Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,780 members, 7,817,241 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 08:36 AM

Pidgin Proverbs. - Education - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Education / Pidgin Proverbs. (1053 Views)

Success Storms Delta Pidgin Radio Station, Drops #DemGoFlogDemGoTire / Dear Nigerians, Pidgin English Has Basic Rules Too! / Common Pidgin Proverbs And Their English Meanings (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 11:07pm On Mar 30, 2017
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
2. Woman wey never see problem.. Na im dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be
stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself
15. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
17. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside.
18. Pikin wey say him mama no fine dey use style call him papa blind man.
19. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
20. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
21. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
22. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
23. Dem no dey tell tortoise say race don start.
24. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
25. Before you see monkey, monkey don see you.
26. Thief wey jump fence enter house
where owner dey wait for am, no go jump again.
27. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.
28. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
29. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
30. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
31. My thing and our thing no be the same oh.
32. Na happiness dey make prick stand.
33. Na as goat stand for market dem dey price am.
34. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.
35. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.
36. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.
37. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
38. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
39. Akara and moi moi get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

MY PIPUL NA LIE I TALK?

"ADD YOUR OWN"

Source=https://m.facebook.com/story.php?story_fbid=807271839426791&id=100004319470695&refid=7&_ft_=qid.6403415757173309029%3Amf_story_key.3822052709217088355%3Atop_level_post_id.807271839426791&__tn__=%2As

Re: Pidgin Proverbs. by Nobody: 11:12pm On Mar 30, 2017
No be lie
Re: Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 11:13pm On Mar 30, 2017
xqzytchyca:
No be lie
Yeah.
Re: Pidgin Proverbs. by stainlink(m): 11:17pm On Mar 30, 2017
You try my guy.
Re: Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 11:19pm On Mar 30, 2017
stainlink:
You try my guy.
No be my hand work.
I saw it on Facebook and decided to share it here.
Re: Pidgin Proverbs. by ekensi01: 11:20pm On Mar 30, 2017
i can see u need employment u are now employed as speaker of Nairaland bravo. Congrat
Re: Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 11:21pm On Mar 30, 2017
ekensi01:
i can see u need employment u are now employed as speaker of Nairaland bravo. Congrat
Hmm lol.
How i go take dey receive salary boss.
Re: Pidgin Proverbs. by brennyB: 11:56pm On Mar 30, 2017
no be lie sha
Re: Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 12:01am On Mar 31, 2017
brennyB:
no be lie sha
Yh.
Re: Pidgin Proverbs. by stainlink(m): 6:07am On Mar 31, 2017
HQuadreal:

No be my hand work.
I saw it on Facebook and decided to share it here.
Na the reason wey I say you try na. you bring make we for read for Nairaland. Once again you try my guy wink
Re: Pidgin Proverbs. by HQuadreal: 6:16am On Mar 31, 2017
stainlink:

Na the reason wey I say you try na. you bring make we for read for Nairaland. Once again you try my guy wink
Thanks Boss.

(1) (Reply)

Hi! Please Can I Study Computer Science In Unizik / Anchor University Lagos 2017 / 2018 Admission Processing Ongoing. Admission Fo / Ongoing Protest In Kwara State Polytechnic (Photo)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.