Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,985 members, 7,814,356 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 11:35 AM

True Talk - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / True Talk (623 Views)

(2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

True Talk by Nobody: 10:21pm On Sep 24, 2016
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin. 2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run. 3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep. 4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am. 5. Na for afternoon dem dey find black goat. 6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg. 7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD. 8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march? 9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far. 10. Person wey don faint before no be stranger to death. 11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see. 12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit. 14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hailam!! é go hail himself 15. Toto water small, but é reach prick to take baff. 16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND. 17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck. 18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside. 19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man. 20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat. 21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch. 22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open. 23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK. 24. Dem no dey tell tortoise say race don start. 25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food. 26. Before you see monkey, monkey don see you. 27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again. 28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am. 30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze. 31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 32. My thing and our thing no be the same oh. 33. Na happiness dey make prick stand, if the owner no happy it will become dead vegetables. 34.If you no dey laugh now, it mean say recession don carry chair and table come Sidon for your house.
Re: True Talk by divinehand2003(m): 10:24pm On Sep 24, 2016
Re: True Talk by feldido(m): 10:29pm On Sep 24, 2016
grin grin grin...
Na fly wey no de hear word de follow deadbody enter grave.
Re: True Talk by Eminembuz(m): 10:55pm On Sep 24, 2016
Making me laugh loud..

(1) (Reply)

Watch Out For These Easter English Errors / Supplication About What Bobrisky As Done To Our Ladies In Nigeria / Beautify Your Wall With This (affordable)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.