Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,619 members, 7,809,271 topics. Date: Friday, 26 April 2024 at 07:06 AM

A Tale Of Stream 2 PCM - NYSC - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / NYSC / A Tale Of Stream 2 PCM (766 Views)

Any Information On 2016 Batch B Stream 2 Passing Out Date? / When Is 2016 Batch B Stream 2 POP Date? / Join 2018 Nysc Batch A (pcm) Whatsapp Group (2) (3) (4)

(1) (Reply)

A Tale Of Stream 2 PCM by blogbuilder: 8:43pm On Nov 16, 2017
make I greet the lastest otondo to be in town. una well-done OH, tomorrow una go know who be who. ocean 1&2 go separate una.... make I quickly share my experience with d people wey go fall to ocean 2

N/B: If u register between d day 1$2 wey portal open, congratulate urself, ocean 1 sure for u, na him dem use during our time

Back to d story, tale of stream two otondo

our own portal for call up open on May,19th, since April na him I Don buy all my complete kit and d blalalalala for camp, I wan join d pepper dem gang.

The day for call up come show face finally, I Don tell myself say I no go sleep today, 12am na him I enter d website, as I login like dis sleep just commot my eyes, message wey I see be say[b]you will be notify when to print your call up because you are not in stream 1[/b]I nearly faint OH. I rush enter nairaland, na so I see people dey cause NYSC ,na den I come see say dem never upload anything.
3am knack, I Don dey see people comment like Lagos here I come, Abuja pcm let's hook up., sokoto must favor me and blablabla, I login again but d thing still be same, I come know say kasala don burst

As morning come na so I come dey receive call from my friend and enemies oh,calls like, where dem post u. I try make I tell dem say na stream 2 I dey but my bad mouth wey I Don take tell everybody say I dey go service no allow dem allow dem know say stream 2 dey oh.
I call some of my friends, some share dsame fate with me, na so I come dey happy small since no be only get d problem

D day wey dem enter camp, wetin full my facebook timeline na only NYSC photo OH, na so I start to dey cry again, dat one na small Mata, d day wey dem do swearing in, na him worst pass, I nearly cry my eyes comot.

As many of my friends Don follow stream1 Waka, na so d problem come start. Everyday people go dey stop me for road, guy which day u wan go service?.
To matter worse, everyday my parents go dey ask me, which day NYSC wan call u for service? Your friends Don go finish... Omo dat year no be small thing OH...

D worst part be say, different rumor come dey emanate like, Dem Don scrap NYSC, no more stream 2, una go start camp Next Week... Like play like play, na so 2months pass OH........

Thank God sha,we still dey breath
Stream2 no be crime OH, just pray make God favour you.. NYSC na fun oh



Na ur boy Frio
Whatsapp or call 08061686212 for any question
Re: A Tale Of Stream 2 PCM by blogbuilder: 8:43pm On Nov 16, 2017
nn

(1) (Reply)

NYSC Placement For Software Developer / NYSC 2018 Prospective Corp Members In Osogbo Should Meet Here / Corp Member Beaten By The Community In The Name Of Serving Their Fatherland

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 20
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.