Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,194,198 members, 7,953,732 topics. Date: Friday, 20 September 2024 at 01:45 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Post World Cup Chat Between Messi And Kaka (1696 Views)
Kaka Biography And Lifestyle. / Cristiano Ronaldo Vs Ronaldinho Vs Kaka Vs Thierry Henry, Who Is Better? / Did Kaka Truly Deserve A Red Card? (2) (3) (4)
Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by Pappij: 4:16pm On Jul 15, 2010 |
My People, stumbled on this, had a great laff, pls enjoy Messi: Bros how far na KAKA: I dey o Messi: e get as this world cup take be o KAKA: walahi I no know wetin happen with us wey Dunga don overput hope say we go carry am, Messi: una own better, Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world best footballer!!! KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be only u no Score, Rooney nko, even Torres. Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble.Na only klose and dat small boi Schneider just dey use us shine.when Gerrard call me tell me I think say na lie till I play back d video as we dey go back Buenos Aires, KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die. MESSI: make una dress! Una wey no fit head ball? KAKA: make e be, at least none of us bin don go do advert say im dey head ball, and dem no disgrace us. last last Holland no win cup na… MESSI: Germany too no win na. Chei, iniesta no go let person rest oohh KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na. Nobody go fit talk for our side as Raul no go World Cup. Who open mouth,im head go roll MESSI: Shey?, no shaking sha, we go chat later. me wan log out go play Choosing for area so. Heinze dey here sef. E say make I hail u. E dey vex say dem no choose am for area. KAKA: make e gerrout. Him rough sef. hail am sha. E go be. Make I enter church. Dis Mourinho,me no know whether I dey im first eleven again afta dis wolcup. i dey fasting programme. Later MESSI: Guy, pray for me too oh. I hear say that Nigerian guy - Eyeama dey move come La liga oh… |
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by chelseabmw(m): 10:28pm On Jul 15, 2010 |
i can't help but start laughing |
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by feasy1(m): 10:21am On Jul 17, 2010 |
Hilarioussssssssssss |
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by waggzy(m): 7:15am On Jul 22, 2010 |
wonderfuuuuuuuuuuuuuuuuuuuul |
(1) (Reply)
50 Highest Paid Players In World Football For 2010 / The 20 Most Fouled Players In La Liga (season 2016/17) / Arsenal Fan Reacts/sends To Wenger For Not Buying Any Player Despite Lose
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10 |