Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,112 members, 7,835,751 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 02:21 PM

Pidgin Proverbs... - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Pidgin Proverbs... (708 Views)

Proverbs From The Streets Of Warri / Some Hilarious Pidgin English Proverbs To Crack You Up / Nigerian Pidgin Proverbs And Their Translation. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Pidgin Proverbs... by ferdvict2(m): 12:52pm On Oct 25, 2016
1. Na for old age ashawo dey know
the value of pikin.

2. Woman wey never see problem...
Na im dey still hold breast run.

3. Woman wey dey find pikin no dey
wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é
go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find
black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross
water, wey say him march fish, wetin him
mama go march?

9. Small pikin wey dem carry for back no
know say the journey far.

10. Person wey don faint before no
be stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye
enjoy sex she dey enjoy labour pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko
tree, if nobody hailam!! é go hail himself

15. Toto water small, but é reach
prick take baff.

16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO
BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO
HUSBAND.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

18. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine
they use style call him papa blind man.

20. No be eye wey dem take chop
eba dem take dey share meat.

21. Person wey use Elephant set
trap, na him know wetin he wan Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go
Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM
SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM
KNOW BOOK.

24. Dem no dey tell tortoise say race don start.

25. Dem no dey tell blind man say
salt no dey for food.

26. Before you see monkey, monkey don see
you.

27. Thief wey jump fence enter
house where owner dey wait for am, no go
jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa
sef go tell am say him sabi bury.

29. Na wetin dey sweet for goat
mouth, Na im dey kill am.

ADD YOUR OWN TO THE LIST BELOW...
Re: Pidgin Proverbs... by Nobody: 3:49pm On Oct 25, 2016
Breeze don blow, fowl nyansh don open.

Na condition make crayfish bend.

1 Like

Re: Pidgin Proverbs... by 1shortblackboy: 1:01am On Oct 28, 2016
okpolo eye no be open eye
woman fit piss inside bottle ?
Instead of trouble make rain fall
Provision is better than kiosk

1 Like

(1) (Reply)

Is The Ooni Of Ife Not Too Big For This? / On Misogyny – Ada Umeofia / Young Igbo Forum: Is Christianity Erasing Igbo Culture?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.