Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,158,162 members, 7,835,891 topics. Date: Tuesday, 21 May 2024 at 04:56 PM

For quality I.T products,visit www.ictcart.com and thank me later. - Technology Market - Nairaland

Nairaland Forum / Science/Technology / Technology Market / For quality I.T products,visit www.ictcart.com and thank me later. (406 Views)

ORDER FROM 1688.COM and other chinese website with express freight 71/rmb / Www.waphan.com - Download Games, Music, Videos, Apps / How To Order From Gearbest.com And Pay Directly With Your Bank Account (2) (3) (4)

(1) (Reply)

For quality I.T products,visit www.ictcart.com and thank me later. by mercyonyx(f): 2:53pm On Oct 27, 2017
Finally na so God take butter my bread oooh!!! I been they pray, fast and beg baba God make pesin buy or dash me better phone wey I go use connect and relate well with people wey they follow me buy market on top social media, as I done tire to dey use this nokia torch lite phone. Na so money wey I don hustle since just fall on top my lap like ayakata. As a boy big I run enter market make I go buy fone as I don land now, I com buy the one wey enter my eyes pass, carry am come go hauz dey joli. After two days, I come notice say if I take picture the background go dey shine pink, without filter ooh. O boy I think say the thing go clear up but instead anoda one join am: if I dey make call the fone go dey vibrate on top my ear. The one wey vex me pass na wen I won transfer money give my babe after I don tell am say na my last card I won give am, the tin com hang, I off and on am back, e com be say e use him hand send money give my babe two times: double debit alert; chai!!!
Naso I blow bike go the shop wey I buy the fone from, as I come down from the bike,I know no say my fone drop from my pocket, I enter the shop come dey rake, I put hand for pocket make I bring out the fone, small crase worry me wen I no see am, I run go outside to God be the glory the phone dey for road, for this naija pesin never obtain am, abi the problem they show for the body,for me to cross road pick am, na so one trailer from no where just climb my fone, just dislocate d joints, dismantle and disfigure am without conscience or reasoning, I carry the pieces like egg go back the shop, more sober and respectful, as I expected no show.
I reach hauz dey think of my life na so my mama broda from jand land, out of the blue him talk say e don tey wey him dey try my number e no dey go, I tell am my story and how my waka be today and him com promise me anoda better quality phone from sure dealer with warranty, the one wey him dey use, him order am from ICT Cart before him come back and dem delivery am as him dey touch down for airport. The next day my ogbonga machine, my new oyoyo phone land from ictcart.com uptil now I never hear one single story ontop the phone, the picture quality na die, no hanging, no typing error and mistransfer of fund. If you like better thing run go www.ictcart.com for your quality ogbonga IT products, tested and trusted, no wahala , no story. Na me and ictcart from now till forever.

(1) (Reply)

16gb Ram For Sale Pc3l / Shocking: 8 Year Old Boy Owns A Motorcycle Repair Shop / Blackberry Passport For Sale.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.