Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,165,292 members, 7,860,699 topics. Date: Friday, 14 June 2024 at 02:32 PM

If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? (1010 Views)

Ekiti 2022: ‘No Vote, No Money’ – Tinubu Teases Electorate(Video) / Farooq Kperogi: Tinubu Is Attacking Buhari Because He Won't Be President / Kenneth Okonkwo: If South-East Don't Vote Buhari, They Will Be In Wilderness (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Nobody: 9:49pm On Oct 19, 2018
Respect to Victor AD song, if we no get money, wetin we gain!

Naija Southern youths?

If we no vote Buhari because of Atiku, wetin we gain?

1. Buhari and Atiku both of dem pass 72 years.
2. Buhari and Atiku both of dem na northerners
3. Buhari and Atiku both of dem na muslim
4. Buhari and Atiku both of dem na Fulani.
5. Buhari and Atiku both of dem stop our son Jonathan for 2015
6. Buhari and Atiku both of dem get cows.
7. Buhari and Atiku both of them na Miyetti Allah patron.
8. Buhari get conscience wey dey limit his loot, Atiku conscience don die since 1980 for looting matter.
9. Buhari get only 4 years to go and power come south. Atiku get 8 years.
10. Buhari go secondary school with plenty millitary training/school abroad equivalent to BSc. Atiku get only diploma for ABU.
11. United State believe say Buhari no dey steal. The same United State know say Atiku na big thief.
12 . Atiku govt, na north go many pass for appointment. The skewness fit reduce, but na north go still many pass. With Atiku north dominance go extend to 12 straight years. North dey dance azonto and shaku shaku 4 our head.
13. At the end of 2019 election, any which way na north win. While south go dey fight themselves over common VP.
14. We say Atiku good for economy, but no evidence anywhere of any factory wey Atiku build apart from rent seeking easy money business own by Italian business where Atiku dey collect big cut for the help wey he dey help the company collobi Nigeria revenue. Atiku University na the most expensive university for Nigeria. Poor man no fit near am.
15. Our economy currently depend on oil under Buhari (though with some apparently effort to diversify and reduce import which is causing hardship) Under Atiku , the economy dependence on oil go increase since he is more likely to promote importation for rent seekers for short term political gains and big loss for the future.
16.According to Sowore, Atiku presidency is to create paradise for thieves and oleburukus
17. Does our hate for Buhari nepotism enough to vote a klemptomania Atiku who is still going to favour northerners for appointments even though with less skewness?
18. is the difference between them significant enough for all the energy we dey put for the matter?
19. We all know say dem go rig 2019 election. APC go rig and PDP go rig. But na Buhari dey power. So Buhari get upper hand for rigging. So why we go dey fight over election between two Fulanis, wey dem for North don decide who go win whether we vote or not? North get voters pass us, them get INEC to help dem inflate the figures.
20. If we continue as we dey now, the south will be more divided while the North will be more unified after 2019 election.

Make we think, wetin we go gain for this election as southerners(SS,SE and SW) apart from igbo vs yoruba attack of each other?

We say Fulani no know book. But na dem dey use our head play ludo so!

Fo social media , I never see where North West youth (Buhari people) dey fight North East youth (Atiku people) over 2019.
Abi northerners no get android phone and data? But yoruba (Afonja) vs Igbo (Ipob) fight full everywhere

We say fulanis na Almajiri wey no go school, but now, na we dey rush them.

11 Likes 6 Shares

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by PresidentAtiku(m): 9:51pm On Oct 19, 2018
We need men who take responsibility

3 Likes

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Shelumiel: 9:55pm On Oct 19, 2018
Oga, you need to understand that we are Nigerians ; and the driving factor in the blood of every Nigerian is greed and selfishness .
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Nobody: 10:01pm On Oct 19, 2018
PresidentAtiku:
We need men who take responsibility

Is this significant enough for igbo vs yoruba attacks?

1 Like

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by adexyemi: 10:28pm On Oct 19, 2018
brother na you bam pass....I swear cuz to be realistic the two of dem na Fulani and we still dey shout say na atiku beta pass......I swear no one beta,according to my people they make the

proverb that (irùkirù obè awö) only the Yorubas will understand that

1 Like 1 Share

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by kYjelly2: 10:29pm On Oct 19, 2018
adexyemi:
brother na you bam pass....I swear cuz to be realistic the two of dem na Fulani and we still dey shout say na atiku beta pass......I swear no one beta,according to my people they make the

proverb that (irùkirù obè awö) only the Yorubas will understand that

Then vote Sowore bro!

Go on youtube and watch his videos
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by REDshouse(m): 10:42pm On Oct 19, 2018
A lesser looter is far better than a confirmed no conscience looter....


Between the two Fulani i will go Buhari

3 Likes 1 Share

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Wiseandtrue(f): 11:03pm On Oct 19, 2018
The kòkó of this matter is that we need to CHANGE the fake CHANGER

Who best to beat Buhari at it

AtikulatedObi the genuine changers!

