Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,209 members, 7,818,707 topics. Date: Sunday, 05 May 2024 at 10:26 PM

Post World Cup Chat Between Messi And Kaka - Sports - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Sports / Post World Cup Chat Between Messi And Kaka (1668 Views)

Kaka Biography And Lifestyle. / Cristiano Ronaldo Vs Ronaldinho Vs Kaka Vs Thierry Henry, Who Is Better? / Did Kaka Truly Deserve A Red Card? (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by Pappij: 4:16pm On Jul 15, 2010
My People, stumbled on this, had a great laff, pls enjoy


Messi: Bros how far na

KAKA: I dey o

Messi: e get as this world cup take be o

KAKA: walahi I no know wetin happen with us wey Dunga don overput hope say we go carry am,

Messi: una own better, Guy na 4-0 dem flog us ,I no score goal,me wey be world best footballer!!!

KAKA: Guy dem tear me Red card,I never collect Red before for my life. No be only u no Score, Rooney nko, even Torres.

Messi: Una lucky say no be Germany una meet. I no even see road dribble.Na only klose and dat small boi Schneider just dey use us shine.when Gerrard call me tell me I think say na lie till I play back d video as we dey go back Buenos Aires,

KAKA: Eh ya. Kpele. But dat 4-0 too much o. We laff for bus tire as we dey go airport. E sweet us die.

MESSI: make una dress! Una wey no fit head ball?

KAKA: make e be, at least none of us bin don go do advert say im dey head ball, and dem no disgrace us. last last Holland no win cup na…

MESSI: Germany too no win na. Chei, iniesta no go let person rest oohh

KAKA: hehe,na una for barca go suffer am na. Nobody go fit talk for our side as Raul no go World Cup. Who open mouth,im head go roll

MESSI: Shey?, no shaking sha, we go chat later. me wan log out go play Choosing for area so. Heinze dey here sef. E say make I hail u. E dey vex say dem no choose am for area.

KAKA: make e gerrout. Him rough sef. hail am sha. E go be. Make I enter church. Dis Mourinho,me no know whether I dey im first eleven again afta dis wolcup. i dey fasting programme. Later

MESSI: Guy, pray for me too oh. I hear say that Nigerian guy - Eyeama dey move come La liga oh…
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by chelseabmw(m): 10:28pm On Jul 15, 2010
i can't help but start laughing grin grin grin
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by feasy1(m): 10:21am On Jul 17, 2010
Hilarioussssssssssss smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley smiley
Re: Post World Cup Chat Between Messi And Kaka by waggzy(m): 7:15am On Jul 22, 2010
wonderfuuuuuuuuuuuuuuuuuuuul smiley smiley smiley

(1) (Reply)

Ali Bin Al Hussein Promises More Funds For Africa If Elected As… / Improvements On Glo Premier League Nigeria / I Need Help On Bet365 Verification

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.