Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,117 members, 7,814,915 topics. Date: Wednesday, 01 May 2024 at 11:20 PM

Bros Love Your Own Abeg ( Inspired By Love Yours By J Cole ) - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Bros Love Your Own Abeg ( Inspired By Love Yours By J Cole ) (402 Views)

Olaokun Soyinka Writes Tonye Cole Over Airplane Seat Saga Of Wole Soyinka / Bound By Love / Arrested By Love (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Bros Love Your Own Abeg ( Inspired By Love Yours By J Cole ) by lalaponcus(m): 9:31am On Apr 26, 2017
BROS LOVE YOUR OWN ABEG (Inspired by 'Love Yours' by J Cole)

Nwa nnem show abeg.
Egbon drag your chair forward make you hear me well.

I no dey understand your parole again.
Everyday na so ya eye dey pop out of im socket wen you see another woman.

"Kai you see that one backyard?
"Ewuuu. You see how this one set for front"
"Mogbe I must die ontop that girl matter"
These words na im dey commot from your mouth wen you dey with other men.
Soo tey, them don know you as Baba for d gehs.
The cassanova wey no go allow any opeke wey dey the area to rest.

Haba oga.
You nor dey tire?
Your blood nor dey rest for one minute?
Your bodi no dey feel the effect of too much sexual 'ginger'?
You never tire to dey lose respect for people eye.
Soo tey small girl go dey knack ya bald head and you go dey smile like who win lottery.
Soo tey small girl wey reach your daughter age go dey call you "baby" and ya head go dey rise like garri wey poor man soak.

Abi you nor know?
Say another woman go always fine pass the one wey you see two hours ago.
Say another ukwu go always big pass the one wey you see two minutes ago.
Say another woman body go set pass the one wey you see two seconds ago.

Biko love yours o.
Spend all those moni ontop ya woman and she go change.
Spend all those compliments ontop your madame and ya belle go give testimony for church.
Spend all those quality time for her side and ya peace of mind go double.
Spend all those sweet love 'nwantitin' ontop her and God Almighty sef go too bless you.

Na the tori wey me wan yarn you o.
Like J Cole talk.
"Ain't no such thing as someone that is better than yours"

As for me.
Me love my Jesus and my 'dearest muse'.
Every other person na counterfeit.
#NaBashorun

Okontas.com

Watch out for A trip down FGC IKIRUN LANE this week.

(1) (Reply)

Digital Poetry Collage / News Editorwanted At A Media Company / The Easiest Way To Rise Above Mediocrity

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.