Pingin Proverbs - Jokes Etc - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Jokes Etc › Pingin Proverbs (1573 Views)
| Pingin Proverbs by mikeweezy(op): 11:54am On Sep 22, 2016 |
PIDGIN PROVERBS
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast
run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross
water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the
journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey
see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy
labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hailam!! é go
hail himself
15. Toto water small, but é reach prick to take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE
BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No matter how ground
strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him
papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share
meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he
wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT
WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait
for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him
sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.
33. Na happiness dey make prick stand
Abeg add ur own |
| Re: Pingin Proverbs by UndisputedBosom(m): 12:22pm On Sep 22, 2016 |
Organize the numberin to make more brain |
| Re: Pingin Proverbs by bostish(m): 4:49pm On Sep 29, 2016 |
Na sweetness of pissing dey cause mess. |
| Re: Pingin Proverbs by Nobody: 9:01pm On Sep 29, 2016 |
E better make man die leave prick than make prick die leave man |
Nigeria Pidgin Proverbs • Some Common Nigerian Pidgin Proverbs • Some Funny Nollywood Proverbs.. • 2 • 3 • 4
My Response To An Unintelligent Scammer • Christmas Drama In Church • 25 Photos To Spice Up The Monday