Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,652 members, 7,854,718 topics. Date: Sunday, 09 June 2024 at 03:48 AM

Afonso My Guy! - Poems For Review - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Poems For Review / Afonso My Guy! (393 Views)

Afonso My Guy! (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Afonso My Guy! by pcaliphate(m): 12:01pm On Jun 28, 2017
"I no wan talk too much but I gat to say something". Hello Everyone. Here is an insightful-comic piece of mine titled 'Afonso My Guy!'. #Enjoy.

Hello Afonso my guy!
Na Texas dey talk.
Na me, you, pinto and rock,
Be padi that year for 'shikini' high school.
Wey be say all the girls na so so we woo.
Teacher flog, Teacher flog, we chest all the cain.
Our bond was so tight, we were the main the main.

Afonso my guy! you sabi that day?
Wey be say rain fall and danfo no dey.
We con leg am from there to a very far place,
Na so so whyning until we reach our base.
Afonso my guy! memories still dey linger,
I miss those days, I miss our ginger.

Afonso my guy! abeg no vex for me,
All these while wey I no call, e get as e be.
I check Internet, I check everywhere,
Single trace wey be you, no even dey there.
But when I jam that your baby for 'Ojuelegba',
As we yarn! yarn!, she give me your number.

Hello Afonso my guy! I call You for reason,
I be get small problem wey I wan make you reason.
Last week I play 'two sure' na one sure con sure.
All my money wey I put, Baba Ijebu chop all.
My wife dey plan to run, 'ghana-must-go' don set,
She say she regret the day, wey we 'meet and met'

Afonso my guy! I really need your help,
Am caught in this trap sinking in its web.
But me no go gree, I dey plan to revenge,
I just need 3 million to have a good edge.
So by the time I go chop, we go give them a knock,
And jolly for me, you, pinto, and rock.

Hello Afonso my guy?
Hello Afonso?
Fonso Fonso?
Hello?
Abi na network?
Mtcheww! Nawa ooo


By Olowo Tosin John

1 Like

Re: Afonso My Guy! by elfico(m): 6:32am On Jun 30, 2017
well crafted. and to think it on pidgin, it just rocks.
Re: Afonso My Guy! by pcaliphate(m): 12:12pm On Jun 30, 2017
Thanks Oga Boss. I really Appreciate. GOD Bless You Amen

(1) (Reply)

In Love With The Feeling Of Lust / ALONE ~edgar Allan Poe / Poem

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.