Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,824 members, 7,817,407 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 11:44 AM

One Man Don Give Him 14-yr-old Pikin Belle For Warri - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / One Man Don Give Him 14-yr-old Pikin Belle For Warri (414 Views)

Girl 16 Carry Belle For Boy 28 / Jesu Oyinbo's Son Arrested For Defiling The 14-yr-old Niece Of His Girlfriend / 3 Arrested For Raping And Having Two Rounds Of Sex Each With A 14 Yr Old girl (2) (3) (4)

(1) (Reply)

One Man Don Give Him 14-yr-old Pikin Belle For Warri by NewsinPidgin(f): 1:01pm On Aug 18, 2017
Police for Delta State don start search for one Mr. Orutebe, wey give him 14-year-old daughter belle for Ugboroke wey dey Uvwie council area for d state.
Dem talk say Orutebe, dey around 40years and him don run comot for house after him bin don already confess say na him give d girl belle.
The man na from Ogulagha kingdom for Burutu Local Government Area, Delta state and him get two wives.
Dis gbege start wen dia neighbours start to dey see signs say dis girl fit don Carey Belle o.
As dem ask am weda she get belle, na im she confess say her na her Papa bin dey sleep wit am.
One of dia neighbour on Thursday follow talk say,
“As we dey question d girl na imm she confess o. D small girl bin no even know say she bin get belle sef say d only tin na say she notice as her belle dey big dey go.
“The girl still follow talk say her stepbrother wey don follow run comot, na him bin disvirgin am and him don dey nack as steady since den.
One person sef follow tell PUNCH Metro say d leader for dia community bin don get dis info and dem him sanction am for incest.
One senior police officer for the Warri Area Command confirm the matter, come talk say the police bin dey search the man for everywhere.
Wen dem call d state Police Public Relations Officer, Mr. Andrew Aniamaka, him talk say him never hear of dis matter yet o.
Him say d only case wey him hear na the one wey dem report for Ogberikoko Police Station wey dem talk say one fake quack doctor bin do abortion for 19-year-old girl.

Source : http://newsinpidgin.ng/one-man-don-give-him-14-year-old-pikin-belle/
Re: One Man Don Give Him 14-yr-old Pikin Belle For Warri by ojun50(m): 2:02pm On Aug 18, 2017
D wey delta men dey give there pinkin belle no be here

(1) (Reply)

UN Hammer North Korea With New Sanctions / 67-year-old Ekiti Kidnap Victim Recounts Ordeal As Police Parade Suspects / Man Bags Two Years Jail Term For N100,000 Fraud

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.