Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,163,363 members, 7,853,627 topics. Date: Friday, 07 June 2024 at 08:21 PM

Afonso My Guy! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Afonso My Guy! (448 Views)

OMG! See As I Almost Kissed My Guy Because Of A Girl (VIDEO) / Zuma: What My Guy Was Thinking / Oga Dino Malaye My Guy. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Afonso My Guy! by pcaliphate(m): 3:35pm On Jun 29, 2017
Hello Afonso my guy!
Na Texas dey talk.
Na me, you, pinto and rock,
Be padi that year for 'shikini' high school.
Wey be say all the girls na so so we woo.
Teacher flog, Teacher flog, we chest all the cain.
Our bond was so tight, we were the main the main.

Afonso my guy! you sabi that day?
Wey be say rain fall and danfo no dey.
We con leg am from there to a very far place,
Na so so whyning until we reach our base.
Afonso my guy! memories still dey linger,
I miss those days, I miss our ginger.

Afonso my guy! abeg no vex for me,
All these while wey I no call, e get as e be.
I check Internet, I check everywhere,
Single trace wey be you, no even dey there.
But when I jam that your baby for 'Ojuelegba',
As we yarn! yarn!, she give me your number.

Hello Afonso my guy! I call You for reason,
I be get small problem wey I wan make you reason.
Last week I play 'two sure' na one sure con sure.
All my money wey I put, Baba Ijebu chop all.
My wife dey plan to run, 'ghana-must-go' don set,
She say she regret the day, wey we 'meet and met'

Afonso my guy! I really need your help,
Am caught in this trap sinking in its web.
But me no go gree, I dey plan to revenge,
I just need 3 million to have a good edge.
So by the time I go chop, we go give them a knock,
And jolly for me, you, pinto, and rock.

Hello Afonso my guy?
Hello Afonso?
Fonso Fonso?
Hello?
Abi na network?
Mtcheww! Nawa ooo


By Olowo Tosin John

1 Like 1 Share

Re: Afonso My Guy! by cuedish: 3:37pm On Jun 29, 2017
grin grin grin grin grin grin angry angry angry angry

1 Like

Re: Afonso My Guy! by Khd95(m): 3:42pm On Jun 29, 2017
lol

1 Like

(1) (Reply)

Up For Grab: Dubai Direct Employment Visa (2)years / Singer Duncan Mighty To Tour 14 Cities In Europe / Lol

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.