Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,273 members, 7,818,930 topics. Date: Monday, 06 May 2024 at 08:27 AM

Trouble No Waka Come (poem) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Trouble No Waka Come (poem) (532 Views)

The Trouble With Kissing Him / Black Panther (my Wakanda Waka) / Car Trouble (21+) A Short S**x Story (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Trouble No Waka Come (poem) by shenkz: 4:56pm On Jul 26, 2016
Trouble no waka come
Trouble no waka come
Here no be your bus stop
Abeg no sit down there

We they patch everyday
like made in aba soccer boot,
So that life go make sense.
No do no do married to the hustle,
We no dey single like singlet.

Life na mixture just like rice and beans;
The good the bad no be twins,
But na the same mama born them;
E no matter which one be your friend,
When trouble show, you go fear fear.

Enter bus for 20naira hold 1k for hand;
Price market with ibo man for 1hr say you no dey buy;
Soldier dey tok you come shout say na lie;
Trouble you dey find; Wahala you go get;

Trouble don dey find me for 3 days e neva rest,
I dey dodge am like pot hole for express.
E carry wahala come block me for road.
The matta long pass queue for petrol.
Naso I shout o...

Trouble no waka come
Trouble no waka come
Here no be your bus stop
Abeg no sit down there



Written by shenkz.. ©2016

(1) (Reply)

A Picture Is Worth A Thousand Words. / Something About Sahara. / OMO OLOSAN (orange Seller) A Poem

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.