4 Likes

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by SarkinYarki: 11:05pm On Oct 19, 2018
You want thunder to strike
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by crimeboss: 12:53am On Oct 20, 2018
Shelumiel:
Oga, you need to understand that we are Nigerians ; and the driving factor in the blood of every Nigerian is greed and selfishness .

Y d trash?.

1 Like

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by ababio02: 5:47am On Oct 20, 2018
life2017:
Respect to Victor AD song, if we no get money, wetin we gain!

Naija Southern youths?

If we no vote Buhari because of Atiku, wetin we gain?

1. Buhari and Atiku both of dem pass 72 years.
2.Buhari and Atiku both of them na northerners
3. Buhari and Atiku both of dem na muslim
4.Buhari and Atiku both of them na Fulani.
5.Buhari and Atiku both of them stop our son Jonathan for 2015
6.Buhari and Atiku both of them get cows.
7. Buhari and Atiku both of them na Miyetti Allah patron.
8. Buhari get consience dey limit his loot, Atiku conscience don die since 1980 for looting matter.
9.Buhari get only 4 years to go and power come south. Atiku get 8 years.
10. Buhari go secondary school with plenty millitary training/school abroad equivalent to BSc. Atiku get only diploma for ABU.
11. United State believe say Buhari no dey steal. The same United State know say Atiku na big thief.
12 . Atiku govt, na north go many pass for appointment. The skewness fit reduce, but na north go still many pass.
13. At the end of 2019 election, any which way na north win. While south go dey fight themselves over common VP.
14. We say Atiku good for economy, but no evidence anywhere of any factory Atiku build apart from rent seeking easy money business promoted and protected by access to govt.
15. is the difference between them significant enough for all the energy we dey put for the matter?
16. Our economy currently depend on oil under Buhari (though with some apparently effort to diversify and reduce import which is causing hardship) Under Atiku , the economy dependence on oil go increase since he is more likely to promote importation for rent seekers for short term political gains and big loss for the future.
17.According to Sowore, Atiku presidency is paradise for thieves.
18. Does our hate for Buhari nepotism enough to vote a klemptomania Atiku who is still going to favour northerners more appointments even though with less skewness?
19. We all know say dem go rig 2019 election. APC go rig and PDP go rig. But na Buhari dey power. So Buhari get upper hand for rigging. So why we go dey fight over election between two Fulanis, wey dem for North don decide who go win whether we vote or not? North get voters pass us, them get INEC to help dem inflate the figure.
20. If we continue as we dey now, the south will be more divided after 2019 electiin.

Make we think, wetin we go gain for this election as southerners(SS,SE and SW) apart from igbo vs yoruba attack of each other?

We say Fulani no know book. But na dem dey use our head play ludo so!

Fo social media , I never see where Katsina youth (Buhari people) dey fight Adamawa youth (Atiku people) over 2019. Abi northerners no get android phone and data? But Afonja vs Ipob fight full everywhere

We say fulanis na Almajiri,.and now, na we dey rush them.

cover of victor song wetin we gain

oluwa abeg make problems stop,cuz suffer don touch this body
make I atikulate, not follow buhari way no work for me o my papa
......

(chorus)
if I vote buhari wetin I gain ooo,
wetin I gain
if I follow zombies wetin I gain,
wetin I gain
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by PresidentAtiku(m): 6:41am On Oct 20, 2018
life2017:


Is this significant enough for igbo vs yoruba attacks?
No one is fighting

1 Like

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by orisa37: 7:21am On Oct 20, 2018
You gain Atiku.
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by haryorbarmie83(m): 7:29am On Oct 20, 2018
Buhari till 2023 by his grace.

2 Likes 1 Share

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Alphalum: 8:17am On Oct 20, 2018
Bros ur head dey their. Na the same question I dey ask my people. It's better to stay with d small devil( Buhari, cos dat one no go eat our yam much) than the biggest known devil ( atikuloot, a confirmed wire wire robber wey go eat all our yam and throws little little remnants in some people's mouth and put our / unborn children future at stake)

1 Like 1 Share

Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Nobody: 8:28am On Oct 20, 2018
PresidentAtiku:
No one is fighting
What of all the bad blood on social media?
Re: If We No Vote Buhari because Of Atiku, Wetin We Gain? by Nobody: 8:23am On Oct 21, 2018
Alphalum:
Bros ur head dey their. Na the same question I dey ask my people. It's better to stay with d small devil( Buhari, cos dat one no go eat our yam much) than the biggest known devil ( atikuloot, a confirmed wire wire robber wey go eat all our yam and throws little little remnants in some people's mouth and put our / unborn children future at stake)

(1) (Reply)

Only Buhari Can Do This - Pics / Punch Newspaper: Who Won The Vice-presidential Debate? How People Reacted / We Are Part Of The Generation That Destroyed Nigeria.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 50
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.