Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,420 members, 7,815,949 topics. Date: Thursday, 02 May 2024 at 09:53 PM

Question About We Country - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Question About We Country (244 Views)

I Have One Key Question About IPOB And Ohanaeze Ndigbo / Osagie Ehanire Silent On Question About Abba Kyari’s Whereabouts / Buhari Answering A Question About Youths At UN, Nigerians React (Video) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Question About We Country by Holiyo(m): 6:16am On Jan 23, 2019
(permit me to use pigin)

Abeg o... Nigerians, why be say for we country, our government want us to do very long strike, fight, even die sef, for their own responsibility before them go wan listen us. The annoying part be say, that thing wey we dey request nai go make we country better. E com be like say them no want better thing for the citizens of we country. Only wetin them care about na to build road, inaugurate buildings, create useless news, or invest into electricity wey no go fit last for 48 hours without more than 10 times light-out but to build the people inside the country wey for use their knowledge make things better na wahala. In fact, them no wan take ear hear say something go better for the country people or the country people wan grow in knowledge. I even thank God say people eyes don dey open small small because of the small knowledge them don dey get sef. For almost all the government tenures since 1999 this carelessness about we country people well-being thing don dey happen. E come be like say na government language "you see that thing ehn, you must suffer and even die before you get it" hmm. E don dey happen so teh I no come understand again... Abeg na so e suppose be?
Re: Question About We Country by helinues: 6:24am On Jan 23, 2019
Sebi we no wan receive sense Ni abi?

Why con be say out of 200 millions Nigeria, na only Atiku and Buhari fit rule for another 4 years..

Na all of us go suffer am together.. Mtcheew
Re: Question About We Country by Holiyo(m): 6:18pm On Jan 24, 2019
helinues:
Sebi we no wan receive sense Ni abi?

Why con be say out of 200 millions Nigeria, na only Atiku and Buhari fit rule for another 4 years..

Na all of us go suffer am together.. Mtcheew

My brother, I taya o...

(1) (Reply)

We Have No Interest In Who Wins 2019 Polls — EU Observers / APC Planning To Rig Presidential Election, Says Atiku / BREAKING: Sowore To Solve Nigeria's Electricity Problem 'in Less Than A Year'

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.