship Ambition – SGF

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.